Ghana govment present $33billion budget and oda highlights for di 2027 'New Economy' plan

the budget has been greeted with negative reactions from the minority in parliament and opposition party
Wetin we call dis foto, Di finance minister say di govment no dey introduce new taxes
Published
Read am in 5 mins

Ghana dey target to spend up to Ghc 389bn ($33bn) for di 2027 fiscal year to deal wit various sectors of di economy.

Finance minister Dr Cassiel Ato Forson bin present di budget wey im highlights oda tins di govment dey project to achieve wit dis new budget.

Di minister announce say dem no dey introduce any fresh taxes, wetin dem go do be to block leakages for di economy and increase revenue from oda sectors.

Inside di two-hour presentation by di sector minister, im announce say di govment dey target 5.2% growth

Inside di ova 300-page budget document wey di minister bin present, di govment announce wetin dem describe as 'New Economy'.

Dis na some of di highlights from di 2027 budget.

Govment go spend $10bn ova four years to create 'modern Ghanaian economy'

Di finance minister tok say for dis 'New Economy' budget, di govment go invest $10bn for four years to create jobs and improve di living standards of pipo.

Dis 'New Economy' programme go run from 2027 to 2030 wey e go focus for eight pillars.

Dis dey include macroeconomic stability and affordable finance; commercial agriculture; energy infrastructure; critical minerals value addition; tourism, culture and creative arts; textiles and garments; pharmaceuticals and manufacturing, including biomanufacturing; and the technology economy.

"Affordable finance gatz reach farmers, manufacturers and exporters. Agriculture gatz supply food and industrial raw materials, wey reliable energy gatz support 24-hour economy," Dr Ato Forson tok.

No new taxes for new budget

Di minister tok say di govment no dey introduce any fresh taxes wey go burden di citizens.

Dis na di second straight year wey di govment no introduce new levies.

Dr Cassiel Ato Forson assure households and businesses say dem go rather focus on "mobilising revenue instead of bringing new taxes."

Im tok say di govment go work to block all di loopholes and leakages so di kontri go collect di revenue e suppose collect.

You go remember say di current govment bin cancel five taxes since dem enta govment for 2025 (di electronic transaction levy, Covid 19 levy, betting tax, emissions levy and VAT on motor vehicle insurance).

Di minister say dis taxes wey dem comot don free space for citizens wey e also increase dia spending power.

Ghana GDP growth and unemployment below percentage

Di minister say di govment dey target real GDP growth of about eight percent wey dem wan also target unemployment rate below eight percent by 2030 under di 'New Economy' programme.

For inflation, di govment bin dey target eight percent for 2027 – maintaining dia commitment to single-digit inflation.

For public debt, di govment say dem dey target reduction to 45 percent of GDP for 2027 from di provisional 47.5 percent wey dem record for October 2026.

questions dey emerge about di promises for di last budget
Wetin we call dis foto, Govment say dem go build 10 new stadiums, complete one national theatre for Kumasi and build thermal plant

Govment say dem go build ogbonge infrastructure projects

Di finance minister say di govment go build 10 regional stadiums across di kontri to bring sporting opportunities to dose places.

Im also announce say di govment go complete new national theatre for Kumasi for di Ashanti region.

"Govment go complete dis theatre wey go serve as center for cultural performance, conferences and oda creative industry work."

Di minister also announce say di govment go build 1,450-megawatt (MW) state-owned thermal power plant and a 600MW solar power facility, as part of measures to strengthen di kontris energy security and support industrial growth

Allocation breakdown to various Ghana ministries

Di finance minister bin announce allocation for di ministries for di 2027 financial year.

  • Agriculture and food security – GHc2.9bn
  • Fisheries and Aquaculture – Ghc 400m
  • Energy and electricity – Ghc 3.1bn
  • Roads and Transport – Ghc 11.3bn
  • Housing, Water and Coastal protection – Ghc2.5bn
  • Education and Learning – Ghc48bn
  • Health and infrastructure – Ghc40.3bn
  • Social protection – Ghc3.4bn
  • Youth and skills development – Ghc 3.5bn
  • Sports and recreation – Ghc782m
  • Local Government – Ghc17.6bn
  • Industry, Science and natural resources – Ghc188m
  • Tourism and digital development – Ghc186m
  • Security, Jobs and Accountability 0 Ghc10.1bn
  • Foreign affairs and diplomacy – Ghc1.9bn
  • Retirement benefits and past obligations – Ghc4.15bn

Reaction to Ghana 2027 budget

Minority leader for Parliament Alexander Afenyo Markin tok say di budget wey di minister bin read na "scam budget" wey di govment dey run wetin im describe as "paper economy wey make Ghanaians dey suffer."

"For dis kontri today, cocaine dey everywia, na dis be di new economy di govment dey run? Women dey suffer across di kontri and di plenty jobs dem promise notin dey show for ground."

Im add say "di finance minister bin lament for di budget, wey di reality no dey reflect for di pocket of di citizens."

Di opposition lawmakers display placards and notices wey describe di kontri and di economy as 'cocaine economy' 'cocaine budget' 'paper economy' and 'scam economy'.

Some oda placards bin dey read 'scam govment' '24-hour cocaine economy' 'frakadam aban' wey mean scam govment.

Afenyo-Markin also add say di govment don dey use slogans to run di economy without creating di jobs dem promise.

"Dis govment na scam, everitin dem promise na scam to lie to di pipo, now di reality dey pursue dem for face," di minority leader tok journalists afta di budget presentation.

Di minority caucus say on top dia social media tok say beyond di figures and fresh announcements, serious questions dey wey di govment suppose answer.

"Wetin be different from dis budget? Wetin happun to di promises dem make for di previous budgets, wia di evidence of implementation dey ad wey tangible improvement dey for di life of ordinary Ghanaians," di minority caucus ask.