Nigeria and Tanzania battle out 0-0 draw for 2027 Afcon qualifiers

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria play a dramatic 0-0 draw wit Tanzania for di 2027 African Cup of Nations qualifiers match.
Di group L second leg game wey happun for Amaan Stadium for Tanzania see as di Taifa Stars dey try score goal but di Super Eagles no gree.
Plenti missed chances from di Super Eagles of Nigeria give Tanzania some pressure but e no break dem.
Tolu Arokodare miss plenti chances and same as di Tanzania side wey dey home.
For di first leg, Nigeria forward Tolu Arokodare become di man of di moment as e score two goals to keep di 2027 Africa Cup of Nations hope for Nigeria alive.
Di player wey enta di match for second half score im first goal for 52 minutes. E score im second goal for 60 minutes.
Di most important for di first leg tin be say Nigeria collect all di three points and di match end 3-1.
But for dis second leg, both teams share di points afta di game end for draw.
Nigeria still dey second for di table wit seven points afta four matches while Tanzania dey third position of di group wit two points.
Guinea-Bissau still dey top Group L wit seven points, but if dem win dia next game, dem go lead di group wit three points.
Tanzania vs Nigeria match highlights
Tanzania 0 - 0 Nigeria
FULL-TIME
REFEREE BLOW WHISTLE
90+4mins- Tanzania wit di ball, counter attack oooo, Jersey number 2 carry di ball move, close to Iwobi, e give di ball to anoda player, oh no, Ola Aina block di ball
90+ 1 - Alhassan try one shot from di angle of di box 18 but e no enta di net, e go ova di bar. Alhassan look disappointed as dat chance fit don enta for Nigeria.
FIVE MINUTES ADDED TIME
89mins- Tanzania midfielder Miroshi drive through Nigerian players, move close to Nigeria central half, hoping to shoot, but Nigeria collect di ball
84mins- Good chance for Arokodare as e dey in search of goal to give Nigeria a good lead, but im shot pass near di goalpost
80mins- WHAT A CHANCE' Akor Adams wit a good attempt into Tanzania goalpost, di ball just go across di goalpost. Tolu Arokodare try use leg touch di ball, but e no touch am. Dat for be Nigeria perfect chance.
70mins- Moses Simon ateempt a long range pass but Tanzania midfielder block am
64mins- Onyemaechi wit di ball, e move close to Tanzania net, e pass di ball give Bassey, oh no, Tanzania playe kick am comot
62mins- Calvin Bassey don collide wit Nwabali oooooo. But dem don stand up back and di game continue
Tanzania 0 - 0 Nigeria
GOOD CHANCE for Nigeria, Akor Adams wit di ball, but e play am wide into di air
60mins- SUBSTITUTION' Taiwo Awoniyi out, Alex Iwobi don enta.
58mins- Kibu Denis try right-footed shot from di right side of di penalty area, but di ball go wide to di right of di goal. Tanzania trying to score goal by all means
55mins- CORNER, Nigeri play dia corner kick but di Tanzania player nod am comot.
More pressure ontop Nigeria as Tanzania dey press more, anoda save by Nwabali
53mins- WHAT A CHANCE! Tanzania fire correct shot into di Nigeria goalpost, but Nwabali catch am
51mins- Onyemaechi is down! E receive one hard tackle make am fall, now di medical pipo dey attend to am. SOme players dey warm up for di side of di net
46mins- Di second half don resume wit Nigeria in major possession
SECOND HALF
Tanzania 0 - 0 Nigeria
Half-Time - Referee blow whistle
45mins +2 - Tanzania player try dey break into Nigeria defense, but Nigerian defenders no gree
2 Minutes Added Time
45mins- Nigeria dey try hold dia defense well well and Calvin Bassey dey handle di side well.
44mins- Di home team kontinue to look for opportunity
42mins- Tolu Arokodare try right-footed shot from di right side of di penalty area, but e go wide
Tanzania 0 - 0 Nigeria
40mins- Di Tanzania gatz substitution becos one of dia players dey injured; Abdul Sopu come in to replace Nathaniel Chilambo
38mins- CORNER, Calvin Bassey almost put di ball behind di net, e tap di ball inside di net but Tanzania goalkeeper block di ball
35mins- Usor try clear di ball, but im leg touch one Tanzania player leg
SUBSTITUTION' Msuva enta for Tanzania
32mins- Hydration break
30mins - Tanzania player carry di ball move near Nigeria midfield but Moses Simon stop am
26mins- Tanzania player dey try break into di Nigeria defense but dem no fit enta. Tanzania player don go down for a foul, as medical personnel enta di field to take care of di player.
Tanzania 0 - 0 Nigeria
22mins- Nigeria kontinue to dey press forward, but Fisayo Dele-Bashiru try one right-footed shot from outside di box, but e go wide again.
19mins- Dele-Bashiru wit di ball, e move forward and shoot di ball,, but di ball go wide.
16mins - Ndidi shoot wide into Tanzania box 18 but e dey deflected to corner.
10mins - Moses Usor take left-footed shot from di right side of di penalty area, but e dey blocked
8mins- Both teams start off very strong, as dem dey try hard
6mins- OFFSIDE' Early for dis match, di Tanzanian team dey look for opportunity right from di start; Aishi Manula attempt a long through ball, but Cyprian Kachwele dey offside
4mins - Both teams dey look for di win and wan score goals, and dem go give am dia all to achieve dat and gain di upper hand for dis early minutes
2 mins' - Di ball roll on di field, and di home team kick off to gain possession for di opening moments of di match and hold onto am for a bit.
0mins' - Di match don start as di two games start wit high hopes
Tanzania 0 - 0 Nigeria
First Half
Nigeria dey face Tanzania for di second time for dia Africa Cup of Nations qualifying campaign on Tuesday.
Di match go hold away from home for di Amaan Stadium.
Nigeria currently sit second for Group L, afta dem gain six points from three matches. Dem dey one point behind Guinea-Bissau, wey dey lead di group.
Di Super Eagles start dia qualifying journey wit a 2-1 victory over Madagascar for home, but then suffer one heavy 3-0 loss away to Guinea-Bissau.
For di first leg, Nigeria beat Tanzania wit korrect goals.
Wetin happun for first leg
Nigeria forward Tolu Arokodare na di man of di moment as e score two goals to keep di 2027 Africa Cup of Nations hope for Nigeria alive.
Di player wey enta di match for second half score im first goal for 52 minutes. E score im second goal for 60 minutes.
Arokodare miss plenti chances wey for make am score hat trick but Alhassan Yusuf early goal give Nigeria enuf ginger for di first half.
Alhassan score for di second minute bifor Tanzania score dia only goal for di 32nd minute.
Di most important tin be say Nigeria collect all di three points and di match end 3-1.
for di first half and parts of di second half, di Taifa Stars bin also get dia m oments wey dem fail to convert.
Nigeria still dey second for di table wit six points afta three matches while Tanzania dey bottom of di group.
Guinea-Bissau still dey top Group L wit seven points.
Tanzania vs Nigeria Line-ups
Nigeria: Nwabali (GK), Fredricks, Bassey, Aina; Ndidi, Bwene, Iwobi, Alhassan; Lookman; Adams, Nnadi
Tanzania: Manula (GK); Chilambo, Mwamnyeto, Mlingo; Mao, Miroshi, Msanga, Kachwele, Denis, Hamad, Mnoga.


















