Why US end Temporary Protected Status for four African kontris

Foto of US President, Donald Trump

Wia dis foto come from, Samuel Corum/Getty Images)

Wetin we call dis foto, Foto of US President, Donald Trump
Published
Read am in 4 mins

Di Trump administration don end di Temporary Protected Status (TPS) for some African kontris and odas for di world.

Dem end TPS as part of di temporary humanitarian programme wey bin allow eligible nationals of some kontris for di world to remain for di US until wen dia kontri dey good and safe for dem to go back.

Dis na for citizens of dis kontris wey dey live for di United States and na part of di rollback of di humanitarian immigration programme.

US for statement say di TPS for South Sudan suppose end on 5 January, 2026 but court give order say make dem neva end am.

"For citizens of South Sudan, di Temporary Protected Status (TPS) and related benefits bin suppose end on Jan. 5, 2026. However, on Dec. 30, 2025, di U.S. District Court for di District of Massachusetts give order wey stay di TPS South Sudan termination. African Communities Togeda et al. v. Noem et al., No. 25-cv-13939-PBS (D. Mass.)."

Di conditions wey di kontris wey dey under di TPS programme get include armed conflict, natural disasters or oda extraordinary circumstances.

No be only to just get dis circumstances, e must no also dey safe for dem to return. E no dey give permanent residency and no be road to become US citizen.

Di kontris wey im end di temporary protected status for Africa include Cameroon, Ethiopia, Somalia and South Sudan.

Somalia dey among di latest kontris wey Trump administration dey end dia temporary protected status.

Wetin e mean for citizens of dis kontris wey dey US already

For pipo wey dey affected, if dem no get anoda valid immigration status, e fit mean say US govment fit deport dem anytime and dia protection from deportation don end.

Dem fit lose dia employment authorisation too as e fit affect dia work but di end of TPS no mean say di US go automatically deport di pesin.

Pipo wey no go dey affected na di ones wey get anoda lawful immigration status, or dem bin don already apply for anoda form of protection wey neva dey approved or wey dem neva know dia status yet.

Anoda set of pipo na di ones wey get anoda legal reason to stay for di kontri except South Sudan.

Di US make am clear say even though TPS for South Sudan don end , dia citizens for US fit still retain dia jobs.

"TPS South Sudan beneficiaries go keep dia status and employment authorization, and dia documentation go remain valid, per di court order. Forms I-766, Employment Authorization Documents (EADs) wit category A12 or C19 remain valid and dem dey extended.

Di extension na limited relief until di lower courts align wit di U.S. Supreme Court favorable decision for Mullin v. Doe, 609 U.S. ____ (2026), wey dem bin issue on June 25, 2026."

Full list of affected kontris

Haiti

Syria

Yemen

Afghanistan

Cameroon

Honduras

Nicaragua

Venezuela

South Sudan

Myanmar

Somalia.

Wetin be Temporary Protected Status (TPS)

Under di Immigration and Nationality Act of di United States of America, di Secretary of Homeland Security get authority to consult wit oda govment agencies and designate a foreign kontri for di temporary protected status (TPS) if di kontri meet some conditions.

For di TPS period, di beneficiaries dey eligible to stay for US witout deportation, and dem fit also get work permit as long as dem continue to dey meet di requirements of TPS.

Dem bin first designate Cameroon for TPS for June 2022, for a period of 18 months, sake of di armed conflict wey dey go on for di kontri wey bin prevent citizens of di kontri to return dia safely.

Afta di first 18 months end, di US govment bin extend di TPS period to anoda 18 months wey suppose end by 7 June, 2025.

E bin happun afta one US federal Judge approve make di Trump administration remove temporary protected status for about 8,000 Cameroon citizens wey dey live for di United States of America.

Di ruling dat time bin also affect about 14,600 Afghanistan citizens wey run to di US for safety sake of di war for dia kontri, according to tori by Reuters.

Temporary protected status (TPS) na immigration policy wey di US dey extend to pipo wey dia kontri dey go through war or major katakata wey be threat to dia life if dem return.

Di US govment bin move to comot di TPS for Cameroonians and Afghans for April 2025 but one immigration advocacy organisation CASA bin file lawsuit against di US Department of Homeland Security to stop am.

However, one appeal panel bin rule say even though CASA bin present "a plausible claim for relief", dia evidence no dey enough to warrant di postponement of di action wey di US agency bin don plan.