Wetin be 'Ba ma yi' chants wey APC dey dey take accuse ADC and NDC

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/X
- Author, Abdullahi Bello Diginza
- Published
- Read am in 3 mins
Lack of support for politicians, wey pipo dey show through chants, na one of di tins wey dey provoke dem and increase dia fear wenever dem hear "Ba Ma Yi" chants.
Recent videos and photos don emerge wey show Nigerian politicians dey face "Ba Ma Yi" chants as dem attend public events.
One of di videos wey attract attention show di chants wey pipo direct at President Bola Tinubu for one Friday mosque for Abuja last week.
Following di incident, security forces arrest more dan 70 pipo for allegedly chanting "Ba Ma Yi" as President Tinubu dey leave di mosque.
Howeva, earlier dis week, President Tinubu order security forces to release dem.
For many cases, politicians dey accuse one anoda of planning or sponsoring di chants to reduce dia morale during election campaigns.
Nigeria ruling All Progressives Congress (APC) accuse di opposition African Democratic Congress (ADC) and National Democratic Congress (NDC) parties of sponsoring such chants.
For one statement wey di party presidential campaign spokesman, Dele Alake, release, e accuse opposition parties of sponsoring pipo to chant against am during election campaign.
Alake also call on opposition party leaders to stop wetin e describe as putting young pipo lives in danger.
Wetin 'Ba ma yi' mean?
"Ba Ma Yi" na one phrase wey pipo dey use to show say dem no approve of or support di person wey dem direct am at.
Professor Kamilu Sani Fagge, lecturer for di Department of Political Science at Bayero University, Kano, and Nigerian political affairs analyst, say na Hausa phrase wey mean "we no support you politically".
E add say, for politics, 'Ba Ma Yi' mean political tactic or position wey individual or political group fit use to show say dem no go support di pesin wey di chant dey directed at.
"Wen pipo dey shout 'Ba Ma Yi! Ba Ma Yi!' for politician during public event or political rally, e fit be sign of public disapproval of di politician or im policies," di political analyst tok.
Professor Kamilu say for political analysis, dem dey call dis voter rebellion.
"Na sign say voters no dey di side of di pesin wey dem dey chant against," e tok.
E add say dis way of showing disapproval for politicians no be new tin for Nigeria.
"Politicians face dis kain tin during di First and Second Republics, so no be di first time wey pipo dey use dis method," e add.
Wetin ADC and NDC tok
Di ADC and NDC parties don deny di allegations and distance diasef from claims say na dem organise di "Ba Ma Yi" chants wey pipo direct at APC President Tinubu.
Di parties say na pipo wey no happy wit di policies and actions of di Tinubu administration dey behind di chants.
One of ADC tok tok pesin, Faisal Kabir, say di protesters dey chant sake of di hardship wey dem dey face as result of di policies of President Tinubu and APC.
Speaking to BBC, Faisal Kabir say hunger, poverty and di difficult living conditions wey pipo dey face na im make dem begin chant such slogans.
"Pipo no fit kontinu to endure life under these conditions, na why dem dey do am. But we no get any involvement for di matter," e tok.
E add: "We get notin to do wit di chants wey pipo dey direct at dem."
Di opposition NDC also distance itself from di incident through im presidential campaign committee director, Ibrahim Hussaini Abdulkarim.
"Opposition parties no get hand for dis matter. Na pipo wey dey suffer under APC administration. If di govment do wetin pipo expect from am, nobodi for dey chant against dem," e tok.
E accuse di Tinubu administration wey e say implement policies wey don bring hardship to Nigerians, tok say na why pipo dey chant against di president.
"Connection no dey between di opposition parties and di chants wey pipo dey direct at Tinubu and APC. Na matter between dem and di ordinary pipo wey vote for dem," e tok.
How di "Ba Ma Yi" chants fit afftect politicians?
Professor Fagge say no doubt say di chants get effect on di politicians wey dem dey directed at.
"Politicians dey always see dis as sign say pipo no dey dia side again," e tok.
E add say wen eva politician face such chants, di politician suppose take time tink about why pipo dey express dia disapproval and consider making changes.
"Dis also dey show politicians say dem no fit automatically win election, especially for di area wey people dey chant against dem," Professor Fagge tok.
Di political analyst say any politician wey face such chants suppose learn from di experience and address di issues wey people dey accuse dem of, so dat dem no go fall into trouble on election day.


















