Authorities confam release of US missionary pilot from Niger Republic

Di National Assembly building of Niger Republic

Wia dis foto come from, SIA KAMBOU/AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

United States authorities don confam say kidnappers don release American missionary pilot, Kevin Rideout, wey dem kidnap for Niger capital Niamey for October last year and e go soon land for US.

Rideout na evangelical Christian wey dey work for one charity organisation wey dem dey call Serving In Mission (SIM). Dem kidnap am outside im house for Niger capital, Niamey, for October 2025.

Rideout dey in good health based on di proof-of-life fotos wey dem bin send give US officials in di last 48 hours.

SIM International announce di good news, as dem describe am as 'incredibly good news' afta months of uncertainty about di missionary wellbeing.

'We dey so grateful to fit confam say dem don release our good friend and brother in Christ, Kevin Rideout, afta ova nine months for captivity,' di charity organisation tok inside dia statement.

SIM tok say Mr Rideout dey good health and e go soon meet im wife, Krista, children, and family.

Dis mark di end to long ordeal for Rideout family, and also for di Christian groups and US authorities. For more dan nine months, dem no know wetin dey happun to Mr. Rideout - except say kidnappers don hold am captive.

Im family don dey wait for news about im whereabout wit anxiety as dem believe say im dey for one of di most dangerous areas for di world.

According to SIM, many pipo don dey pray for Rideout and dem don send messages of solidarity and hope all through im time for captivity.

"Krista and di rest of Kevin family dey grateful for di prayers wey pipo from evriwia don offer on dia behalf as im dey for captivity," SIM tok.

For October, Reuters bin report say three armed men carry out di kidnapping, dem carry Rideout comot from im house for di capital Niamey bifor dem carry am go western region of Tillaberi, dat area na hotbed wia militants dey operate.

Local reports gada say e fit be militants wey belong to Jama'at Nusrat al-Islam wal-Muslimin (JNIM), wey be al-Qaeda affiliate carry Rideout go. Islamist militant groups wey dey operate from neighbouring Nigeria, Mali, and Burkina Faso don dey disturb Niger for years, dem dey target both civilians and military.

Di region don witness many wave of violence as jihadists don dey fight govment security forces aa well as Western and oda allied troops.

Days afta di kidnapping, US warn dia citizens say make dem no travel go Niger becos of "increased risk of terrorism, crime, and civil unrest." Later on, e kon be like say di kidnappers carry Rideout go anoda kontri.

E neva clear weda na JNIM, wey dey linked to al-Qaeda group, one of di most dangerous jihadist group for di area kidnap Rideout.

Di release of di American missionary dey happun at di time wey several kontris for West Africa and di Sahel dey struggle wit insecurity.

Niger, togeda wit Mali and Burkina Faso, including Nigeria, dey deal wit violence wey don dey happun for more dan ten years - e don cause di loss of thousands of lives and massive regional destabilisation.

Di Sahel nations don also witness wave of military takeovers, as di military govment don overthrown di democratic govments to form dia own govment.

Afta more dan nine months wey dem hold am hostage for one of di deadliest regions for Africa, Kevin Rideout go finally go home. For now, e be like say im release don give some relief to im family, friends, and colleagues.