Papa leave im 7-year-old son alone on top tallest Mount Fuji to kontinue hike

Mount Fuji dey pictured from di skies wit ring of white cloud bordering di frame of di image

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem find di boy alone for di tallest mountain for Japan
    • Author, Dan Sales
  • Published
  • Read am in 3 mins

One papa don collect serious warning from police afta e bin leave im pikin on top di highest mountain for Japan for hours wit just soft drink and snack, according to tori pipo.

Di seven year old bin dey seen as e dey siddon for one bench for Mount Fuji even as e bin dey rain at about ova 2,000m (6,500ft).

Tori be say im 48 year old papa bin tell am to wait dia afta di pikin tok say e don taya bifor e continue to dey climb di mountain wit im older son.

Workers from one mountain hut find di pikin near di sixth station for one hiking route near di top and call police.

Dem find im papa for di route eighth station wey dem tok say be three hour hike away.

According to reports, di boy bin dey found alone by 07:30 local time on Thursday (22:30 GMT).

Officers bin call out im papa well-well wen e come back from wia e go come join im pikin.

According to Japan Today, one of di police officers tell di papa say "even if e mean to stop to dey climb di mountain togeda, to just leave pikin like dat no dey acceptable".

Di papa come tok sorry.

Tori be say di family bin dey waka for di Fujinomiya route, wey start from di fifth station for di mountain, dis na area wey you fit use public transport fit get.

From dia e go take like five hours to reach di peak and anoda three hours to climb down, dis informate na wetin climbing guides dey suggest.

Mount Fuji, wey dey 3,776m (12,389ft) high, don see some climbin wahala in recent years.

For July, one 99 year old woman bin dey rescued afta e try di route afta she fall and hurt her hip and back.

And last year one 27 year old university student wey go outside of official climbing season bin dey rescued twice in four days afta e bin go back to find im lost mobile phone.

Mount Fuji, na active volcao wey dey for south-west of Tokyo, and bin get World Heritage status for 2013.

Na also one of three three traditional "Holy Mountains" wey include Mount Tate and Mount Haku.

Around 200,000 pipo dey climb am evri year but for some routes dem dey limit di pipo wey fit climb per day so e no go dey overcrowded.