'Wetin cause wahala between me and my wife' - Kano govnor Kabir Yusuf speak on marriage issue

Man wear white wit red cap
Published
Read am in 4 mins

For di first time, di govnor of Kano State don give more explanation about some comments about im life wey spark plenti debate for Northern Nigeria.

During one interview wit BBC Hausa, Abba Kabir Yusuf tok in detail about how wahala start between am and im wife, Zainab Musa Kwankwaso, wey be relative of former Kano State govnor and NDC Vice-Presidential candidate, Rabiu Musa Kwankwaso.

On Monday, 16th November, Govnor Abba make comments during one gathering of pensioners for Kano State Govment House conference hall.

Di comments come as rumours dey spread say di govnor and im wife don get problem, afta one report by Daily Nigerian wey say Zainab Kwankwaso don file divorce case for one court for Abuja, Nigeria capital,

She ask make di court end her marriage wit di governor.

Di matter don generate debate becos of di relationship between di govnor and Rabiu Musa Kwankwaso, wey be Zainab guardian and Abba Yusuf former political mentor.

Wetin cause di disagreement between Kabir Yusuf and Kwakwanso niece?

BBC reporter ask am about di comments wey pipo believe say e direct to im family.

"Family matter like na very difficult tin," Govnor Yusuf tok.

E continue, "dis woman Zainab, na im (Kwankwaso) niece. Na im arranger her marriage, but di marriage no last long. Later, God bring us togeda, and we marry about 20 years ago. We get children."

Di governor say e even tell dia children say Zainab go return to im house.

"Suddenly, na court papers dem serve me. And for di court wey dey Abuja, no be Kano," di govnor tok.

E add say, "na painful situation."

E say although e no go come public to explain exactly how dem carry im wife comot from im house, e get witnesses and detailed information about how di matter happen.

According to am, di matter no suppose become public controversy becos such tins dey unusual.

Wen dem ask am why e decide to make di comments publicly, Governor Yusuf say:

"Na no be me politicise di matter. If dem do dis kain tin to you, you go happy?

"Dem pack your family belongings without your knowwledge, dem carry your wife comot from your house without your knowledge, dem take am go anoda pesin house witout your knowlege, den suddenly you hear say na she take you go court."

Di governor say dem dey continue to look into di matter, and e possible say dem fit reach agreement and reconcile.

Who Be Zainab Musa Kwankwaso?

Zainab Musa Kwankwaso dey regarded as relative of former Kano State governor and senator, Rabiu Musa Kwankwaso.

Her original name na Zainab Dahiru Musa. Her papa, wey be nephew of former Kano State govnor Rabiu Musa Kwankwaso, don die many years ago.

Afta her papa die, Zainab grow up for Rabiu Musa Kwankwaso house, wia she stay until e arrange her marriage.

She marry Kano State Govnor Abba Kabir Yusuf for 2006. Dem don spend 20 years for marriage and get six children.

Pipo believe say di disagreement for dia marriage start afta long political dispute between Govnor Abba Kabir Yusuf and im former political mentor, Rabiu Mussa Kwankwaso, wey also dey act as father figure to im wife.

Di political disagreement begin intensify afta Abba Kabir become govnor of Kano state for 2023.

According to Daily Nigerian, around middle of November 2026, Zainab file petition for one court for Abuja, asking di court to dissolve dia marriage. Di court later serve Govnor Abba.

Who be Abba Kabir Yusuf?

Abba Kabir Yusuf na govnor of Kano State, one of di states wey get plenty population and business activities for northern Nigeria.

E win di govnorship election for 2023 afta e lose for 2019.

Former Kano State Govnor, Rabiu Musa Kwankwaso play important role for Abba victory for di 2023 election, but di two later fall out.

Yusuf move to Nigeria ruling party APC witout im former political mentor wey mark di end of decades of political relationships between di two men.

Plenty pipo accuse di govnor of betrayal, but for im interview with BBC Hausa, Abba deny di allegation.

Dem born Abba Kabir Yusuf for 5 January 1963 for Gaya Local Government Area of Kano State.

E previously serve as Commissioner for works for Kano State during Rabiu Musa Kwankwaso administration.

Abba, wey pipo popularly call Abba Gida-Gida, contest govnorship election for Kano State under PDP for 2019 but e no win.