Jordan Ayew penalty give Ghana narrow win against Somalia for 2027 Afcon qualifiers game

Somalia no get any shot on target for di first half
Wetin we call dis foto, Jordan Ayew penalty give Black Stars first half lead
Published
Read am in 9 mins

Jordan Ayew penalty secure all three points for Ghana for di second leg of dia Group C qualifier wit Somalia.

Di Black Stars create chances but dem no fit take dem.

Ghana now win back-to-back games against Somalia wey defend wit dia lives for di game.

Wit dis result, Somalia don fail to qualify for di Afcon wit zero points from four qualifying games.

Ghana for di oda hand dey third wit six points, wey dem keep back-to-back clean sheets for di first time in plenty games.

Interim coach Kim Lars Björkegren go dey happy say im secure di six points for di time im be caretaker coach for di Black Stars.

But di journey no end, Ghana gatz hope results for oda groups and games go favour dem.

Cote D'ivoire bin dey lead di table wit nine points, Gambia dey second wit six points.

For dis game Somalia no get even one shot on target wey dem get 33% possession for di whole 90 minutes.

Ghana for di oda hand, bin get four shots on target, 67% possession wia di Somali keeper bin make two saves.

Di Black Stars go later jam wit Gambia away from home and later Cote D'ivoire for Accra.

E no dey clear whether Ghana go fit qualify but dem gatz win dia remaining games to stand beta chance.

Sabi pipo say Ghana gatz improve if dem want stand chance for dis qualifiers.

Dis back-to-back wins against 53rd ranked Somalia for Africa and 200th ranked for di world, no be proper test.

Dem gatz improve if dem want qualify.

Highlights of di game

what must change for ghana to stand a chance?
Wetin we call dis foto, Ghana beat Somalia for back-to-back games for 2027 Afcon qualifiers

Second Half

FULLTIME!

Ghana dey try to create sometin and get di second goal but dem no dey find chance.

Chaaance! Di Somalian keeper don save Kudus im short. Corner to Ghana.

+4 mins

90" Alidu Seidu don sit for floor for di game.

89" Somalia dey try to launch one more attack.

87" OFFSIDE! Afena Gyan dey offside.

Di Black Stars dey try to manage di game - DI Somali players vex

83" Abdisamad Abdullah bin dey get treatment afta some foul wit im marker.

82" Yellow card for Ati-ZIGI

Zakaria Hassan and im teammates dey try to create sometin.

81" Chance! Afena -Gyan and Sulemana strike di ball, Ghana don win corner.

Daniel Kofi Kyere don enta di park

80" 10 minutes more to sabi who dey go house and who still get chance.

78" Di game don scatter now. Every body wan get dia share.

75" Chaaaance! Jordan Ayew blast one shot ova di bar; as Ghana dey prepare for substitution.

73" Bilal Njie no happy about freekick dem award Ghana. Di Black Stars get chance but Afena Gyan no fit to connect.

Hydration break!

72" OFFSIDE against Abdi Nour, Somalia dey try to increase dia pressure but so far nothing doing

Freekick against Alidu Seidu!

70" Afena-Gyan try to pressure di Somalia keeper, di Somali make steady for dia.

68" Somalia bin get counter attack, dem drive for di Ghana area bifor Oppong Peprah track back to block di ball.

Jordan and Gigle Mohammed dey tango bifor Ghana attack, di Black Stars miss ogbonge chance.

66" Kudus don take di corner, di Spurs player dey try to score olympico but im no fit get di execution well.

Alidu Seidu enta di box, im try to cross wey dem foul am, im dey want penalty but referee say corner kick.

64" Somalia bin dey tink say dem fit get sometin for dis game. Dem dey pepper di Ghana players.

61" Afena-Gyan don foul im marker Ali Omar. Freekick to di Somali team.

Di game don turn somehow; di passing from both teams no dey go thru, Ghana no fit hold on to possession.

60" Freekick to Somalia; poor defending from Salisu, now Somalia get chance to threaten di Ghana goal.

Somalia dey try to create sometin, afta Jordan bin dash di ball

58" Freekick to Somalia, captain Musee hit di ball straight at Jordan.

56" Fatawu Issahaku create some chance for imserf but im shot go wide. Felix Afena-Gyan don enta di game now to replace Thomas Asante.

55" Ghana players don dey frustrate sake of di Ocean Stars don dey play lowblock.

Felix Afena-Gyan don dey prepare to enta dis game; di striker don score di second goal for di first leg last week.

54" Foul against Faisel ABubakar. Di ball don enta di Ghana area again, dem now dey start dia pass pass game again.

Black Stars of Ghana don dey try dia best to break di low block but so far dem no dey successful.

52" Somalia don sit for back dey park di bus for dis second half, dem no dey give Ghana any space at all.

Njie and Gigle Mohammed dey pass di ball among diaserf to prepare to launch dia own attack - di ball don spoil, Ghana take control again.

Yellow card! Thomas Asante don get yellow card afta im pull di Somalia player down.

48" Jordan and Kudus no dey communicate wit each oda.

Hassan and Gigle don dey close down any Black Stars attack so far for dis second half.

47" Kudus and Fatawu dey try to create sometin. Kudus try to shoot, but Somalia block am.

46" Anoda chance for Ghana, Fatawu Issahaku drive for di box wey im cross di ball into di area, di ball beat everybody.

45" Chance! Ghana nearly score for di early seconds. Ibrahim Sulemana shoot di ball from distance wey nearly beat di keeper Hussein.

Di second game don start.

the performance was not inspiring
Wetin we call dis foto, Ghana go hope oda results go work in dia favour as dem try to qualify for di Afcon dem fail to qualify for last year.

HALFTIME!

45+2" Captain Jordan Ayew don win di ball, im dey drive into di Somalia area, instead say im go pass or cross di ball, im still keep di ball until di ball roll out for goalkick.

Ghana dey pass di balls - Rahim to Thomas Asante, di striker don battle wit Gigle Mohammed; di Somalia player don win di battle.

Dem don add 2 minutes for dis game bifor halftime.

+2 mins

43" Freekick against Ghana. Somalia take am quick thru Abel Gigle, im pass to Omar, to Abubakar, but dem lose di ball, Ghana win throw-in.

Ghana dey try to create sometin to extend dia lead but di Ocean Stars no dey gree. Musse Jailani and im boys dey try had to get equaliser before halftime.

42" Somalia dey put togeda some fine passes - Jarma Mohamed dey lead di attack to create some chance. Di final ball no dey trouble Ghana keeper At-Zigi at all.

Kudus collect di ball for attack, he shoot but again di ball dey blocked. Gideon Mensah don foul im marker.

40" Abdisamad Abdullah take di corner but Ibrahim Sulemana don clear di ball

39" Corner to Somalia. Dem dey try to find response afta dat goal.

38" Ghana dey try to put more pressure to find anoda goal, but Abdullai, Ali Omar and Mohammed Hassan don dey block all di channels.

Di game don restart, Somalia dey shocked; dem defend well so far until dat penalty.

36" GOOOOAL! Jordan Ayew send di keeper Hussein di wrong way. Ghana lead 1-0

Jordan Ayew bin miss penalty for di first leg - Im get anoda chance from di spot. He go fit score am?

PENALTY TO GHANA. Abel Gigle don foul Brandon Thomas-Asante!

Somalia players dey give some trouble to Alidu Seidu for di Ghana defence.

30" Issahaku don win freekick. Im dey try to do sometin for Ghana today, im dey take on players wey im dey put crosses for di box.

Dat na di first shot on target by Ghana for dis 30mins

Chaaance! Brandon-Thomas Asante don shoot from wide, goalkeeper Hussein don catch di ball.

From di corner Mubashir Nour blast di chance ova di bar afta Ati-Zigi spill di ball.

27" Alidu Seidu don concede corner afta some poor defending.

26" Chaaance! Ibrahim Hussein don clear dia lines ; Ghana get ogbonge chance to score, Kudus, Jordan, Asante and Fatawu don dey confused for di box, di ball finally spoil as di Ghana players no tok to each oda.

Abel Gigle, Faisal Abubakar, Ali Omar and Mohamed Hassan don dey put dia body on di line so far for Somalia. Sake of dat Ghana no get any clear cut chance so far.

25" Hydration break!

23" Chance! Alidu Seidu blast one ball ova di bar afta di corner bin fall for im side.

Ghana bin dey ask for penalty. Di fans dey shout for di stadium but referee say no penalty. Corner kick to Ghana.

Di Somalia players so far don dey defend well. Dem no dey allow di Black Stars to create clear chances.

21" Asante still no fit connect wit yet anoda cross. All di crosses no dey find di Coventry striker.

Ibrahim Sulemana get yellow card afta Jordan bin lose di ball. Black Stars players bin dey track back, Sulemana no suppose commit dat foul.

20" Kudus win freekick, Ghana dey pass di ball among diaserf bifor Jordan dash di ball.

Bilal Njie don try to meet one long pass as Somalia dey try to buildup dia own attack, Njie fall short of meeting di ball.

18" Freekick to Somalia, Ibrahim don foul im marker.

From di corner, Somalia clear dia lines, bifor di ball don return to di Ghana keeper Ati-Zigi.

17" Chaance! Kudus don make anoda wrong decision, instead say im go pass to Jordan im decide to go by imserf to shoot. Abel Gigle don block di shot for corner.

16" Asante, Jordan, Kudus dey pass di ball among diaserf, waiting for di chance to open for dem.

Issahaku drive di ball, im carry enta di Somalia area but im make wrong pass to Jordan, di Ghana captain don vex.

15" Thomas-Asante so far no dey attack di box quick, im don miss one cross into di box.

14" Di game don settle but Ghana dey struggle to break down di Somalia defence.

Alidu Seidu enta di box, try to find im teammate but dem block all di channels im don carry di ball comot to give back pass.

12" Jordan, Issahaku, Kudus dey try to create chance but Somalia win di ball, Omar, Sharif try to begin dia own counter attack.

11" Brandon-Asante enta di box to meet one pass - but di chance don vanish.

10" Ibrahim Rash and Sulemana don dey pass di ball between diaserf to try and set up di attack, but Somalia block di lines.

Kudus try to overdo as Ghana dey attack, wey di chance don spoil. Goalkikc to Somalia.

9" Alidu Seidu don fall for ground, referee award freekick to Ghana. Kojo Oppong Peprah bin take di freekick quick.

Ghana dey pepper di Somalia area - di Black Stars get more of di possession so far.

8" CHAAANCE! Fatawu Issahaku put one sweet cross into di box, but Kudus and di oda players for di Somalia box don miss di ball. Di chance miss.

7" Mubashir Nour don force Ghana for di ball to comot for throw-in

5" Ghana bin dey dominate di game so far but dem dey struggle to test di Ocean Stars.

4" Freekick to Ghana; Jordan kick di ball but Somalia block di ball.

2" Ghana try to create chance wit Salisu Mohammed, di defender pass di ball to Kudus but im no read di pass well, di ball don spoil.

1" Game don start, both teams no settle yet but Ghana bin dey try to create early chance

Match officials don lead players for di two teams wey dem waka enta di pitch.

Welcome to di Essipong Stadium for di Western Region of Ghana wia dis ogbonge game between Ghana and Somaila dey happun.

First Half