Kenya confam first death from Ebola as outbreak spread for di kontri

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Kenya don confam dia first ever case of Ebola for di body of one Kenyan citizen wey bin dey live for di Democratic Republic of Congo for di past seven years.
Health Minister Aden Duale tok say di patient, wey fall sick one month ago, and wey dem don treat for several hospitals for DR Congo, die days afta e land Nairobi.
Duale explain say di patient bin board one flight on Saturday and e go through normal public screening for di main airport for Nairobi, bifor one of im relative transfer am go one hospital for di city.
More dan 4,000 pipo don die from Ebola for DR Congo dis year, for inside wetin be di second-deadliest known outbreak of di disease.
Shortly afta DR Congo bin declare Ebola outbreak for May, dem also report di disease for Uganda, wia two pipo die.
However, di World Health Organization (WHO) bin declare di kontri free from di disease for August.
Since den, dem dey report all di cases of di disease for DR Congo.
Di current outbreak come from di Bundibugyo species of Ebola, wey no too common and currently no get any known vaccine.
End of Di one wey oda users dey read well well
Duale confam say di Kenyan citizen test positive for di Bundibugyo species.
According to di minister, di patient bin first travel by road from DR Congo go Uganda capital, Kampala, wia e board flight go Nairobi.
Duale say afta dem carry di patient go Nairobi Hospital, dem later transfer am go one isolation facility wey dem build during di Covid-19 period.
Na dia di patient "develop fever, chills, serious tiredness and weakness, painful swallowing, muscle pain and bleeding under di skin".
"Doctors suspect viral haemorrhagic fever based on im symptoms and travel history and collect samples for testing. Di sample test positive for Ebola Bundibugyo virus," Duale tok.
Di patient die at 23:30 (20:30 GMT) on Monday and dem plan to bury am later on Tuesday according to public health safety protocols.
At least 28 contacts, including family members and healthcare workers, don dey identified, while health authorities dey trace anoda 23 passengers and four crew members wey travel on di same flight.
So far, WHO don record 4,082 deaths out of 8,463 cases since di emergence of di Bundibugyo species of di virus.
Currently, no approved vaccine or treatment dey for di species, wey dey highly infectious.
Medical charity MSF believe say di current toll fit even dey higher becos of gaps of surveillance and testing for di war-torn kontri.
On Monday, MSF bin say di virus dey spread "like megafire", wit new hotspots wey dey emerge from North Kivu province, wey border Ituri where the virus began.
























