Foods wey go increase your bone health

Wia dis foto come from, Creative Cultural via Getty Images
Our bone density begin dey reduce earlier dan you fit think. But to ensure say our diet dey rich in certain nutrients fit help to keep our skeletons strong.
Drinking milk go help you to grow strong bones. Dis na some of di first health advice many of us receive.
As children, many of us dey encouraged to finish our milk at break time wit di promise say di calcium go help us to grow a strong and healthy skeleton.
But though dis dairy-heavy advice dey often enta into our memories from an early age, wetin dem no really tok about for our social circles now na just how common fragile bones later become in life – and how if we no protect our bones wen we dey younger, we open oursef up to increased risk of fractures.
Luckily, sometin dey wey we fit do about am, wateva age wey we dey. Wit diet packed wit di right nutrients, alongside staying active, we fit get healthier bones – and no, no be just about drinking more milk.
Our bone health dey shaped decades bifor dem start to show signs of frailty. Di skeleton we carry in later life depend on di bone reserve we build during childhood and early adulthood, wen bones grow stronger and denser bifor reaching dia peak for early adulthood, say Kate Ward, one professor of global musculoskeletal health at di University of Southampton in di UK.
Afta we begin to lose bone density as we age, e also get around 500 million pipo worldwide wit osteoporosis, a condition wey dey weaken our bones, causing dem to become thinner and more brittle.
Conditions like osteopenia and osteoporosis na often silent diseases wey dey show no symptoms until potentially life-altering fracture occur, explain Julie Thompson from di Royal Osteoporosis Society in di UK.
As women age, dem dey particularly vulnerable to loss of bone density, especially during menopause – and dem get higher prevalence of osteoporosis. But men dey affected too.
So, wetinwe fit chop to ensure our bones stay strong?
Foods dat help di bones
- Milk cheese and yoghurt
Calcium, vitamin D and protein na di primary drivers of bone health and nutrients like vitamin K, magnesium, zinc and phosphorus all dey important for maintaining healthy bones and muscles.
E dey common knowledge say foods rich in dairy dey indeed rich in calcium – one 200ml (6.8 fl oz) glass of milk provides about 260mg.
As for how much to consume, recommendations vary between kontris. In di UK adults dey recommended to consume about 700mg of calcium per day.
If you dey at risk of osteoporosis, di recommendation na 1,000mg per day. Postmenopausal women meanwhile should aim for 1,200mg.
In di US di recommendation na for adults to consume between 1,000-1,200mg of calcium each day, depending on your age and gender.
- Soy
E get plenty of non-dairy food sources wey help you get calcium into your diet, say Ward.
One of dis na soy foods, such as tofu and edamame beans – 100g (3.5oz) of tofu contains 200mg of calcium.
E get emerging evidence say soy foods fit reduce di risk of fractures.
Soy contain type of naturally occurring plant compound wey resemble oestrogen, called isoflavone.
Studies have also found say postmenopausal women wit high intake of soy supplements get better bone density.
Another source of soy is tempeh, wey dey made through fermentation, a process wey break down compounds known as antinutrients, wey fit interfere wit di absorption of minerals important for bone health.
As a result, our body fit absorb more calcium from tempeh.
- Chia seeds
Chia seeds na excellent source of calcium, magnesium and phosphorus, and we only need small amount to get numerous nutrients.
One tablespoon contains 95mg of calcium.
Dem dey also rich in omega-3 fats, wey help reduce inflammation.
Dis is particularly important, becos chronic inflammation fit cause di body to break down old bone tissue faster dat e fit can rebuild am.
Ova time, dis imbalance fit increase di risk of osteoporosis. For animal research, rats fed chia seeds for ova year get better bone mineral content dan dose on a standard diet.
While di findings dey promising, more research dey needed to understand if di same effect go occur in pipo.


















