Fountain of Life Church reply tori say dem remove Jimmy Odukoya as senior pastor

Man look up
Published
Read am in 4 mins

Di Fountain of Life Church don reject report wey dey fly up and down say di board of trustees don remove Pastor Jimmy Odukoya as di Senior Pastor.

Di Church for statement on dia official Instagram account tok say di tori wey dey make di rounds no be true.

"We categorically reject dis purported decision and wish to clarify say di announcement no represent a constitutionally valid decision of di Board of Trustees of The Incorporated Trustees of The Fountain of Life Church," di statement read.

Dis dey come afta tori begin spread say di church don comot di lead pastor sake of one new video wey show wia im papa name anoda pesin as di successor.

For di official statement, Fountain of Life Church tok say na some individuals wey gada diasef as boards dey act outside di constitution of di church.

'Pastor Jimmy Odukoya remain di duly appointed Senior Pastor'

Fountain of Life Church declare say Pastor Jimmy Odukoya still remain di 'lead pastor'. Dem add say some pipo wey dey call diasef 'Boards' dey do wetin no dey inside di church constitution.

"Rather, e present di position of certain individuals wey don constitute demsefs into one group and describe am as "Concerned Members of the Board" and wey continue to act outside di constitutional framework wey dey govern di Church.

"For di avoidance of doubt, Pastor Jimmy Odukoya remain di duly appointed Senior Pastor and Chairman of di Board of Trustees of The Incorporated Trustees of The Fountain of Life Church," di statement read.

Di church say di appointment of Pastor Jimmy Odukoya dey "unanimously approved by di Board of Trustees for September 2023, and no constitutionally valid decision dey ground to remove am from office."

According to di church, dia constitution na di governing instrument wey dey guide dem.

Dem say "no individual or group of individuals fit substitute dia preferences for di express provisions of dat Constitution."

Fountain of Life Church add say, make members of di church and di general public dey aware of di position of di Church and ignore wetin individuals wey di constitution no recognise dey tok.

Wetin cause di kasala for Fountain of Life?

Fountain of Life Church clear di air say some individuals gada diasef as Trustees.

Dem say di mata begin for March 2026, wen di Church ask some of di individuals to resign from di Board sake of how dem dey go against di Constitution of di Church.

"E dey important to place on record say, as far back as 14 March 2026, dem formally ask these Trustees to resign from di Board on account of dia repeated and flagrant violations of di Church Constitution and di founding principles and objectives."

Dem say dat communication reach all dos wey dey concerned, and one of di 'Trustees' resign from di position sake of di communication.

"Regrettably, rather dan address di constitutional concerns raised, di remaining individuals don continue to dey undertake actions wey go bind di Church without complying wit di governing Constitution," di church statement tok.

Who be Pastor Jimmy Odukoya

Pastor Jimmy Odukoya

Jimmy Odukoya na di first son of di popular late Pastor Taiwo Odukoya of Fountain of Life Church for Lagos State and e succeed im father as lead pastor of di church.

Na 1992 Pastor Taiwo Odukoya bin found Fountain of Life Church wia im serve as di senior pastor until wen dem announce im death for August 2023.

Following di death and burial of Pastor Taiwo Odukoya for September, di Board of Trustees announce Jimmy Odukoya wey be im son as di new lead pastor of di church.

For one exclusive interview wit BBC Pidgin, di new lead pastor bin confam say true true, im don take charge of di church as successor of im father.

Pastor Jimmy Odukoya wey also be Nollywood/Hollywood actor reveal say im no just show ministry as dem don ordain am as pastor since 2009.

"No be today, dey don ordain me as minister since 2009 for dis church, and I become pastor for 2012. I bin lead youth church for many years wey mean say I don dey ministry since."

For 2005, Jimmy mama and popular Pastor Bimbo Odukoya die for di Sosoliso airline plane crash for Rivers state. Di plane bin takeoff from Nigeria capital, Abuja bifor e crash land for Port Harcourt airport wit about 110 pipo.