Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Why Russia dey attack Ukraine?

    Why Russia dey attack Ukraine?

    For months now, Russia President Vladimir Putin bin dey deny plan to attack Ukraine.

    But on Thursday 24 February, 2022 e announce a "special military operation" for di kontri Donbas region.

    Di announcement on live television bin dey followed by reports of explosions for Ukraine capital Kyiv as well as oda parts of di kontri.

    Mr Putin latest actions dey come days afta e bone peace deal and order troops inside two eastern regions wey rebels dey hold, for im own words to "maintain peace".

    Russia don deploy at least 200,000 troops near Ukraine borders in recent months, and fears dey say di latest move mark di first step of a new invasion.

    Russia for a long time don stand against Ukraine move towards European institutions, both Nato and di EU.

    Now, Mr Putin dey claim say Ukraine na toy of di West and no ever be proper state anyway.

    E dey demand guarantees from di West and Ukraine say dem no go join Nato, one defensive alliance of 30 kontris, and say Ukraine go demilitarise and become a neutral state.

    As a former Soviet republic Ukraine get deep social and cultural ties with Russia, and dem dey speak well-well dia, but ever since Russia invade for 2014 those relations don get K-Leg.

    Russia attack Ukraine wen dem comot di pro-Russian president for early 2014. Di war for di east don claim more dan 14,000 lives since den.

    Wen Russia invade Ukraine for 2014, rebels wey get President Putin support seize big areas of di east and dem don dey dig am out wit Ukraine army ever since.

    One international Minsk peace accord happun but di gbege still continue and so Russia leader say e dey send in troops to di two areas wey di rebels dey hold.

    UN Secretary-General don reject Russia use of di word peacekeepers.

    Di West believe say Moscow dey plan new invasion of Ukraine, a kontri of 44 million pipo wit border wit both Russia and di European Union.

    President Putin don warn say Ukraine go dey responsible for further bloodshed if dem no stop di attack on di east.

  2. UN confam at least 64 civilian deaths, 160,000 pipo dey displaced

    Ukraine-Russia war 2022 LIVE: Latest update on Ukraine-Russia invasion

    Intense fighting happun ova di weekend across several major Ukrainian cities.

    Di Office of di United Nations High Commissioner for Human Rights (OCHCR) reports say dem don get at least 240 pipo wey di war kill alias casualties.

    Dis number include at least 64 civilian deaths - inside di kontri so far.

    E add say damage to homes and critical infrastructure don leave hundreds of pipo without access to water and electricity.

    UN also say over 160,000 Ukrainians dey now internally displaced and trying to japa across international borders.

    Ukraine gonment dey estimate say di Russian invasion fit leave behind as many as five million refugees.

  3. Belarus don prepare venue for peace tok between Russia and Ukraine delegate

    Belarus Foreign Ministry post foto of venue for peace talk between Russia and Ukraine delegate on social media

    Belarus say dem don prepare venue to host tok-tok between Ukrainian and Russian delegations.

    Dis dey come as Moscow invasion of im western neighbour enta di fifth day.

    Ukraine don agree to send diplomats to one location near di Ukrainian-Belorussian border.

    E dey happun even as reports dey comot say di kontri dictator, Alexander Lukashenko, fit send troops to join di invasion.

    "Di venue for tok between Russia and Ukraine for Belarus don dey prepared, na di arrival of delegations we dey expect."

    Na so Belorussian foreign ministry tok am on social media, as dem release foto of one long table wit Russian and Ukrainian flags.

    Anatoly Glaz, one tok-tok pesin for di kontri foreign ministry, say:

    "Di tok go start as soon as all di delegations arrive for di meeting point."

    Ukraine don vow say dem no go give any ground for di meeting.

    President Volodymyr Zelensky, don say im no dey expect di tok to yield any results.

    "As always: I no really believe in di outcome of dis meeting, but let dem try," im tok.

  4. Welcome to our live coverage of news from around di world

    Ukraine

    Una good morning

    Dis morning, Daniel Semeniworima and Olaronke Alo dey report.

    BBC Pidgin get reporter all ova Nigeria and parts of West Africa.

    BBC also get headquarters all over di world.

    Dis morning, Russia invasion of Ukraine na im be di biggest tori.

    Plus oda tori wey dey follow, stay on dis page for latest update.

  5. Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

  6. Elon Musk send satellite to Ukraine as Russian invasion cut internet

  7. Why Abramovich hand over control of Chelsea before League Cup final

  8. Ukraine crisis inside five maps

  9. Who Putin dey listen to? Find out inside dis tori

  10. Eyes on Champions league final new venue

  11. See how Ukraine arm ordinary citizens against Russia attacks

  12. Ukraine fit defend demsef against Russia invasion?

  13. See fotos of Russia full-scale attack on Ukraine

  14. Britain brutal economic, financial punishment against Russia

  15. Five steps to prevent Russia-Ukraine war

  16. 'We dey panic mode for Ukraine' - Nigeria, Ghana students cry out as Russia invasion begin

  17. Uefa fit move final from Russia

  18. US and Russia hold 'frank' tok ontop Ukraine tension

  19. Five tins Putin and Biden discuss for dia ogbonge meeting for Switzerland