BBC launch programme for children wey bandits and poverty force out of school for West Africa

Wia dis foto come from, Ifiokabasi Ettang/BBC
- Author, Madina Maishanu
- Role, BBC Africa
- Reporting from, Goronyo
- Published
- Read am in 6 mins
As she dey pounds millet, 15-year-old Hadiza just dey sing di English alphabet. E remind her of wetin she miss wen she still dey go school.
She tok say, "sometimes I go write for ground to practise and see weda I still dey write am well".
Like two years ago, group of jaguda pipo raid her village for night.
She remember say, "dem pursue our cows comot and kidnap one girl. We sef gatz run, na barefoot we run reach here".
Since dat time, na for one displaced pipo camp for Goronyo wey no too far from her house she dey stay. She bin dey go school wen she dey di camp for some time, but she later meet one man wen she be 13, she stop dey go for classes and she marry.
"Na tradition here say once girl marry, her education go stop," she explain.
Even though Nigerian law no dey allow marriage for under 18, dem no dey enforce am.

Wia dis foto come from, Ifiokabasi Ettang/BBC
Hadiza na one out of nearly 19 million children for Nigeria wey dey miss out on education, according to estimate wey Unesco share for 2024. Dat na about one in four of di kontri school-age children.
Against dis background, BBC World Service don launch Dars Hausa, one educational programme for Hausa language, wey bi di main language wey plenty pipo for northern Nigeria dey speak, plus pipo for neighbouring countries Niger, Cameroon and oda parts of West Africa.
Di programme dey teach English, maths and science lessons to children across West Africa, for social media, local television partnerships and radio. Many pipo for di region dey get dia news from di radio and nearly half of di households for Nigeria get one, according to di charity Save di Children.
Dars mean "lesson" for Pashto and Dari. Dem first launch am for dos languages for 2023 for Afghan children dem ban say make dem no go school. By February 2025, dem add Arabic version.
Di reasons why so many Nigerian children dey out of school plenty and e dey complex.
Like Hadiza, 12-year-old Rukayya also dey live for di displacement camp for Goronyo.

Wia dis foto come from, Ifiokabasi Ettang/BBC
She say, "e dey pain me say I dey see oda children dey go school and I no fit".
As na she be first born, evriday Rukayya go go gada firewood to sell so her younger siblings go fit see sometin chop.
She explain say "If to say my papa still dey alive, I for no need to go dey beg". She say some pipo dey laugh "but she no send becos dat na our only way to survive."
Bandits kill her father about one year ago for her front, she say she and di rest of di family run from dia house go di camp.
She and Hadiza dey among 670,000 pipo for north-west and central Nigeria wey dey forced from dia homes by armed robbery and kidnappings, according to di International Organization for Migration.
Militant Islamist groups dey carry out attacks, but majority of di attacks for dis region na by criminal gangs, wey dey known for Nigeria as bandits, dem dey tiff, kill and kidnap.
Di school wey Hadiza bin dey go bifor now na di only one wey children for di camp dey go, and about 50 students dey for each class.
One of di teachers, Kamilu Sulaiman Jakada say even though di lessons dey free, na only small number of students dey come, and no be evriday bicos parents dey tell am say, "di children na di breadwinners" and dem need to make money to chop.

Wia dis foto come from, Ifiokabasi Ettang/BBC
E say di school no get enough teachers or classrooms, and e explain say funding no dey consistent and e dey most time come from individuals or organisations instead of di govment.
Di oda challenge na di bandits. E get one time wey di gang bin come di school on motorbikes, dem dey shoot for air, e tok, and although nobody injure, many parents fear and withdraw dia children. Dat na how parents dey react to attacks for some oda parts of di kontri too.
Evri Nigerian children suppose get nine years of free, compulsory education - six in primary and three for secondary school. Di responsibility for schooling dey for di hand of di federal, state and local govments.
But many schools dey face shortage, and poorer families wey no fit afford private education fit struggle to pay for uniforms, books and transport.
Di crisis don increase ova di years as different govments don struggle to address serious underfunding and poor oversight of resources.
On top of dat, many children dey for di traditional Almajiri system, wey dey provide Islamic education, dem no dey teach subjects like maths and science for there, and Unicef see am as out of school.

Wia dis foto come from, Ifiokabasi Ettang/BBC
Minister of State for Education Prof Suwaiba Sa'id believe say di number of children wey dey out of school no reach wetin dem report, but she admit say wit Nigeria growing population, "dem no do di proper investment, di proper oversight, … I no go mention di names, but we know of two states wey no employ one single teacher for eight years".
She tok say education na di govment "number-one priority" and dem design initiatives like Lumina to help address "decades of neglect". Lumina aim na to support one million girls by 2030, provide accelerated learning programme for older girls wey don miss years of formal education.
She also say "govment dey do evritin possible" to deal wit bandits and say "we don see children wey suppose dey for school but instead dem follow dey do banditry".
For now, na children like Hadiza and Rukayya di BBC World Service Dars Hausa programmes dey aim to help.
Hadiza tok say she still get dream say one day she go bicom doctor "to help my fellow women".
Dars Hausa go air for BBC News Hausa radio on Sundays at 06:45 West Africa Time, and go repeat for 20:45. Di programme go also dey available via BBC News Hausa digital platforms, wey include YouTube, Facebook, X and Instagram.





















