Nigeria beat Tanzania 3-1 for 2027 Afcon qualifiers to keep hope alive

Nigeria forward Tolu Arokodare kick di ball
Wetin we call dis foto, Substitute Tolu Arokodare score two goals for Nigeria in less dan 10 minutes
Published
Read am in 5 mins

Nigeria forward Tolu Arokodare na di man of di moment as e score two goals to keep di 2027 Africa Cup of Nations hope for Nigeria alive.

Di player wey enta di match for second half score im first goal for 52 minutes. E score im second goal for 60 minutes.

Arokodare miss plenti chances wey for make am score hat trick but Alhassan Yusuf early goal give Nigeria enuf ginger for di first half.

Alhassan score for di second minute bifor Tanzania score dia only goal for di 32nd minute.

Di most important tin be say Nigeria collect all di three points and di match end 3-1.

for di first half and parts of di second half, di Taifa Stars bin also get dia m oments wey dem fail to convert.

Nigeria still dey second for di table wit six points afta three matches while Tanzania dey bottom of di group.

Guinea-Bissau still dey top Group L wit seven points.

Match highlights

Second Half

Full Time

Nigeria 3-1 Tanzania.

90+4 Referee blow whistle, match don end.

90+3' Substitution for Nigeria Semiu Ajayi don replace Ola Aina.

90+1 Taifa Stars player Msanga wey score Tanzania only goal make attempt to score as e fire shot but e go ova di side of di goalpost.

90' Referee add four minutes

89' Nigeria defender Calvin Bassey just dey block any Tanzania player wey near di goal area.

86' MISS! Tolu Arokodare of Nigeria miss chance to score hat trick for di Super Eagles , e get clear chance to score but e fire di ball enta goalkeeper hand.

85' Substitution for Tanzania Suleiman don enta, Migo don comot.

83' SAVE! Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali and defender Calvin Bassey clear di threat from di Taifa Stars wey bin wan enta net. Nwabali catch di ball.

79' Tanzania no wan gree for Nigeria as dem dey continue to press di Super Eagles to try score.

76' Nigeria player Akor Adams get chance to score again but e enta offside.

73' CHANCE!!! Tanzania get chance to reduce di goals tally but too many touches for di goal area no allow dem score.

70' Di tempo of di match don cool down small, Akor Adams make run towards Tanzania area but refereee blow for offside.

67' MISS! Akor Adams!!!! E miss beta chance to finish Tanzania for dis match.

Nigeria 3-1 Tanzania

60' Di striker wey just enta di game for dis second half score two goals

GOALLLLLLLL for Nigeria! Tolu Arokodare don score again!

58' Tolu Arokodare get anoda chance to score but as im first di first touch, ekon spoil di ball.

56' Nigeria get di momentum now as dem dy try score more goals Tanzania sef dey chase dem.

Nigeria 2-1 Tanzania

Arokodare flick di ball inside net wit style as e give Nigeria di lead.

52' GOALLLLLLL for Nigeria! Tolu Arokodare score for di Super Eagles.

49' Tanzania players don wake up o, dem don begin worry Nigeria midfield.

Nigeria start dis second half wit action as dem dey surround Tanzania defence dey find goal.

47' Substitution for Nigeria Moses Simon don enta for Ademola Lookman, Moses Usor for Alhassan Yusuf. Tolu Arokodare replace Nnadi Tochukwu.

46' Second half don start

Victor Osimhen of Nigeria/Simon Msuva of Tanzania

First Half

Nigeria 1-1 Tanzania

45+5 First half don end

45' Chance! Nigeria get chance to score but Fredrick play di ball wey use go pastbdi net roof.

45' Referee add five minutes

45' Alex Iwobi play di corner kick wey meet Nigeria players but notin comeout as di ball end for Tanzania goalkeeper hand.

45' Dem don carry Ademola Lookman comot from field sake of injury.

43' Corner kick for Nigeria, Alex Iwobi dey wait to play am but Ademola Lookman dey for ground dey get treatment.

40' Nigeria captain Wilfred Ndidi fire shot as e bin try to score but di ball go wide.

36' Nigeria player Akor Adams shade Tanzania goalkeeper sake of say e hold di ball too much.

Nigeria 1-1 Tanzania

Mabula Msanga score for di Taifa stars as e dribble Nigeria defender Calvin baasey and anoda defender to score

32' GOALLLLLLLLL Tanzania don equalise

24' Nigeria player Alhassan Yusuf wey just score bin get anoda chance, e pass di ball to im teammate wey play di ball comot from di field.

20' Nigeria player fall for ground afta tackle from Tanzania player but e don stand up and game don continue.

15' Nigeria still dey control di ball but second goal neva come while Tanzania dey hustle to break Nigeria defence.

12' Nigeria player Alhassan Yusuf collect yellow card as e tackle Tanzania player.

10' Nigeria dey dominate do game so far as Akor no dey give di Taifa starts space to play di game.

7' Match don resume wit freeklick for Nigeria, dem play am toward goall but e go wide.

5' Tanzania player dey for ground dey collect medical attention afta e Nigerian opponent tackle am.

Nigeria 1-0 Tanzania

2' GOALLLLLLLL Alhassan Yusuf score for Nigeria. Alhassan Yusuf score afta Ademola Lookman pass ball give am.

1' Match don start

Line-ups

Nigeria: Nwabali (GK), Fredricks, Bassey, Aina; Ndidi, Bwene, Iwobi, Alhassan; Lookman; Adams, Nnadi

Tanzania: Manula (GK); Chilambo, Mwamnyeto, Mlingo; Mao, Miroshi, Msanga, Kachwele, Denis, Hamad, Mnoga.