Exorcism: 'I dey cast out witchcraft and evil spirit from possessed pipo'

One woman hold her throat
Wetin we call dis foto, Dis na one of di process wia di healer dey pure one water wey e claim say Qur'an supplication dey inside. According to am di evil spirit dey fill am like fire on im bodi.
Published
Read am in 7 mins

For years, pipo from different communities dey travel go meet Mansur Ismail, one Islamic spiritual healing practitioner wey dey known as Ruqya, wit hope to find relief from conditions wey dem believe say get connection wit jinn possession, witchcraft or oda spiritual wahala.

Exorcism, wey pipo also sabi as Ruqya, na Islamic practice wey involve reciting verses from di Quran and prophetic supplications to seek protection, healing and relief from spiritual harm.

Dis kain practice don tey even for Nigeria wia pipo wey believe say, e dey possible to dey possessed by evil spirit, wey Muslim pipo sabi as jinn.

For Mansur wey dey for Makarfi local govment area of Kaduna state, e tok say im journey into dis practice bin start from house.

According to Mansur, "Many pipo across Nigeria and beyond dey come my place to seek for care for spiritual harm."

BBC News Pidgin follow am tok on how e take dey heal pipo wey dey seek protection from spiritual harm.

How Isma'il take start practice exorcism (Ruqya)

Dis na di first step wia di healer dey summon di evil spirit wey possess di bodi of di patient

According to am, wen e dey grow up for Almajiri household for northern Nigeria, e watch as im father take dey help pipo wey dey in distress, e inspire am to kontinu di work.

"Di first reason why I choose dis work na bicos I grow up for Almajiri household, and I grow up dey watch wetin my papa dey do," e tok.

"Pipo go bring patients wey dia condition bad well-well, to di extent say once you look dem, you go know say dem dey suffer serious problem.

"Through di help wey e dey provide, and wit Allah's help, pipo go recover."

E say to dey see pipo return healthy afta treatment and express dia gratitude, leave impression on am and wetin motivate am be dat.

Oga Ismail dey perform Ruqyah  for one of im patient and two men siddon for ground
Wetin we call dis foto, Oga Ismail dey perform Ruqyah for one of im patient

E add say im approach also extend to cases wey patients attribute to witchcraft.

"Some pipo dey, wey dey practise witchcraft and use am to harm members of di community," e tok.

According to am, for im Ruqya dem fit identify spiritual affliction wey link to witchcraft and address dem through Quranic recitation.

"Wetin make our Ruqya different from odas na say, first of all, wen witchcraft affect somebody, through di gift wey Allah give us, we dey approach am in one special way," e talk.

"You see, no be evribodi wey dey perform Ruqya fit do dis. As far as I know, na only pipo wey Allah don bless with dis knowledge fit do am."

Claims about witchcraft and spiritual afflictions na mata of religious belief and dem neva verify am scientifically.

One patient during di time wey di healer dey perform Ruqiyya

According to am, many patients dey come in bad condition wey fit make pesin sick well-well.

Sometimes, dem dey tell dem say dem dey experience headache, fear and dey always have bad dreams.

E tok say wen dem believe say patient dey suffer from jinn possession, dem dey use Quranic verses to try remove di spirit.

"If dem bring somebodi come wit problem wey involve Jinn, we dey use Quran and im verses to remove di Jinn," e tok.

E add say even illnesses wey dem no believe say Jinn cause, dem still dey recite Quranic verses as prayers for healing.

"Bicos of di hidden power wey Allah put inside di Quran, we dey use di verses wey Allah reveal for Quran to pray for di patient and ask Allah to remove dia suffering."

Di healer say im belief in di practice get root for Islam.

"Ruqya get place and recognition for Islam, and religion get provisions for am," e tok.

E add say "Evri Muslim believe in Quran.

"And evri illness wey Allah send down get im cure for Quran."

Wen dem ask am how e take know weda treatment work, Ismail say practitioners dey look for changes in di patient condition.

"Afta we don perform di Ruqya and finish evritin, di first tin na to give di pesin chance to walk."

E say dem dey ask patients weda dem still dey feel pain or discomfort.

"If di pesin say e no dey feel pain for any part of im bodi again, dat na our first sign say di Jinn don leave im bodi and any witchcraft wey affect am don also disappear."

Videos of Ruqya sessions dey show several pipo dey hold patient during treatment.

E say dem dey do am for safety reasons.

"We dey hold di patient bicos if we leave am, di Jinn inside im bodi fit harm am," e tlk.

"When Qur'an dey recited and we dey pure water wey we recite Quran inside, over Jinn posses bodi, e dey suffer. E be like say dem dey sprinkle fire for am."

E say some patients dey struggle seriously during sessions and dem fit injure demsef if nobodi hold dem.

"When we hold di person, e allow us carry out di treatment properly and safely."

Wen dem ask am how e take know weda patient need medical attention wey dey beyond im practice.

E tok say Ruqya focus on spiritual healing, Ismail say some cases dey wey e no dey handle.

"Pipo wey come wit conditions wey look like say dem relate to our work, but afta we assess dem, we realise say di cases no be for us to handle, we no work on dem" e tok.

"For example, person fit need fluids for im bodi or somebodi wey need blood transfusion."

For dat kain situations, e say dem dey direct patients go hospital.

"Wen case pass our area of work, we dey refer di person straight to hospital."

Despite widespread belief say spiritual healing centres get fixed fees, Ismail say charges dey different and some patients dey receive treatment free of charge.

"Some cases dey wey we no charge even five naira from di patient," e tok.

"We go take responsibility for di treatment and even provide transport money make di person return home."

E add: "We no get one fixed amount wey evribodi must pay weneva dem come for treatment."

'I come becos of my headaches and bad dreams'

One woman Rayya Ashiru wey seek treatment from Mansur say she first come bicos of constant headaches, fearfulness and recurring bad dreams.

"I come bicos of my headaches, fearfulness and di bad dreams wey I dey get," she tok.

"But now, Alhamdulillah, I no get di fearfulness, headaches or bad dreams again."

Di woman say she first suspect say somebodi spiritually harm am, decide to seek help to investigate di matter.

She say afta treatment and continued medication, her condition improve veri well.

"Dem carry out di treatment, and now my bodi don return to normal," she tok.

"Sake of say di treatment wey dem do, I don recover very well."

Wetin Islam tok about Ruqya (Exorcism)?

Exorcism, wey pipo also sabi as ruqyah, na Islamic practice wey involve reciting verses from di Quran and prophetic supplications to seek protection, healing and relief from spiritual harm.

Islamic scholar Sheikh Mustapha Umar, wey dey Sokoto State, tell BBC News Pidgin say Ruqya dey allowed for Islam, as long as na through reading of Qur'an dem dey do am.

"Ruqya wey dem dey do through reading of Qur'an dey allowed, as long as dem no do anytim wey Islam no permit.

"Pesin fit use reading of Qur'an to remove jinn wey don possess somebodi" e tok.

Wen dem ask am about di water wey dem see di cleric dey pour on pesin wey dey suffer from alleged jinn possession, e say:

"If na Qur'an dem read for di water wey dem dey pour on pesin wey jinn don possess, den no wahala. But if dem do anytin wey go against di teachings of Islam, den di Ruqiyya don bicom sometin different, and e no dey valid for Islam."

According to am, di water wey dem write Qur'anic verses on and sprinkle, wey jinn.