Kano State Abba Yusuf govnor divorce im wife Zainab Musa Kwankwaso?

Wia dis foto come from, Abba Kabir Yusuf/ X
Kano state govnor Abba Kabir Yusuf don stir controversy afta some comments e make about im marriage, during one event wey hold for di state government house.
As e dey address pensioners on Monday, 16 November, di govnor bin jokingly announce for public say im marriage to Zainab Musa Kwankwaso, niece of im former political mentor, Rabiu Musa Kwankwaso don end.
Im comments dey come as tori bin spread ova di weekend say Zainab don file for divorce for one Upper Area Court for Gudu, Abuja to seek end to dia union.
Di development don spark widespread public interest, sake of di long-standing political relationship between Yusuf and di former Kano state govnor, Rabiu Kwankwaso, wey pipo see as im political benefactor.
Although di Kwankwaso family and di govnor office neva tok wetin cause di separation, however, Yusuf comments on Monday appear to confam di end of di marriage.
Wetin di Kano govnor tok
Governor Abba say, “Dos wey know, know,” witout giving any further explanation.
For di same video, dem also hear am say: “If na white paper na wetin dem need, den we don give am, make evribodi rest, na dat be dat.” Somtin wey many pipo believe say e dey tok about divorce paper.
E add say: “And we fit instruct di Commissioner of Information to issue one statement and advertise am for social media so dat dos wey wan fill di vacant position fit write application. If you know, you know.”
However, some pipo believe say e dey respond to im wife, Zainab Musa Kwankwaso, wey e don spend 20 years in marriage wit, at di same time e dey propose to add anoda wife.
Who be Zainab Musa Kwankwaso?
Zainab Musa Kwankwaso na niece of former Kano State Govnor and Senator Rabiu Musa Kwankwaso.
She marry Kano State Governor Abba Kabir Yusuf for 2006, and di 20-year marriage produce six children.
E no dey clear but according to tori, di wahala follow long political and personal disagreement between govnor Abba Kabir Yusuf and im former political mentor and father-in-law, Rabiu Kwankwaso.
According to reports, for middle of November 2026, Zainab bin file for divorce for and offer to return her dowry/bride price.
On November 16, 2026, Govnor Abba Kabir Yusuf publicly hint about di end of di marriage.
How Nigerians react
Plenty Nigerians don follow di tori of di govnor separation from im wife following im comment, especially dos wey dey di northern part of di kontri. Dem condemn di govnor action for im public comments.
One Al'ameen for X say: “I no like di way Gov. Abba Kabir Yusuf divorce im wife, Hajiya Zainab Musa Kwankwaso, on top public podium today, but I also no go put all di blame on am.
"Di ex-wife suppose don know better dan to throw away 20 years of marriage and six children sake of politics. I also blame Kwankwaso for much of wetin don happun. You no suppose use marriage as a tool to hold pesin hostage or force am to bicom your political stooge."
Anoda X user dey of di opinion say, Kwankwaso na part of di problem. "No way both Ganduje and Abba go turn dia back on am if e respect imself and understand say supporting a politician no mean say you go control elected govnors. You no fit expect sitting govnor to surrender dia independence and political authority to you”.
Ibrahim Macduff say: “You expect her to stay for marriage wia her husband dey plan evil against her papa? I keep hearing pioo dey say she no be im biological daughter. Dis one prove say Kwankwaso raise her just like im own children.”
Anoda Sarkin Yaki Na Baba Buhari say: “I no like bringing family matters into politics and making dem public! 20 years no be two days. Why take di matter to court and make am public? Na sign to damage im political image, na dia she make mistake.”
Nosyz man say: “You know how painful e dey when your husband betray your papa? Her papa allow di marriage bicos of di love wey e get for Abba, yet Abba betray am despite evritin wey e do for am... Kwankwanso go get additional sympathy votes.”


















