Who be Faisal Maina wey court sentence to seven years in prison

Man dey look camera
Published
Read am in 5 mins

Di Federal High Court for Abuja don order make dem carry Faisal Maina, son of former pension reform boss Abdulrasheed Maina, go correctional centre to serve im seven-year prison sentence.

Di judge give di order afta e grant one ex parte application wey Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) file.

Di commission bin ask di court to issue warrant wey go commit Faisal to Nigeria Correctional Service (NCoS) to enforce im conviction for money laundering and failure to fully declare im assets for asset declaration form.

Department of State Services (DSS) arrest Faisal on October 14, 2026, for Karsana area of Abuja, about six years afta e jump bail and stop to attend court proceedings.

For di application, EFCC also ask di court to order say im prison sentence suppose start from October 14, di date wey dem arrest am again.

For October 2021, One federal high court for Abuja don sentence Faisal, di son of Abdulrasheed Maina, former chairman of defunct Pension Reform Taskforce Team, to 14 years for prison.

Justice Okon Abang na im sama di sentence on Thursday, 7 October, 2021.

Faisal dey go jail sake of money laundering and false declaration of assets.

Im bin dey convicted of 3-count charge.

Who be Faisal Abdulrasheed Maina?

Faisal Maina na son of Abdulrasheed Maina, former chairman of Nigeria Pension Reform Task Team.

Im papa, Abdulrasheed Maina, don attract public attention bicos dem link am to one corruption case wey involve pension reform funds.

Im papa, Abdulrasheed Maina, receive eight years prison sentence for Kuje Correctional Centre, Abuja, for laundering N2 billion pension funds.

Dem release am earlier for 2026, and since den, dem dey look for am over suspicion say e receive stolen property.

Wetin be di charges against am?

For October 2019, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) arraign Faisal before Justice Okon Abang for Federal High Court, Abuja, on three charges wey concern money laundering and failure to fully disclose im assets for asset declaration form.

On October 7, 2021, Justice Okon Abang of Federal High Court, Abuja, find am guilty of three money laundering charges.

Di judge sentence am to five years imprisonment on counts one and three respectively, and 14 years imprisonment on count two.

Di sentences suppose run concurrently, meaning say di original sentence na 14 years.

Di court find say Faisal Maina help im papa launder money through one fraudulent account wey dem call "Alhaji Faisal Farm 2", for United Bank for Africa (UBA).

Di money wey involve na 58.1 million naira, and e and im papa withdraw di money in batches between October 2013 and June 2019.

Di court say e suppose know say di money come from im papa corruption activities.

Di court also order make dem dissolve di company wey involve, "Alhaji Faisal Farm 2", confiscate di money wey dey inside di account, and direct say if dem find Faisal inside di kontri, dem suppose arrest am and take am to correctional centre. If dem find am outside Nigeria, dem suppose start extradition proceedings.

For November 2022, Court of Appeal uphold Faisal Maina conviction, but reduce im sentence from 14 years to seven years because e be first-time offender and di trial court no suppose give am di maximum sentence.

When di court reduce di sentence, Faisal Maina still dey at large, and dem no fit immediately enforce di seven-year prison sentence.

For October 2026, Nigeria Department of State Services arrest Faisal Maina afta intelligence report indicate say e don secretly return to Nigeria before den.

Who be Faisal papa and wetin be charges against am?

Dem born Abdulrasheed Maina for im village for Biu Local goment area of Borno state of Nigeria. Dem born am around 1950.

Abdulrasheed Maina marry Laila Maina and dem get pikin and one of dem, Faisal Maina don chop 14 years prison sentence ontop accuse of money laundering.

Before Maina become di oga of Pension Reform Task Team, Maina serve as senior administrator for Customs, Immigration, and Prison Pensions Office (CIPPO) for years.

For 2010, dem come appoint am as di chairman of PRTT (Pension Reform Task Team) and e head di task team from 2010 to 2013.

For November 2021, di Federal High Court, Abuja sentence Maina, to eight years in prison afta dem find am guilty of money laundering charges.

Di trial judge, Okon Abang, wey deliver di judgement on Monday say Mr Maina tiff over N2 billion Pensioners moni.

Di court say di prosecutor, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring correct evidence through witnesses to prove beyond reasonable doubt say Maina dey guilty of money laundering in di sum of N171,099,000.

Di Court say Maina dey guilty of asking staff of Fidelity Bank to open bank accounts for am without conducting any due diligence.

Di court also say e dey guilty sake of say e hide im identity as signatory to accounts wey im open for UBA and Fidelity bank wit di identity of im family members without dia knowledge.

For October 2019, Federal High Court pass order on say make former pension chairman, Maina go collect self contain for prison.

EFCC bin cari former oga pension go court dat time ontop 12 count charge but afta court read di charges give oga Maina e say im no dey guilty.

EFCC carry Maina and im son go court for N100bn magomago accuse

On Tuesday 22 October, 2019 Justice Folasade Giwa-Ogunbanjo of di Federal High Court bin order Maina to surrender 23 landed properti wey dem trace to am.

Some of di properti na houses, estates and companies wey dey Abuja, Kaduna, Borno and Nasarawa states.

Meanwhile im son, Faisal Maina plead not guilty to di three count charge wey border on money laundering.

Di presiding judge, Justice Okon Abang as dem to take am go lock for Police Tactical Squad pending wen im trial go start.

For 2020, Maina collapse for court.