Tears flow as family, friends, lay Ghanaian Javitz Frimpong wey dem murder for US to rest

Collage of Javitz Frimpong and  casket dem use bury am
Published
Read am in 5 mins

Family, friends, and authorities don gada to pay tribute to di late 15-year-old Javitz Frimpong, wey die afta some teenagers shoot am near im school for Bronx for di US.

Wit dia black and red cloth, dem mourn di late teenager wit painful tears.

New York Mayor Zohran Mamdani, Ghana govment officials join hundreds of mourners for di New Covenant Christian Ministries for Bronx to file past di body and pay dia last respect.

Im death shock di world afta viral video show how di suspects pursue di Ghanaian boy bifor dem shoot am dat day for Crotona Park.

Im papa Thomas Frimpong emotional interview afta di death of im son, touch many pipo wey begin di movement to demand justice for di teenager.

Since then, Ghanaians and oda Africans for Bronx don hold vigils and oda events for di area of di incident as dem dey demand justice for di late Javitz.

Di case raise di issue of gun-violence and bullying of immigrants for schools and communities for America all ova again.

Wetin happun for court wen di suspect appear?

Di Ghanaian community join hands to send off di late teenager
Wetin we call dis foto, Di family dey demand justice for dia own

Lawyer for di family of di 15-year-old deceased Ghanaian Javitz Frimpong tok afta di first court appearance say dem go continue to pursue justice.

Ben Crump confam say "di judge for Bronx bin rule say dem go try di 17-year-old suspect as adult. Im case no go happun for family court."

Di 17-year-old suspect, Thierno Jalloh dey faces three charges – murder, manslaughter and two counts of criminal possession of weapon.

Prosecutors allege say di suspect bin hold di gun wey im fire am.

"Di Bronx District Attorney Officer tok say di 17-year-old for custody both hold and fire di weapon. Prosectors tok say Jalloh na di second pesin wey shoot di gun at Javitz, even though no be im shot wey finally kill di Ghanaian teenager," Ben Crump explain.

Dem bin play video evidence of how di shooting happun for court.

Javitz family lawyer Ben Crump tok say "Javitz im mama and papa no fit watch di video of how di suspects kill dia son, when dem play am inside di court. Na so dem waka comot."

One Ghanaian journalist wey bin sit for di court hearing explain wetin e see inside di video.

George Kwaning tell BBC Pidgin say di video show di moment di suspect reach di flat of di deceased Javitz and survey di area bifor e meet wit di oda suspects wey pursue di 15-year-old.

"Some Ghanaians for Bronx wey dey court to support di family even cry wen dem show di video. Na very sad and emotional one for everybodi inside di courtroom."

Javitz auntie tell local media network TV3 reporter say "We just hope for justice for Javitz, e neva be easy for us as family, but we dey happy say dem find at least one of di suspects. We dey pray say justice go prevail."

"I bin just dey cry wen I watch di video for di court – I just dey imagine how young children like dat go fit do dis kain tin, na very emotional tin. We dey pray say dis bad tins go stop."

Di next date for di court appearance na 21 December.

Who be di late Javitz Frimpong

Javitz na 10th grade student for di Dream Yard Preparatory School for Bronx bifor di incident.

E enta di US from Ghana for October 2025 to stay wit im papa; im dream na to bicom medical doctor wen e grow.

Bifor Javitz enta di US, e be student for Adisadel College for Ghana, wia im complete two terms.

For di morning of 29 October 2026, some young pipo bin chase and shoot am near East 171st and Crotona Place as im dey waka to school.

Im papa believe say di shooting dey connected to bullying wey im suffer for school. Thomas Frimpong say im report di bullying mata to di principal of di school and e suspend some of di students wey allegedly bin dey bully Javitz.

New York police arrest 17-year-old suspect, and dem still dey find di oda pipo wey togeda shoot di 15-year-old dat day.

Old students for di Adisadel College for Ghana and oda places bin pay tribute to one of dia own, as dem add dia voice to demand justice.

Fotos from di burial

Ghana authorities say dem go pursue justice
Wetin we call dis foto, Mourners dey file past di remains of di late teenager
this is not the first case of alleged bullying and death resulting from gun-violence
Wetin we call dis foto, Di immigrant community for Bronx dey demand solution to gun-violence