South Africa mourn death of first female deputy president Phumzile Mlambo-Ngcuka wey die afta medical complications

Wia dis foto come from, Sharon Seretlo/Gallo Images via Getty Images
Tributes don dey pour in for South Africa first female deputy president, Phumzile Mlambo-Ngcuka, wey also serve UN under-secretary-general and Executive Director of UN Women, wey die at di age of 71.
Tok-tok pesin for di family, Sipho Ngwema wey announce her death for statement on Saturday, 21 November tok say di matriarch pass away on Friday evening afta complications from one medical procedure.
"Di Ngcuka and Mlambo family dey heartbroken by di passing of dia matriarch Phumzile Mlambo-Ngcuka, former Deputy President of South Africa and former United Nations Under-Secretary-General and Executive Director of UN Women.
"She pass away for di evening of Friday, 20 November 2026, following complications from one medical procedure she bin do about two weeks ago."
Di family describe her as a "giant for South African public life and a global citizen".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
South Africa presidency wey announce her death late Saturday evening for statement also express sadness ova her passing.
Di Acting President express im condolence to di Mlambo-Ngcuka family on behalf of President Cyril Ramaphosa, di govment and di pipo of South Africa.
E say dem go communicate further details afta due consultation wit di family.
"Acting President Paul Mashatile dis evening learned wit shock and sadness of di passing of former Deputy President of di Republic of South Africa, and former UN Under-Secretary-General and Executive Director of UN Women, Ms Phumzile Mlambo Ngcuka," di statement read.
South Africa Parliament don also send dia condolence. For statement, di lawmakers say Dr Mlambo-Ngcuka dey among di first generation of Members of Parliament to serve for South Africa democratic Parliament, wia she chair di Portfolio Committee on Public Service and Administration.

















