BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Wetin dey happun to Nigerian football, why Eagles, Falcons, odas dey struggle - NFF set up committee to investigate
Nigeria football fans dey call for di head of di NFF President Ibrahim Gusau afta dia national teams fail to qualify for major tournaments. But wetin be di problem?
US neva comot Nigeria from list of 'country of particular concern' – here na wetin don happun so far
Dis meeting dey come less dan two weeks afta anoda mass killing wey local residents insis say e dey religious motivated, for Kaduna State.
Chad president free opposition leader Masra
Masra bin dey serve 20 years jail term but dem pardon am wit eight oda opposition members wey dem detain during one organising protest.
Why Ghana traders dey question security deal wey Ghana and Burkina Faso newly sign - Wetin dey inside di deal
Chairman of Ghana trader association, Eric Osei Tuffuor tell BBC say most areas wey dem dey buy tomatoes for Burkina Faso na designated hotspots and authorities don advise say make dem no go dia.
Top candidates wey dey hustle for Osun State govnor position
Total of 14 candidates dey drag di Osun State govnorship seat, but political sabi pipo tok say di contest go majorly be betwin three candidates. Who dem be?
Why White House press secretary Karoline Leavitt leave di job
Leavitt go depart from her role to spend time wit her young children and family, di president tok.
'We neva receive any request' - Nigeria react to South Africa request for pay back ova repatriated citizens
Nigeria consul general for South Africa, Ninikanwa Okey-Uche, also tell BBC say she neva receive dat kain request from di South African govment.
Why Ghana court decision to sit during legal vacation dey para some lawyers for high profile criminal cases
Lawyers for ex-govment officials wey dey face criminal charges say dem no go dey available during two-month legal vacation. Dis don raise debate about legal vacation all ova again weda e dey constitutional or not.
Burial mata ova Zambia former president turn election into serious contest
Hakainde Hichilema bin look like pesin wey go easily win second term, but di controversy wey follow Edgar Lungu death don reduce im chances.
Special Tori
Authorities confam release of US missionary pilot from Niger Republic
Kevin Rideout na evangelical Christian wey dey work for one charity organisation wey dem dey call Serving In Mission (SIM). Dem kidnap am outside im house for Niger capital, Niamey, for October 2025.
South Africa scata Nigeria 2027 Fifa Women's World Cup hope, Ghana get chance
Nigeria don fail to qualify for 2027 Women's World Cup for di first time afta dem lose 2-1 to South Africa for di playoffs.
Trump administration establish task force to end birth tourism for US, revoke ova 600 visas
Di US Department of State say dem dey use all available tools defend di integrity of US citizenship, ensure say pipo wey get non-immigrant visas use dem only for dia lawful and intended purposes, and prevent dia exploitation through birth tourism.
Vultures don dey disappear for Nigeria - but di 'Vulture King' dey fight to save dem
Some see dem as evil or hunt dem for ritual use but dis birds dey play a vital role for nature cycle.
Five things to know about Osun State govnorship election
All di govnorship elections wey dem don hold for di state since di return of democracy dey always end for tribunal or legal battle.
Who be Senator Francis Fadahunsi wey pipo dey attack ova im viral 'kill dem' comment
Osun state police command don invite Senator Francis Fadahunsi ova im now viral comment to 'kill members of di Accord party'.
Nigerian singer Davido cry out to Trump, international community ova Osun State govnorship election
E make di call on im official X account on Tuesday, 11 August, wia e also call on di international community.
'She die di day we end our externship' - Wetin we know about death of 23-year-old law school student wey die for Lagos campus
Nigerian Law School don confam di death of one of dia student, Faith Alayande wey die from heavy fall from di hostel rooftop for Lagos Campus.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.

















































