South Africa anti-immigration group give anoda deadline for illegal immigrants to leave, protest outside SADC summit for Durban

this new action comes as authorities say they have deported at least 100,000 undocumented foreigners

Wia dis foto come from, PER-ANDERS PETTERSSON/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di March and March movement say dis fresh deadline na for leaders to 'fetch dia pipo' from South Africa
Published
Read am in 5 mins

Anti-immigration group for South Africa March and March don give anoda deadline for dia govment to sack all illegal foreigners.

Dis dey happun two months afta dia 30 June deadline for foreigners to comot for dia kontri sake of dem say di foreigners don collect dia jobs, dia women and dia businesses.

Di March and March group wey bin dey lead dis protests since early April bin threaten dia own govment ova di way dem dey handle di illegal immigration wahala.

For di 30 June nationwide protests, di group togeda wit oda vigilantes march across di streets. Dem ask foreigners wey bin dey occupy some buildings to comot, wey dem warn say dem go continue to protest evri Thursday until dia govment fix di immigration kasala.

Di govment bin spend about R600 ($35m) for security operation for di nationwide 30 June protests, even though pipo bin bash di govment for dis expenditure.

Some members of parliament bin no gree wit di allocation wen di govment bin announce am at dat time wey some argue say dem fit use dat money for development project for di rainbow kontri.

Authorities say since dem begin to enforce dia immigration laws, dem don deport ova 100,000 undocumented foreigners, wey dem dey tighten dia borders.

But di anti-immigration groups and vigilantes say di govment gatz do more.

South Africa president don apologise for some of di attacks on foreigner by di protesters

Wia dis foto come from, EMMANUEL CROSET/AFP VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Police say di 30 June nationwide protests dey largely peaceful but some protesters attack pipo and loot some shops

South Africa President Cyril Ramaphosa for 15 August ahead of di Southern African Development Community (SADC) summit for Durban, bin apologise for di attacks against some foreign nationals by vigilantes during dia protests and oda campaigns.

"We don dey deeply ashamed say pipo from oda kontris suffer bad treatment, wey dem force odas to comot di kontri sake of threat of violence," di president tok.

Im add say "we no fit preach integration for summit like dis and practice exclusion for di streets of our kontris".

Many kontris don bash South Africa for di way dem handle di mata, wey cause many of dem to evacuate dia citizens.

Some African citizens bin suffer attacks at di hands of South Africans and oda vigilantes, wey some don even die.

Police say dem dey investigate di deaths of Ghanaians, Nigerians and oda African citizens, but dem neva present any findings or report since den.

Ghana, Nigeria, Mozambique, Zambia, Kenya, Ethiopia and odas don repatriate hundreds and thousands of dia citizens from di rainbow kontri since April.

But di anti-immigration groups say di govment no dey do enough, na so dem don announce fresh wave of protests.

Anti-immigration protesters dey gada SADC summit to tell foreign leaders say 'time don reach to fetch your pipo'

Many countries have evacuated their citizens from south africa since april

Wia dis foto come from, PER-ANDERS PETTERSSON/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, "We dey announce di second wave of di 30 June National Day of Action and call on di heads of state to prepare for massive deportation of all illegal foreigners for South Africa by 30 September wiey go be di mama of all protest"

Di March and March movement don announce 30 September as di fresh deadline for undocumented foreigners to comot for di kontri.

Dem say dem go repeat di 30 June nationwide protest - dis time, di theme na for Africa kontri leaders to "fetch dia pipo".

Inside one statement, March and March say dem go gada outside di SADC summit auditorium during di event on Monday.

"We dey announce di second wave of di 30 June National Day of Action and call on di heads of state to prepare for massive deportation of all illegal foreigners for South Africa by 30 September wey go be di mama of all protest."

Dem add say, "South Africans gatz follow di law and remain di eyes and ears of di police against any illegal foreigners for di kontri."

Di 46th Ordinary SADC Summit of Heads of State and Government dey happun for di Inkosi Albert Luthuli International Convention Centre for Durban.

President Cyril Ramaphosa dey expected to become di SADC chairman for di 2026 and 2027 term.

Leaders for di 16 member states for SADC dey gada for di meeting - including kontris wey already evacuate dia citizens from di rainbow kontri during di tension.

Di Southern African Development Community (SADC) get kontris like Namibia, Mozambique, Mautritius, Zambia, Tanzania and Angola.

Di odas na Botswana, Malawi, Comoros, DR Congo, Eswatini, Madagascar, Seychelles, Zimbabwe, Lesotho and South Africa.