Profile of pipo on Ghana new currency notes

Following di announcement by di Bank of Ghana say dem go launch new currency notes for di market on 1 December, plenty reactions don dey on di pipo and symbols wey dey on top di Cedi notes.
Di Central Bank for 12 November bin unveil eight separate bank notes wit new features to "celebrate di kontri heritage and iconic citizens."
One tin wey miss for di new currency na di image of di 'Big Six' wey dey on top all di existing currency notes.
Di 'Big Six' na di image of six key politicians wey bin fight for Ghana independence.
Dem be pipo wey form political movements and parties to campaign for independence wey Dr Kwame Nkrumah lead.
Di names for dis 'Big Six' na
- Dr Kwame Nkrumah (Ghana first president)
- Emmanuel Obetsebi Lamptey
- Ebenezer Ako-Adjei
- Edward Akufo-Addo (Former Ghana president Nana Akufo-Addo father)
- Joseph Boakye Danquah
- William Ofori Atta.
For many years, these six pipo occupy di kontri currency notes plus oda places for di history of Ghana.
But for di new Heritage Series bank notes wey di Bank of Ghana don launch, dem use oda pipo, national and cultural symbols on top di currency.
Meet di eight Ghanaians plus oda national symbols on Ghana new Cedi notes

Wia dis foto come from, Komla Adom/BBC
- GHc1 – Agnes Oforiwa Tagoe-Quarcoopome (1913-1997)
Dis na di lowest denomination for di currency. E get di image of Agnes Oforiwa Tagoe-Quarcoopome (1913-1997), wey represent di kontris market women and dia hardwork for di market.
Agnes na textile merchant for Accra and market queen for di 1940s and she be di first market woman to open bank account at dat time for di standard Bank of West Africa.
She gada di market women for Makola make dem raise money to support Dr Kwame Nkrumah and di struggle for independence.
Sake of her hard work and business, many market women for Accra at dat time learn formal banking.
For di back of di Ghc1 note na foto of di Makola market and cola nut wey dey represent wealth and unity
- GHc2 – Cardinal Peter Dery (1918-2008)
Dis note dey represent religious freedom and diversity of di kontri. E get di photo of Cardinal Peter Dery wey be trailblazer Catholic priest.
E be di first Bishop of Wa and di first Archbishop of Tamale for di Northern Region of di kontri.
Throughout im ministry, e focus on spreading di Catholic faith and promote education.
Di back of dis note get di Larabanga Mosque for di Savannah Region of Ghana; di oldest mosque for Ghana and one of di oldest for West Africa.
Di note also get 'Nyame Dua' cultural symbol wey dey represent spiritual significance for Traditional African religion.
Di blend of Christian, Muslim and traditional elements dey represent religious diversity for di kontri.
- Ghc5 – James Kwegyir Aggrey (1875 – 1927)
Dis note dey represent educational history of Ghana. E get di image of ogbonge missionary and educationist James Kwegyir Aggrey, wey dey popular as di 'papa of education'.
E also be Pan-Africanist wey transform education system across Africa, e also help to establish Achimota College.
James Kwegyir Aggrey get one popular quote "If you educate man, you educate one pesin, but if you educate woman, you educate a whole nation."
For di back of di Ghc 5 note, na image of di Achimota School wey be one of di kontri elite institutions.
Achimota School don educate at least four former presidents of Ghana – Dr Kwame Nkrumah, Edward Akufo Addo, Flt. Lt. Jerry Rawlings and Professor John Evans Atta – Mills.
Oda Heads of State from Africa like (Robert Mugabe of Zimbabwe and Sir Dawda Jawara of Gambia) also attend di school.
- Ghc10 – Annie Ruth Jiagge (1918-1996)
Dis note dey represent justice and equality. E celebrate Ghana first female judge and ogbonge women's advocate.
She also be di first female president of di Ghana Court of Appeal; she be member of di constituent assembly wey write di kontri third republican constitution for 1979.
Annie Jiagge dey recognised around di world for her work wey lead to di Declaration on di elimination of discrimination against women.
She represent Ghana for di UN commission on di status of women from 1962-1972 wey she be di president of di World Council of Churches from 1975-1983.
Di back of di note get di image of di kontris Supreme Court building and oda cultural symbol.
- Ghc 20 – Ephraim Amu (1899-1995)
Dis note dey celebrate di kontri Arts and Entertainment industry.
E get di image of Ephraim Amu wey dey popular as di papa of Ghana art music.
E compose many patriotic songs for di kontri wey im also teach music and culture for many years.
Ephraim Amu dey recognised as pesin wey introduce traditional drums, flute and oda African rhythms to compose songs for local language wey students bin dey sing for schools.
E also wear African cloth to work to celebrate di kontri cultural heritage.
Amu feature for di old Ghana currency wey dem issue for 2002 bifor dem change di currency for 2007.
Now im image don return to di Ghc 20 note togeda wit di kontri iconic National Theatre building and traditional Ghanaian symbol for one type of drum (talking drum).
- Ghc 50 – Theodosia Okoh (1922 – 2015)
Dis note dey represent Nationalism and independence.
E get di photo of ogbonge artist and poet Theodosia Okoh. She dey celebrated for designing di kontri national flag wit di red, gold, green and black colours.
She bin promote hockey for many years – Ghana later name di hockey stadium afta her.
She bin work as president of di Ghana Hockey Association and di Ghana Hockey Federation for more dan 20 years.
Theodosia help to develop di sport wey she push for di national teams to reach di Olympics.
Di back of di Ghc 50 note get di image of di seat of govment wey represent nationhood.
Di note also get traditional adinkra symbol wey represent independence.

- Ghc 100 – Kofi Annan (1938 – 2018)
Dis currency note bin dey celebrate di peace for di kontri. E get di image of Kofi Annan wey be di seventh Secretary-General of di United Nations.
For 2001, dem award am di Nobel Peace Prize wey dem celebrate am say im bring new life to di UN.
Kofi Annan be chancellor for di University of Ghana wey I. get positions for oda universities around di world.
Di bicom global citizen but Kofi Annan neva forget im roots.
Di back of di Ghc100 note get di photo of di Kofi Annan International Peacekeeping Training Center – place wia dey provide training and research for peacekeeping and oda peace operations.
- Ghc 200 – Dr Kwame Nkrumah (1909 – 1972)
Dis na di highest of di kontris cedi notes. Dis note dey celebrate di kontris sovereignty.
E get di image of di first president of Ghana – Dr Kwame Nkrumah wey win independence for di kontri.
Beyond Ghana, Kwame Nkrumah dey popular as Pan-Africanist wey inspire oda African kontris to fight for dia own independence.
Im dey responsible for di construction of di kontris only Hydropower dam (Akosombo Dam), di Tema Motorway wey dey connect di capital city to di industrial port of Tema among odas.
Im play ogbonge role for di establishment of di African Union (formerly OAU).
Di kontri don name di Kwame Nkrumah University of Science and Technology (KNUST) afta am.
Di back of dis Ghc200 note get di Kwame Nkrumah Mausoleum wey be tourist and historical place wia dem bury di former president.

Wia dis foto come from, BANK OF GHANA
'Controversy' about di foto of Theodosia Okoh

One professor wey im name be Eddie Obeng be nephew of Theodosia Okoh.
Oga Obeng na Ghanaian-British scholar and author wey dey popular for championing di 'New World Management'.
E use im LinkedIn account to complain about di photo di Bank of Ghana bin use to represent im auntie Theodosia Okoh on top di currency note.
"I get smile for face, I hear say Ghana bin dey honor my auntie for dia currency notes – she be famous for di Montri sake of she design di kontris flag afta independence from Britain."
Professor Obeng add say "I be very proud when dem celebrate her like dat wey I begin to write message wey I go post."
"Imagine di way I bin dey surprised when I see di notes wey I realise say dem bin use picture of my mama instead of my auntie on top di notes? My mama also dey famous as she be di kontris first woman wey get PhD."
So, Theodosia Okoh (wey design di Ghana flag) and Leticia Obeng (wey be Ghana's first woman wey get PhD) be sisters.
But wetin professor Obeng dey tok be say, di picture wey di Central Bank use for di currency note, na di picture of Leticia instead of Theodosia.
Many pipo including di opposition NPP don sama di Bank of Ghana say dem no do due diligence.
On top social media, pipo dey tok about di mata.
Di Bank of Ghana no yet respond to dis alleged 'mix-up' and 'mistaken identity' for di Theodosia Okoh image on top di currency note.
But one board member for di Central Bank bin write on top her social media page some explanation of wetin happun.
According to Beatric Annan wey also be presidential staffer, di Bank of Ghana don note di discussion about di portrait of Theodosia Okoh on top di Ghc 50 note.
"Di Bank of Ghana work from three authentic photos of Madam Okoh, two of dem when she dey young and one from when she grow."
Di Central Bank board member explain say "dem use dis three pictures to create one portrait wey dey present di legend as mature woman wia dem retain di family resemblance."
"Dem adjust her hairstyle to align wit di family style wey provide clean outline for di engraving process, di aim na to produce bold, clear and dignified image wey dey fit her place for history."
Beatrice Annan add say "di Bank dey engage her family to explain di careful work dem do to create di portrait and resolve di issue."
Despite dis explanation and odas by some govment appointees, citizens bin dey demand accountability on di part of di Central Bank.


















