Manchester United name Mauricio Pochettino as new coach

Foto of Mauricio Pochettino
Wetin we call dis foto, Mauricio Pochettino
Published
Read am in 3 mins

Premier League side Manchester United don name former Tottenham Hotspur coach Mauricio Pochettino as di head coach of dia football team.

Pochettino wey be di head coach of di United States men football team go start work for Manchester United from 18 November, 2026.

Di club reach di agreement wit di US Soccer Federation, so dat dem fit release Mauricio and im staff wen dem finish dia responsibilities wit di US men national team.

For statement wey Manchester United release, di club tok say di Argentinian dey known for im "high-intensity, attacking style of football, im dedication to building strong, cohesive teams and im outstanding record of developing individual players."

Di statement add say Pochettino dey perform consistently for di highest level of football across multiple leagues.

Who be Mauricio Pochettino?

Mauricio Pochettino start im coaching career wit Spanish side Espanyol for 2009 bifor im join Southampton wia im achieving club-record Premier League points tally for 2014.

During five full seasons for Tottenham Hotspur, Pochettino bin establish di club as regular Uefa Champions League contenders, wey bin secure qualification for four consecutive seasons and e also lead di club to di first final for di competition for 2019.

For 2021, e join Paris St-Germain, wia e win di Ligue 1 title, di Coupe de France and di Trophee des Champions, bifor e join Chelsea for 2023.

Most recently, e lead di US men national team to di round of 16 for di Fifa World Cup.

Mauricio Pochettino need to start to dey work immediately to get results as e dey replace Michael Carrick as Manchester United boss.

Im first game in charge of Manchester United go be against Liverpool for Anfield next week Sunday.

Manchester United go travel go Portugal to face Sporting for di Champions League, and Pochettino first home game for di Premier League na against Brentford on Saturday, 28 November.

Dem name Mauricio Pochettino, head coach of USA for September 2024 and di team win 21 of im 35 games in charge, wit 12 losses.

E lead di USA to di final of di 2025 Concacaf Gold Cup and e also reach di round of 16 for di last Fifa World Cup, wen dem bin co-host di tournament.

"Mauricio don leave lasting mark on US Soccer through im leadership, professionalism and commitment to our players and culture," na wetin di US Soccer chief executive and secretary general JT Batson tok

"Wetin we dey most proud of go beyond di wins. Im and im staff raise standards, strengthen our culture and create clearer connections from di youth national teams to di senior team.

"Dis changes dey inside how we dey operate now and we go continue to build on dem as we pursue sustained success for di world stage."