Who be Wole Olanipekun Tinubu honour wit Grand Commander of the Order of Niger?

Wole Olanipekun
Published
Read am in 3 mins

President Bola Tinubu don honour legal luminary and Senior Advocate of Nigeria, Chief Wole Olanipekun (SAN) wit Nigeria second highest honour, di Grand Commander of di Order of Niger.

Di Nigerian leader make di conferment for Abuja, di kontri capital for one event to mark Olanipekun 75th birthday, 50 years for Bar, and 35 years as a Senior Advocate of Nigeria.

For statement wey one tok-tok pesin to di president Bayo Onanuga issue, Tinubu hail Olanipekun for im years of commitment, hard work, resilience, mentorship of younger generations, and advancement for di legal profession.

Although, di statement no tok why di president honour am wit di kontri second highest honour, but di president note say Olanipekun don lead im legal team for many years.

"E don lead my legal team for decades. In politics, friends come and go, but Wole came and stayed."

Oga Tinubu also describe Olanipekun as ogbonge advocate wey don serve as lead counsel to four successive Nigerian presidents since 2007, including imsef and three of im predecessors wen dia elections victories bin face court challenges.

Who be Wole Olanipekun SAN?

Chief Oluwole Oladapo Olanipekun, SAN, FCIArb na di Founder and Principal Partner for Wole Olanipekun & Co's.

Dem born am on 18th of November, 1951 for Ikere-Ekiti, Ekiti State. E be Nigerian lawyer, former President of di Nigerian Bar Association, and a Senior Advocate of Nigeria.

Olanipekun establish Wole Olanipekun & Co., one leading Nigerian law firm for 1980. A Senior Advocate of Nigeria since 1991, e dey recognised as one of di foremost legal minds for di kontri wit ova four decades of practice.

E bin serve as Attorney-General and Commissioner for Justice of Ondo State (1991–1992) and as President of di Nigerian Bar Association (2002–2004), wia e champion reforms to strengthen di independence of di judiciary plus di integrity of di legal profession.

Olanipekun don act as counsel for numerous landmark cases bifor di Supreme Court plus oda superior courts, wey cover constitutional law, election petitions, commercial disputes, and complex corporate litigation.

Im academic accomplishments include honorary doctorate degrees Doctor of Laws (LL.D, Honoris Causa) from di University of Ibadan, Doctor of Letters (D.Litt.) from Redeemer's University, Ede, Osun State, and Doctor of Constitutional Law (Honoris Causa) from di Federal University, Oye-Ekiti.

On 17 September 2012, President Goodluck Jonathan honour am wit di National Honour of Officer of di Order of di Federal Republic (OFR).

One decade later, on 11 October 2022, President Muhammadu Buhari, GCFR, further elevate am wit di National Honour of Commander of di Order of di Federal Republic (CFR), di third-highest rank for di hierarchy of national honours.

On 19 July 2024, Nigeria Global List in London, United Kingdom, name am as one of di 50 Most Influential Nigerians Globally.

Nigeria get structured system of national honours dem dey use recognise citizens and foreign nationals wey do make outstanding contributions to di kontri.

From presidents and judges to academics, athletes, artists, and professionals, these honours represent di highest form of national recognition for Nigeria.

DI two highest honours na di Grand Commander of di Order of di Federal Republic (GCFR), and Grand Commander of di Order of the Niger (GCON),

Na President, Vice-President, presiding judge for di Supreme Court, Senate President, dey receive di award.

Ogbonge Nigerians wey don receive dis honour include Alex Ekwueme, Aliko Dangote, Wole Soyinka, Emeka Anyaoku, among odas.