Nigerian Air Force release names of crew members and passengers wey die for Ondo State plane crash

Aircraft
Published
Read am in 4 mins

Di Nigerian Air Force don release di names of five crew members and 20 passengers wey lost dia lives for di 931 aircraft accident wey happun for Igbokoda area of Ondo State, southwest Nigeria on Monday, 5 October.

Di Air Force for inside one statement on Tuesday wey dia tok-tok pesin Air Commodore Ehimen Ejodame issue on Tuesday tok say dem neva see any survivors from di ATR 42 aircraft, NAF 931 wey crash near one naval base area for di state.

Di statement say di aircraft bin dey on one routine mission from Benin to Lagos wen di accident occur.

"Dem immediately activate search-and-rescue procedures, wit response efforts in coordination wit relevant authorities to locate and account for all persons on board. No survivors have been found," NAF tok for di statement.

Although, di cause of di accident neva dey clear, however, di Chief of di Air Staff (CAS), Air Marshal Sunday Kelvin Aneke wey describe di incident as "painful moment for di Nigerian Air Force and di nation", tok say im don direct comprehensive investigation to establish di circumstances wey surround di accident.

E also assure families of di victims of di service full support during dis difficult period.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Who be di victims

Crew

1. Squadron Leader MI Aburime - (Flight Captain)

2. Squadron Leader AP Man-Ugwueje - (Co-pilot)

3. Flight Lieutenant IS Bako - (Co-pilot)

4. Warrant Officer Abubakar A - (Aircraft Technician)

5. Corporal Uguru HC - (Aircraft Technician)

Passengers

6. Flight Lieutenant - TL Lazarus

7. Flight Lieutenant - M Akinloye

8. Flying Officer IM - Adeshina

9. Master Warrant Officer - Onwuka F

10. Master Warrant Officer - Matini BA

11. Warrant Officer - Nuhu FS

12. Flight Sergeant - James RB

13. Flight Sergeant - Mohammed AI

14. Sergeant - Ani AE

15. Sergeant - Izibenikien SI

16. Sergeant - Alafuka C

17. Sergeant Mbadugha - AN

18. Lance Corporal - Ugwuba FC

19. Lance Corporal - Eledan GE

20. Ezeh Nneka

21. Godstmine Tarabina

22. Joy Micheal

23. Sunday Micheal

24. Ukeme David

25. Gideon Omotola

Map

Earlier, di presidency bin tok say na 32 pipo die on board di aircraft.

According to di Aviation Minister Festus Keyamo, preliminary information suggest say na 25 passengers and 7 crew members bin dey on board di aircraft.

E add say even though di control and regulation of military aircraft dey completely outside di authority of di Ministry of Aviation, and Civil Aviation Authority, di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke don pledge dia total cooperation and assistance for di search and rescue efforts wey dey go on.

Di crashed plane, wey authorities describe as ATR-42 aircraft, dey carry between 30 and 50 passengers, according to dia manufacturers.

Di Nigerian Air Force dey play ogbonge role for di kontri military operations, wey include efforts to tackle armed groups and insecurity for several parts of di kontri.

Nigerians mourn death of fallen heroes

Nigerians dey mourn di death of di 25 pipo wey die inside one military aircraft crash.

Di Chief of di Air Staff (CAS), Air Marshal Sunday Kelvin Aneke, tok sorry to di families of di personnel and passengers wey lost dia lives for di accident wey involve di Nigerian Air Force (NAF) ATR 42 aircraft, NAF 931, for Igbokoda area of Ondo State.

CAS bin describe di incident as deeply painful moment for di Nigerian Air Force plus di nation.

E express sympathies to di families, loved ones and colleagues of dos wey lost dia lives, as e assure di bereaved families of service support during dis difficult period.

"Dis na is painful moment for our Armed Forces and for di entire nation," Tinubu tok.

"Our Air Force personnel put dia lives on di line evri day to secure Nigeria. We no go forget dia sacrifice" im add.

"Di scale and circumstances of dis tragedy dey heartbreaking. Among dos wey lost dia lives na airmen, sojas plus members of dia families. Lives of service, promise and innocence just end for one devastating moment," Nigerian politician Atiku Abubakar tok.

Di US also send dia deepest condolences to di families, friends, and colleagues of pipo wey die for di Nigerian Air Force crash. "We stand wit di pipo of Nigeria and remain committed to our strong security partnership," US Mission Nigeria tok for X.

Saudi Arabia Embassy for Nigeria for inside one statement tok say dem stand gidigba wit di families of di deceased plus di govment and pipo of Nigeria.