Iran target US military base for Bahrain wit drone attack

One aeriel weapon on display
    • Author, Ella Kipling
  • Published
  • Read am in 4 mins

Iran don launch drone attack against US military base for Bahrain on Sunday, na di second attempt to target di country in three days.

Di country Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) say e targeted di US air defence radar facility at al-Riffa air base for Bahrain using six drones.

Bahrain military say dia air defence systems stop and destroy di Iranian air attacks "bifor dem fit achieve dia objectives".

E come afta Iran fire drones at Bahrain on Friday, dia first attack against Gulf countries since September.

Di US and Iran dey locked in a stand-off ova di Strait of Hormuz. About a fifth of di world gas and oil supply usually flows through am but shipping don dey restricted since di outbreak of war in February.

Iran insist say e suppose control di strait and dey attack wetin e call "unauthorised" traffic, while di US military dey provide protection for tankers shuttling oil through di strait to keep exports flowing from Gulf Arab states.

As sirens sounded across Bahrain on Sunday di interior ministry call on citizens to head to dia nearest safe location.

Bahrain foreign ministry sa: "Di Kingdom of Bahrain condemn in di strongest terms di continued brutal Iranian attacks on dia territory and hold Iran fully responsible for di consequences."

For statement on di strikes shared by Iran state broadcaster on Telegram, di IRGC say: "Di Strait of Hormuz dey closed, and any aggression by di American enemy go meet wit an even harsher and more forceful response."

Earlier dis week, di IRGC claim say e strike US early warning radar system for Bahrain on Friday.

Di US military deny claim, stating dat di IRGC launch two one-way attack drones towards Bahrain and both dey shot down by US forces. E add say no injuries or damage dey.

Four large vessels on di water in di Strait of Hormuz.
Wetin we call dis foto, Iran and di US are vying for control of the Strait of Hormuz

Earlier in di week, di US carry out strikes on Iran Qeshm Island in di Strait of Hormuz, US officials tell CBS, di BBC US partner.

Di officials describe di strikes as limited and defensive, and say dem dey in response to di IRGC firing on a US aircraft.

Iranian state news agency Irna report explosions on Qeshm on Monday. Di IRGC no comment but say dia forces don shoot down two US MQM-170 drones south of di island and a US MQ-9 drone east of di Strait.

Di US and Iran reach preliminary agreement to end di war and reopen di strait in June, but e collapse within weeks afta Iranian attacks on shipping resume and di US bring back naval blockade of Iranian ports.

Iranian negotiators dey discuss wit mediators about proposal to reopen di Strait of Hormuz within two days if di US meets seven conditions, reportedly including di lifting of di naval blockade and releasing frozen Iranian assets.

Howev dis week Donald Trump say di US no longer dey interested in a deal to end di war wit Iran and ordered Vice-President JD Vance, wey don dey involved in efforts to restart negotiations, to focus on domestic US politics.