Canada police arrest eight Nigerians, odas over $4.5m luxury car theft accuse

Wia dis foto come from, Peel Regional Police
Canadian police don arrest 12 suspects, wey include eight Nigerians, inside investigation into one alleged car theft syndicate.
Dem chop accuse say dem tiff luxury vehicles and dey ship dem to West Africa.
Police for Peel, Ontario say dem recover 96 high-value vehicles wey dem hide for shipping containers. Dem dey ship di vehicles, wey dey valued at $4.5m (£3.4m) for export via Canadian ports.
Di suspects dey face 231 charges, as dem issue arrest warrants for odas. Police say some of di accused fit face deportation afta dia criminal proceedings end.
Di Nigerians wey dey named for di car theft allegation include Stanley Udeh, Olawale Ibrahim, Tosin Oyebade, Oluyemi Sodade, Oluwaseyi Bameke, Gbolahan Babatunde, Olushola Oke and Kenneth Okafor.
According to di Canadian police, di arrest bin follow months of wetin police describe as "extensive auto theft investigation".
Di investigations wey start for March na in partnership wit Canada border agency. E start afta police bin identify one warehouse wey dem allegedly dey use store stolen vehicles.
Investigators believe say five pipo dey lead di network wey dey coordinate di theft, transportation and export of di stolen vehicles, while odas dey play supporting roles.
"Togeda, investigators link di network to loading sites, container movements and di transportation of stolen re-VINed vehicles," di police tok for statement.
Authorities say some of di suspects fit face deportation. "In addition, dem fit refer some of di individuals wey Peel Regional Police charge to di CBSA make dem go face immigration enforcement action, including possible removal from Canada, following di conclusion of dia criminal proceedings."
Wetin be Re-VINing?
Re-VINing na di illegal practice of changing di Vehicle Identification Number (VIN) to hide dia identity and make am harder to trace.
Canadian authorities don describe di organised vehicle theft as a growing threat, and dem say e dey linked to wider criminal networks.
"Organised auto theft na predatory business model wey transnational syndicates wey dey terrorise families and fund broader criminal enterprises dey operate," Peel Regional Police Deputy Chief Nick Milinovich tok.
Di trafficking of vehicles from North America and Europe to African countries for long na mata of concern for law enforcement agencies.
Last year, Interpol tok say dem don recover more dan 100 luxury vehicles wey jaguda pipo tiff from Canada and European countries, and dem expose one network wey dey involved in trafficking stolen cars to West Africa.
For anoda separate operation di same year, Ghanaian security authorities bin recover 43 luxury vehicles dem tiff from Europe and North America.
Dem attribute di success of di operation to improved cooperation between national and international law enforcement agencies.





















