Wetin dey inside Tinubu five-year defence plan to end insecurity for Nigeria

President Bola Tinubu
Published
Read am in 4 mins

President Bola Tinubu don develop one Five-Year Strategic Defence Operations Plan wey go help strengthen Nigeria security system, make military work beta and improve how dem dey respond to new security threats.

Di All Progressives Congress Presidential Campaign Council wey announce dis informate for statement on Sunday tok say, part of di plan na to recruit 78,000 additional military and police personnel, as part of efforts to tackle insecurity.

Dis announcement dey come as Nigeria still dey battle serious security problems wey don last for about 17 years, starting from di Boko Haram insurgency.

Since dat time, banditry, kidnapping and different kind of violence don spread reach several parts of di kontri.

Wetin be di proposed plan?

According to di statement wey di tok-tok pesin to di council, Dele Alake issue, di proposed Five-Year Strategic Defence Operations Plan go provide framework fwey go align military operations, training, equipment and expenditure wit Nigeria security challenges.

Di council tok say di strategy go adopt one coordinated, intelligence-led and technology-driven approach to tackle terrorism, banditry, kidnapping plus oda forms of criminality.

On how di administration don perform so far in di fight against insecurity for di kontri, Alake tok say under Tinubu administration, ongoing military operations across di kontri don lead to di elimination of more dan 15,000 Boko Haram terrorists and bandits.

"In di last three years, di scale of di administration ongoing military operations across di kontri don lead to di elimination of more dan 15,000 Boko Haram terrorists and bandits, and more dan 130,000 fighters and dependents of Boko Haram don surrender through Operation Safe Corridor, di Federal Government rehabilitation programme for repentant insurgents."

E say di administration don also expand military formations and manpower:

"To strengthen di Nigerian Army operational capacity and improve responses to security threats, President Tinubu bin create four new Army divisions and restructured existing military formations."

E say di aim of di reforms na to expand operational coverage, decentralise military operations, and enable troops to respond quickly to security threats across tdi kontri.

One security expert, Awwal Abdullahi Aliyu bin tell BBC say, "You see, wen dem recruit dis sojas, evri Battalion go get enof personnel. Dis one go expand military operations and ensure say areas wey before no get military presence go now get soldiers."

E add say say, "I believe say dis fit reduce di security wahala by 75 percent."

Di statement also say di president don approve di establishment of two additional Army depots for Osogbo, Osun State, and for Amasiri-Edda, Ebonyi State, to expand military training capacity and accelerate di recruitment and training of new soldiers.

"Each depot fit accommodate 6,000 recruits at a time, wey go bring dia combined training capacity to 12,000 soldiers."

Also for July, di president bin give greenlit to recruit 28,000 extra soldiers and 50,000 police officers to join di security agencies, as part of broader efforts to reinforce internal security, improve policing capacity, and strengthen di kontri response to criminal activities.

Di statement still mention investments wey govment don make for military accommodation and operational infrastructure, including one 700-unit barracks project for Ikere-Ekiti for Ekiti State.

Di council tok say di project dey meant to improve di living and working conditions of military personnel, while also providing di infrastructure wey dem need to carry out dia operations well.

However, Under dis Five-Year Strategic Defence Operations Plan, di council say di govment dey adopt "a more strategic approach to national defence as dem wan ensure say di investments dem don put for di security sector dey guided by clearly identified threats, operational requirements and national priorities."

Dis one mean say, di proposed defence plan go help govment direct spending based on identified security threats and operational needs, improve combat readiness, and close di gaps wey dey for how security agencies dey work.

But, di statement no give any specific timeline for wen dem go begin or fully implement di five-year plan.