Tinubu issue warning order ova attacks at political rally

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP via Getty Images
President Bola Tinubu don order security agencies to confront any form of thuggery and oda anti-social and anti-democratic activities wit full force.
Di Nigerian leader give dis charge as reports of political violence dey on di rise for di kontri ahead of di 2027 general elections.
For one statement on im official X account on Friday, 13 November, President Tinubu condemn violence during political campaigns and say campaigns must be about issues.
"Evri form of violence stand condemned. Violence no suppose ever get place for our political campaigns as we move toward di 2027 general elections.
"Our campaigns suppose dey about issues, a contestation of ideas wey go promote di welfare of our pipo and di progress of our kontri," Tinubu tok.
Di president reaction dey come afta one recent attack on di oppostion Nigeria Democratic Congress (NDC) political townhall meeting for Lagos state.
Dis no be di first time wey suspected thugs go cause kasala during political ralllies, especially for opposition camps.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Attacks on part supporters
Di most recent one wey happun for Lagos bin attract plenty reactions and both political stakeholders and parties condemn di action.
According to report, suspected political thugs on Thursday, 12 November attack members and supporters of di Nigeria Democratic Congress (NDC) for Oregun area of Lagos.
Di incident bin force many of di attendees to run for safety and e cause panic for di area.
Tori say broken glasses full di ground for di disrupted venue, and di suspected hoodlums destroy several vehicles wey belong to NDC members and supporters within di premises.
One party supporter, wey follow Channels Television tok afta e sustain head injury, allege say hoodlums carry cutlasses attack di area and dia aim na to scata di gathering.
E say dem mobilise more NDC members to stop dem and dat na wetin later make dem leave di area be dat.
On 11 November, for Gombe state, northeast Nigeria, suspected political thugs bin set up burning bonfires (tyres) for road and break di windshields and bodywork of vehicles wey belong to di Peoples Democratic Candidate govnorship candidate for di state Isa Patanmi, as im motorcade and campaign team land Gombe for political rally and homecoming reception.
Di kasala happun for Jekadafari area of di state and di Gombe state police command don launch investigation into di attack.
For Katsina state, suspected hoodlums bin attack supporters of di All Progressives Congress (APC) as dem dey go di campaign rally for Govnor Dikko Radda.
According to di police, one crowd bin blck one road for Yankara, begin throw stones and burn political posters afta govnor Dikko Radda pass through di town on im way to one APC governorship campaign rally for Faskari.
Some of di supporters wound as di jaguda pipo and burn down di vehicle.
Di African Democratic Congress and di Peoples Democratic party (PDP) too get dia own share of violent attacks during campaigns wey bin don happun for states like Enugu, Benue, Delta, Edo, and Sokoto States.
Katsina state police tok-tok pesin Abubakar Aliyu for statement describe di incident as suspected political thuggery.
E say dem don arrest three pipo afta dem set fire on one motor.
Reports of attacks don also occur for states like Enugu, Benue, Delta, Edo, and Sokoto states during political campaign rallies.
'Evri form of violence stands condemned' - Tinubu

Wia dis foto come from, Bola Ahmed Tinubu/X
President Tinubu say im don follow recent reports of violence for political events for different parts of di kontri, and im no go tolerate am.
"As di leader of dis kontri, I commit myself to a peaceful, free, and fair election, and I don urge political leaders and supporters across party lines to conduct themselves responsibly."
E say becos pipo belong to different political parties or dey pursue different ambitions no make us enemies.
"As Nigerians, we be members of di same household wey dey live for different rooms. Therefore, our politics must elevate human conditions and focus on national progress and development," Tinubu add.
Dis na as e cut warning say im administration no go tolerate any irresponsible conduct by politicians and dia supporters.
"Our administration dey committed to orderly and peaceful election, and all political parties and candidates suppose dey protected and free to campaign anywhere for di kontri without molestation or fear for dia safety."
Tinubu say im don give authority to security agencies to handle thuggery and any oda yeye anti-demicratic behaviour wit full force.
Wetin dey cause attacks during political campaigns?
For one interview wit BBC, one senior security expert for Borno State, Detective Auwal Bala Durumin identify three reasons why attacks dey rise for political campaigns, particularly on opposition parties.
Durumin allege say, first political thugs dey attack to stop di party wey dem no want from moving freely and reaching members of di public during dia campaigns.
E also claim say, "most politicians dey go campaign wit dia own thugs. For many cases, you go see say no peace dey between di two groups of thugs, and dis sometimes dey lead to clashes."
Di security expert also say some pipo dey use di occasion of campaign to tiff and commit different crimes.
Anoda reason na say politicians dey hire thugs to protect dia banners and posters from pipo wey fit come remove dem and sometime, e dey lead to problem, e add.
On how to put an end to di threat, detective Durumin call for law wey go guard against presence of thugs during campaigns.
"Govment gatz make sure say anybodi wey dem find guilty of dis kind offence face punishment, and dem suppose announce di punishment publicly, so dat e go serve as lesson to odas.
"Dem suppose make law wey go stop any politician wey dey move around wit thugs for campaign from contesting election, or make dem face prosecution for court, e add.





















