Nigerian actor Ogogo make final journey home afta e battle wit cancer

Taiwo Hassan Ogogo

Wia dis foto come from, BBC, @ogogotaiwohassan/Instagram

Published
Read am in 4 mins

Nigerian actor Taiwo Hassan wey many pipo sabi as Ogogo dey make im final journey home on Monday, 24 August afta im death on Sunday, 23 August at di age of 66.

Ogogo die afta im battle wit cancer days afta im family come out to seek assistance on wia dem fit treat am.

Im colleague Jide Kosoko bin announce di death on im Instagram page afta Ogogo daughter bin break down in tears for one live wia she tok say her papa don die.

"Wit heavy hearts and profound sadness, we announce di passing of ALHAJI TAIWO HASSAN, popularly known as OGOGO, wey pass away at 3:00 p.m. today Sunday, 23rd August 2026. At 66 years," Jide Kosoko write for im Instagram page.

According to Jide Kosoko, dem go bury Ogogo for im hometown of Ilaro, Ogun State, southwest Nigeria.

E say special prayers go take place for di the Pavilion around 11am.

Afta Ogogo family bin come out to seek assistance on wia dem fit treat di ogbonge actor, Nollywood stars and feem makers for di Yoruba movie industry bin gada on Friday, 21 August, to offer special prayers for dia colleague.

One video wey ogbonge actor Yinka Quadri and Ogogo best friend post wey don bin viral, show as plenty prominent Nollywood personalities gada to pray for im recovery.

"Feem makers come togeda in heartfelt prayers for veteran Actor Alhaji Taiwo Hassan Ogogo, to seek Allah mercy, divine intervention, and complete healing and recovery for am", Yinka Quadri write for di post on Instagram.

Fotos from di burial

Nigerian actor Ogogo make final journey home today
Nigerian actor Ogogo make final journey home today
Nigerian actor Ogogo make final journey home today

Who be Taiwo Hassan?

Taiwo Hassan Ogogo

Wia dis foto come from, @ogogotaiwohassan/Instagram

Taiwo Hassan na Nollywood actor, wey dey popular for im multiple roles for di Yoruba feems.

Im don dey act for veri long time and na face wey pipo wey dey watch feem well-well fit recognise.

Ogogo, wey also dey known for im beautiful voice wen e dey chant, die at di age of 66.

E come from di family of twins. Im forefather na Taiwo, di one wey follow am na Taiwo, im papa na Taiwo and im mama give birth to twins four times.

Ogogo na di last of im parents twins wey kpai. Im parents born thirteen pikin dem wey remain three bifor im death.

Ogogo na trained boxer wey no dey hide im boxing skills.

Di actor bin battle chronic ulcer for six to seven years wey bin nearly take im life.

Im best friend na Yinka Quadri – e say no friend wey im don eva love like dis fellow actor.

'Na all of us go chop breakfast' na famous Ogogo line for one Yoruba movie wey become street slang.

Tori be say im acting career bin pass forty years and im bin act ova 300 feems for Yoruba. One of di ogbonge feems wey im act and wey blow well-well na Owo Blow wey dem release for 1996 and directed by Tade Ogidan.

Pipo also sabi Ogogo as pesin wey get action inside feems wit di way e dey act, im aura and how e dey carry imsef. Na dis im action create di Yoruba street slang, 'Action Po bi Ogogo,' wey mean 'Action Plenty like Ogogo'.