Russia call for foreign volunteers to join fight

Wia dis foto come from, Reuters
Russian President Vladimir Putin don call for foreign volunteers to dey allowed to fight against Ukrainian forces.
Im tok am for one Russian security council meeting, wia im say those wey wan volunteer to fight wit Russia-backed forces should be allowed to.
Russian Defence Minister Sergei Shoigu say e get 16,000 volunteers for di Middle East wey ready to fight alongside Russia-backed forces.
US officials say dis fit include Syrians wey dey skilled for urban combat.
Moscow na long-standing ally of Syria and Oga Putin don be key backer of Syrian President Bashar al-Assad for di kontri civil war.
"If you see say dis pipo dey wey want on dia own accord no be for money to come helep di pipo wey dey live for Donbas, then we need give dem wetin dem want and help dem get to di conflict zone," Oga Putin tell im defence minister.























