Why some countries drop out of Miss Universe Pageantry

Nepal, Bulgaria and Zimbabwe bin participate for last year Miss Universe wen e hold for Thailand
Wetin we call dis foto, Nepal, Bulgaria and Zimbabwe bin participate for last year Miss Universe wen e hold for Thailand
Published
Read am in 5 mins

Plenti kontris na im don drop out of di Miss Universe competition wey dey hold for Puerto Rico.

Na 119 contestants bin first dey announced say dem dey participate for di 75th edition of di pageant.

Howeva multiple kontris and dia Miss Universe Queens don comot wit statement say dia pesin no dey go di competition.

Most of di reasons wey pipo give na sake of say dem sick howeva, odas na visa issues amongst oda reasons..

Among di kontris wey no dey participate na Republic of di Congo, Nepal, Bulgaria and Austria.

Di Miss Universe pageant dey hold for Puerto Rico dis year and bin start on Wednesday wen di different Queens from different kontris start to dey enta Puerto Rico.

Di event go end on 20 November wit di main competition gan-gan.

As at now, even though di official Miss Universe Pageant don tok say dem don get a list of queens for di venue for Puerto Rico, dem neva chook mouth for contestants wey dey miss out.

As at now, about five kontris don release statements as to wetin make dia participants neva reach Puerto Rico.

Some of di visa restrictions issues dey come from di fact say Puerto Rico na territory wey di United States of America dey claim.

No be only dis beauty pageant dey affected as visa issue also show face during di World Cup wey hold for June sotay some teams wey play for di US bin no dey allowed to camp for dia.

Countries wey go miss Miss Universe 2026

Zimbabwe

On Sunday, Miss Universe Zimbabwe, Roseanna Hall drop statement as to why she neva arrive for di pageantry.

For di statement she blame on American visa challenges.

She tok for video for her social media say, "I don dey South Africa for sometime and today na wen I suppose go Puerto Rico for di 75th Miss Universe Beauty Pagaent but sake of di partial visa ban for America, e don cause wahala. And no be only me get dis wahala, I sabi some of my African sisters wey follow for dis."

She howeva note say Zimbabwe govment dey help to make sure say go fit go.

Republic of Congo

Di Republic of Congo comot dia reigning Miss Universe, Georgina Kambongo from attending di Miss Universe pageant as dem reveal say dem try dia possible best.

Infact wetin dem bin tok be say, "Na wit ogbonge sadness wey we announce say our reigning Miss Universe Republic of Congo, Georgina Kambongo no go go di 75th Miss Universe Competition dis year sake of di June 9, 2025 travel ban."

Dem come explain say di ban stop all new US visas for Congolese passport holders. Even sef dem reveal say "oda African kontris like Angola, Zimbabwe, Zambia bin dey affected by di restrictions".

Infact, dem tok say even di govment of Puerto Rico bin try chook mouth to help but e no work as di mata pass dem.

South Sudan

South Sudan also face visa issues wen dem dey try get dia contestant, Adut Deng go di final.

Adut Deng tok say, "sake of visa restrictions and circumstances wey pass my power, I no fit travel go Puerto Rico and climb di Miss Universe stage dis time. My dream still dey alive say one day I go proudly waka for di Miss Universe stage wit South Sudan wit me."

Nepal

As for Nepal, na dia Miss Universe contestant, Prayashna Gurung na she announce say she dey drop out of di competition due to visa issues wey affect am mentally.

She tok dis one for video statement wey she release on Sunday, wia she tok say, "since I get di opportunity to represent Nepal for Miss Universe 2026, I bin try everytin possible to make sure say e happun. But due to some visa requirement issues wey dem tell us to bring wey we no fit, I no fit go".

She bin tok say dem bin get only one month to plan for dis pageant and na why tins fall apart like e dey so.

Howeva, she reveal say since di Miss Universe crown go dey her head till next year, she go get one full year to plan for dat one.

She say, "dis one one mean goodbye. I dey very honoured to share say I go represent Nepal for di Miss Universe 2027."

Bulgaria

Miss Universe Bulgaria reveal say dia contestant, Ana Maria get crash wey no allow am to dey part of di competition.

Dem tok say, "bicos of one car crash, our ogbonge Miss Universe Bulgaria, Ana-Maria no currently dey di physical condition to participate for di upcoming finals."

Na on Saturday dem drop di informate but no tok to di degree of how di accident affect her but dem ask make ger fans give am privacy, dis na as fans dey call on di organisers to carry di runner up go represent Bulgaria for di competition.

Austria

Austria Miss Universe candidate, Victoria Amerson release statement on Saturday say she dey drop out on Saturday to protect her mental and physical health.

For di statement wey she post for social media, she say, "wen I start dis waka, I bin envision experience of empowerment, mutual respect, personal growth and opportunity to represent my kontri wit pride."

"But wetin I carry my eye see wey include pressure, lack of personal autonomy, control and di frustration wey I still dey face stress me sotay one sickness wey I don take time control well well flare up again".