Death toll from Guinea rubbish landfill collapse increase to 31

Rescuers use an excavator to comb through a mountain of scattered rubbish at a major waste site in Conakry, Guinea, as local residents gather nearby. Photo: 23 August 2026

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Fears dey say di death toll fit rise further as some pipo fit still dey buried under di rubbish
    • Author, Jaroslav Lukiv
  • Published
  • Read am in 3 mins

At least 31 pipo don kpai afta mound of rubbish for one major waste site collapse ontop nearby homes for Guinea capital Conakry, di govment tok.

Anoda 22 pipo injure, including six seriously, for di city of Dar-es-Salam.

Ogbonge resources and personnel - including di military - bin dey deployed to search for survivors afta di collapse at about 02:00 local time afta heavy rain overnight, di govment add for one statement.

One woman bin tell local media say her five children bin kpai for di disaster. Fears dey say di death toll fit rise further.

Dem later see rescuers dey use excavators to search through mountain of scattered rubbish for di site as local residents gada nearby.

One eyewitness tok say dem bury plenty pipo wen di second part of di site collapse.

"Pipo try to rush come help [afta di first part collapse]... Dem dey run and climb on di refuse to see if anybody dey dia," Robert Kamano Sâa tell di Associated Press.

"Na dat time di second part collapse in three stages, e fall down. And na dat one fall ontop di pipo."

Guinea Prime Minister Mamadou Oury Bah bin visit di scene to assess di situation and oversee di search efforts.

Mamadouba Bangoura, wey lose im house for di collapse, tok say na di "loud noise" of di first wave of di rubbish, wake im and im family but e no reach dem.

"[Den] di second wave come. Na wetin push di house - and e fall," e tell Reuters news agency.

"Dem [bury] plenty pipo... E dey veri difficult to tok about am becos to see as human being dey lose dia life like dat, e dey pathetic and e dey painful."

Neighbourhood leader Lancine Sylla bin earlier tell di AFP news agency say e fear say di death toll go plenty.

"We don pull out 18 bodis wey dem take to di morgue," e tok.

Health Minister Khaïté Sall don visit di pipo wey injure for hospital, e tok say dem go get free medical care, while e assure families say govment go support dem.

Guinea don experience similar landslide kwanta bifor - 10 pipo die for di same site for 2017.

Govment don recently order pipo wey dey live close to di site to move, but many residents decide to stay.

Guinea opposition leader and former Prime Minister Cellou Dalein Diallo, wey dey exile for abroad, don call di accident "a tragedy wey dey make us dey worry".

"Dis tragedy dey more worrisome becos dem don announce di closure of di landfill dis Sunday, 23 August," e tok.

Rescue teams continue to search through di waste for oda pipo wey dey trapped under di collapsed landfill.