Tiyani Makamu emerge winner of Miss South Africa 2026 - organiser react to controversy around her crown

Wia dis foto come from, Ilaria Finizio / AFP via Getty Images
Tiyani Makamu don emerge as winner of dis year Miss South Africa.
Di 27-year-old beauty queen na from Bronkhorstspruit, Gauteng province.
Di grand finale take place on Saturday, November 14, 2026, for di Sandton Convention Centre in Johannesburg, South Africa.
Qhawekazi Mazaleni crown her successor for di finale, afta she already complete one full year of her reign on October 25, 2026.
Rememba for 2024 wen Miss South Africa get more ground afat controversy hit Chidimma Adetshina.
Di eligibility of Chidimma Adetshina wey be from Pimville, Soweto, and questions about her nationality begin trend for social media since she enter di stage of last 16.
Some social media users dey ask make dem comot am for di contest sake of say dem feel say she no be South African.
Organisers say all di documents wey Chidimma provide dey screened and vetted.
Later on, Chidimma comot for di contest wia she later come Nigeria to contest and also represent di kontri for Miss Universe 2024 and come second.
"Tonight, a new chapter begin. She step into dis role not simply to wear di crown, but to use her voice, influence and platform to champion opportunity, empower young pipo and create meaningful change.
"She carry strength of dose wey come bifor her and di promise of wetin still dey to come," Miss SA organiser tok as dem announce her.
'We stand by our newly crowned Miss South Africa' - organisers react to controversies
Meanwhile, several controversies don hit di new Miss South Africa, afta some fans begin hala say her eventual win dey shocking.
Some also drag di organiser of Miss SA say di kain crown wey dem give di winner for stage no be am at all. Dem kwesion wia di original crown dey.
But di organiser don react to why dem bring dat kain crown for di winner.
"Regarding di crown presented during di finale, we wish to clarify say na temporary ceremonial crown, while preparations for di official Miss South Africa crown dey on di way to finalise."
"Our intention na to give South Africans opportunity to participate in di journey towards unveiling di official crown, "organiser say.
Dem say dem go try get public participation wey go help create a sense of connection between di Miss South Africa and di kontri pipo.
Miss SA organiser also react to tok on how dem take judge di whole process.
"On di judging process, we recognise say South Africans hold different views about di qualities wey define Miss South Africa."
"Beauty, elegance, confidence and presence remain fundamental to di competition. However, we dey equally resolute in our belief say di title must reflect di evolving aspirations and realities of South African society."
Di organiser say anyone wey win Miss South Africa gatz carry both beauty and substance wey go beyond physical presence. Dem say di pesin gatz 'demonstrate intelligence, leadership, authenticity, compassion, strong communication skills and a genuine commitment to making a meaningful difference.'
Dem say even though South Africans get dia own favourite fans, di judges of di contest take dia decision.
"We stand firmly behind our newly crowned Miss South Africa, Tiyani, and di qualities wey earn her dis honour."
"She deserve di opportunity to begin her reign wit dignity, encouragement and di support befitting her new role as a national ambassador."
Tiyani Makamu - Miss SA winner 2026
Di 27-year-old Tiyani Makamu na from Bronkhorstspruit, Gauteng. She is a communications professional, entrepreneur and youth advocate.
She is a graduate of Pearson Institute of Higher Education. Tiyani currently serves as a Group Digital Lead and Client Success Executive.
She is also the founder of Hubsela, a platform dedicated to supporting entrepreneurs and helping small businesses grow sustainably.
She enta top 10, bifor she come move to top 5 and den eventually crown her as di reigning queen.
Oda Miss SA finalists
Katlego Malebye
Katlego Malebye na 31-year-old native of Pretoria. She beCandidate Architect. Katlego get three degrees: Bachelor of Science in Architecture, a Bachelor of Architecture (Honours) and a Master of Architecture qualification.
She dey currently complete her practical training towards professional registration wit di South African Council for di Architectural Profession (SACAP).
Bonolo Marang Motau
25-year-old Bonolo Marang na native of Johannesburg, Gauteng.
She be strategic brand and marketing professional, academic and youth empowerment advocate.
Bonolo na also three-time graduate of di University of Witwatersrand. She get Bachelor of Commerce, Bachelor of Commerce Honours and Master of Commerce degree. She dey currently pursue Doctorate in Business Administration.
Simoné Nonhlanhla Tshituka
Simoné Tshituka na 26-year-old lady from Johannesburg, Gauteng. She be Senior Actuarial Associate. She study actuarial science at di University of di Witwatersrand.
She complete BSc Honours in Actuarial Science. Simoné dey currently pursue professional qualification through di Actuarial Society of South Africa.
Zoalize Jansen Van Rensburg
20 years old Zoalize Jansen Van Rensburg na entrepreneur, author and youth advocate. She dey currently pursue Bachelor of Laws degree through di Open University of London.
She be also di co-founder of Emberman Official; one fashion company wey focus on creating garments, publish children book author and founder of Never Too Young To Advocate.
Cwenga Koyana Kotu-Rammopo
Dis 27-year-old lady na social entrepreneur, digital storyteller and Co-Founder and Managing Director of Talitha Together. She come from Gauteng. She get degree in Theatre and Performing Arts, Film and Television, and a Master degree in Digital Curation from di University of Cape Town.
Amogelang Bunu
Dis 27-year-old Amogelang come from Mabopane for Gauteng. She be speech therapist, audiologist, entrepreneur and part-time clinical educator for di University of Witwatersrand.
She get Bachelor for Speech Language Pathology and Audiology and Master for Audiology from Sefako Makgatho Health Sciences University.
Lesego Khumo Nyathela
30-year-old Lesego Nyathela come from Springs, Gauteng province. She be model, entrepreneur and healthcare advocate wit passion to improve healthcare awareness among young pipo.
She beCum Laude graduate for Business Management from Boston City Campus.





















