Wetin law tok about political parties using govment facilities for campaign

Wia dis foto come from, Light Oriye Tamunotonye / AFP via Getty Images
- Author, Muslim Muhammad Yusuf
- Role, Senior Journalist
- Reporting from, BBC News, Abuja
- Published
- Read am in 4 mins
As campaigns ahead of di 2027 general election continue to gada momentum, some Nigerian politicians don raise concerns on di challenges dem dey face to secure campaign venues for some states for di kontri.
Na opposition parties often dey raise these complaints.
Dem allege say afta dem submit request to use govment facilities for campaign, authorities go later tell dem say dia application "no get approval".
Sometimes, dem go dey march for city centres to campaign, becos som eauthorities tok say renovation work dey happun for di places wey dem request.
Some opposition groups don also allege say even wen dem try to rent private venues for meetings, pipo go threaten di owners or deploy security operatives to stop access to di venues.
Dis situation don raise questions about weda stopping political parties to use govment facilities for campaigns dey legal under di law.
Times wey dem deny politicians campaign venues

Wia dis foto come from, Getty Images
Recently, di African Democratic Congress (ADC) allege say Kaduna State govment deny dem permission to use Ranchers Bees Stadium for dia presidential campaign. However, di state govment deny di allegation.
For di Federal Capital Territory (FCT), Abuja, several disagreements don also happun between di Minister of di FCT, Nyesom Wike, and opposition parties over use of venues for political rallies.
End of Di one wey oda users dey read well well
For Sokoto State, di ADC also allege say dem stop dem from using govment venue to hold meetings, even though di ruling APC dey use di same location.
In di same way, di presidential candidate of di AAC, Omoyele Sowore, once write govment to request permission to use di conference room inside Presidential Villa, argue say na public property and dat di APC previously hold conference dia.
However, for Bauchi State, di ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, praise di state govment for allowing dem campaign freely inside di state.
On dia own side, Peter Obi and oda members of di NDC complain say dem dey deny dem campaign venues bicos dem be members of opposition party.
For Abuja, dem make similar complaints as dem prepare to hold rally to announce di induction of Peter Obi and Rabiu Musa Kwankwaso into di party.
Likewise, di SDP for Nasarawa State release petition requesting approval for venue wey dia representatives and dos of di Rainbow Coalition submit to di state govment, allege say authorities deny dem access to di venue.
Wetin Nigeria law tok?
For June 2024, di Independent National Electoral Commission (INEC) stress say parties and candidates no suppose be denied access to govment facilities for campaign rallies.
Di commission say such action fit amount to abuse of power to favour one party or candidate above anoda.
Barrister Aminu Abdulrasheed, one Nigerian legal scholar, say di kontri laws no allow discrimination when granting citizens access to public facilities.
"Pipo wey dey power suppose remember say di places wey dem control, weda federal or state, no belong to ruling party or di pilo wey dey power," e tok.
E say evribodi get rights, weda dem be members of opposition party or ruling party.
Di barrister list some provisions of Nigerian law wey relate to dis issue:
- Section 39 of di 1999 Constitution of Nigeria provide for freedom of expression, wey include right to express opinions and spread information and ideas witout interference.
- Section 40 give evribodi right to freedom of assembly and association with others, especially di right to form political party or bicom member of one.
- Section 42 prohibit discrimination against any citizen or denial of rights based on political views.
- Section 91(1) and (4) of di Electoral Act 2022 state say police must provide adequate security for peaceful political rallies. E also say no registered political party should be prevented from holding rallies or marches for dia constitutional political activities. If dispute arise over time or venue between parties, police should help settle di matter through consultations.
- Section 95(2) prohibit use of govment resources, wey include govment media, to favour or disadvantage any party or candidate during election.
- Section 92(3) prohibit use of places of worship, police stations and govment offices for political campaigns or meetings.
Wetin politicians suppose do?
Barrister Aminu Abdulrasheed say if authorities violate politician rights in such situation, di main option available na to go court, even though di case fit no finish bifor election period end.
However, e explain say politicians fit seek emergency relief from di court bifor time run out.
"Dem fit go court ask for injunction, called an Order of Mandamus, to compel anybodi wey get legal obligation to perform duty to carry out dat responsibility," di barrister tok.
E add say politicians fit also seek compensation for wetin happun to dem, even afta di incident don occur, so dat pipo wey violate dia rights fit answer for am.
Why govments dey deny opposition party venue?
Barrister Aminu Abdulrasheed believe say govments wey dey take such actions dey do am bicos dem fear say members of di public fit support opposition parties.
For some situations, e say state govment fit fear losing support from federal authorities and diafor deny opposition parties campaign venues so dat e no go look like say dem allow opposition groups operate freely for dia states.
Di barrister express concern about di possibility of dis practice wey dey spread, tok say di action go against democracy and di constitution, and fit threaten di survival of democratic governance.




















