Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Aguleri widow: Police arrest one, rescue victim

    Anambra State Police don arrest one suspect after dem rescue one woman from angry mob for Aguleri, Anambra State, for southeast Nigeria.

    Di rescue come as a result of one report dem see for one trending video wia crowd of pipo dey molest and assault one lady publicly say she allegedly cause di death of her late husband.

    Police tok tok pesin DSP Ikenga Tochukwu say further information reveal say dem don already bury di dead husband before di video start to trend.

    E add say di victim dey receive medical care for hospital.

    Anambra Commissioner of Police, Echeng Echeng wey describe di act as barbaric, don order immediate study of di video to identify di suspects, arrest and bring dem to book.

    E also beg members of di public to stop sharing di video to protect di dignity of di woman.

    Many pipo don dey call for justice for di woman as dem say wetin di mob do di woman na dishonor to womanhood.

  2. We fight well but we need help to stop WW3, Ukraine tok

    Ukraine don repeatedly call for Western countries to give dem more help for di fight against Russia - and di kontri Foreign Minister Dmytro Kuleba don reiterate di plea again.

    "Ukraine fights back successfully," im tok "We need you to help us fight. Provide us wit all necessary weapons.."

    "Apply more sanctions on Russia and isolate dem fully. Help Ukraine force Putin into failure and you go stop larger war."

    Some Western governments fear say getting more involved fit escalate di situation.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. 'Vice President Osinbajo presidential declaration na fake news'

      • Author, Onyinye Chime
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Prof Osinbajo

    Office of Nigeria Vice President, Yemi Osinbajo, say news wey say di VP don declare im intention to run for president na "fake news."

    Tori bin dey fly upandan say Osinbajo declare im interest give President Muhammadu Buhari.

    Dem also bin report say di VP dey meet wit all di state chairmo dem of di ruling All Progressive Congress patty on Monday, March 14 before I'm officially declaration.

    Local tori pipo wey do di reports of di VP declaration bin say na "credible sources," nak dem inside gist.

    But one of di VP aides tell BBC Pidgin say, all dis credible sources na for di mind of di pipo wey write di story. E add say, "as long as no be di media unit of di Office of di Vice President release di story, abeg consider am as fake news."

  4. INEC release list of candidates for Ekiti election

    Nigeria election body, di Independent National Electoral Commission (INEC) don release di final list of candidates and political parties wey go participate for di governorship election for Ekiti state.

    Festus Okoye, Chairman Information and Voter Education for statement e release on Tuesday list 16 candidates wey go involve for di election.

    Abiodun Oyebanji of All Progressives Congress, Olabisi Kolawole of Peoples Democratic Party and Olusegun Oni of Social Democratic Party dey among di list of major candidates wey dey enter di election.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. Nine students die inside car accident for Ghana

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    Foto of di truck wey involve for di accident
    Wetin we call dis foto, Foto of di truck wey involve for di accident

    Ghana Police Service confirm say nine students die inside road accident for Asuboi, on de Accra-Kumasi Highway.

    Dis be after commercial bus driver who dey carry de students crush into forty footer container which partially block de road after accident.

    De commercial bus according to Eastern Region Police PRO, Ebenezer Tetteh, de accident happen Sunday dawn after de driver fail to follow traffic ahead of am, he allegedly dey doze behind de steering wheel moments before he crush into de truck.

    De truck which dey carry wood fall on de road partially sake of e get accident earlier on.

    Police say 8 people die on de spot wey one die later for hospital.

    Dem rush de survivors to Suhum govment hospital for treatment, meanwhile dem deposit de body of de deceased for mortuary.

    Foto of di truck wey involve for di accident
  6. 'No put mouth for matter wey dey court', APC caution Wike

    Governor Wike say PDP go outside di matter to Supreme Court
    Wetin we call dis foto, Rivers State Governor Nyesom Wike

    Di ruling All Progressives Congress (APC) don react to Rivers State Governor, Nyesom Wike over im comment about Governor David Umahi.

    Ebonyi State APC Chairman, Chief Stanley Okoro-Emegha for statement say Wike tok na affront to di judicial system and e dey show say powerful forces dey manipulate di Nigerian judiciary

    Di Rivers Governor Wike for one programme for Port Harcourt, ask di Ebonyi State Governor to hand over di governorship mandate to di Peoples Democratic Party.

    Oga Wike add say di PDP go pursue di case of Umahi’s defection to di All Progressives Congress up to di Supreme Court to recover dia mandate.

    But di Ebonyi APC say Umahi don appeal di judgment of Federal High Court Abuja, wey remove im and im deputy from office and e no go good make anybody tok about matter wey dey before di court.

    Umahi don appeal di court judgment wey comot am form office sake of in defection
    Wetin we call dis foto, Ebonyi State Governor Dave Umahi
  7. In fotos: Ukrainian refugees don dey run go Slovakia

    More dan two million pipo don escape from Ukraine go neighbouring kontris since Russia launch full-scale invasion of di konri on February 24.

    As we enter day 19 of Russia war on Ukraine, plenty refugees don begin enta Velke Slemence, Slovakia.

    One refugee girl wey dey escapre Ukraine war inside supermarket trolley
    Wetin we call dis foto, One refugee girl wey dey escapre Ukraine war inside supermarket trolley
    One refugee girl wey dey escapre Ukraine war inside supermarket trolley
    One refugee girl wey dey escapre Ukraine war inside supermarket trolley
  8. Academic Staff Union of Universities extend strike

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja
    ASUU

    University lecturers for Nigeria don extend di ongoing strike by anoda eight weeks.

    Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) extend dia roll over strike sake of goment failure to comply wit dia demand.

    Di Union declare di extension of di warning strike afta dia National Executive Committee meeting for Universities of Abuja on Sunday.

    One of di senior NEC member of di Union wey yarn wit BBC Pidgin say dem extend am sake of say since dia warning strike, goment neva come up wit anytin tangible.

    Di academic union bin declare one-month warning strike for February 14 2022 to press home dia demand wey be for goment to honour 2009 agreement and also to use dia payment system UTAS to pay dia salaries instead of di IPPIS.

  9. Former US president Barack Obama don get Coronavirus

    Former US president Barack Obama

    Former US President Barack Obama don test positive for mild case of Covid-19.

    Obama make di announcement on im official Twitter account.

    “My throat don dey scratch me for some days now, but I dey feel fine,” Obama tweet – e add say im wife, Michelle don test negative.

    Recently, Obama and oda former US presidents Jimmy Carter, George W. Bush, Bill Clinton and di former first ladies appear together for one one-minute video approving di US vaccination campaign.

  10. Malami deny tori say e vindicate Abba Kyari

    Nigeria police officer Abba Kyari and Internet fraudstar Ramon Abbas

    Nigeria Minister of Justice, Abubakar Malami don deny tori say im office don vindicate Abba Kyari.

    Di minister make di clarification for statement wey Umar Gwandu, im tok-tok pesin release on Sunday.

    Oga Malami explain say pipo no understand di issue becos as tins be di Attorney- General office still dey torchlight di matter.

    “Na case of work in progress and di office of di Attorney General of di Federation requested for further probe in relation to some aspects of di investigation,” some part of di statement read.

    Kyari, di suspended Deputy Commissioner of Police wey dey wanted for United States for alleged involvement for $1.1m fraud by Internet fraudster, Ramon Abass, a.k.a Hushpuppi.

    However, according to one letter by di Director of Public Prosecutions for Ministry of Justice say di evidence for di case diary no dey enough to say Kyari directly dey involve for di crime.

    Na wetin make pipo vex say di Minister of Justice wan vindicate di police officer of di crime – but Abubakar Malami don come out to clarify di matter

  11. Russia dey face war crime investigation

  12. US journalist and filmmaker killed inside Ukraine

    Brent Renaud
    Wetin we call dis foto, Brent Renaud win Peabody Award for im journalism for 2015

    Kyiv police say Russian forces don shoot kill one US journalist wey dey work inside Ukraine for di town of Irpin.

    Brent Renaud, 50, na journalist and filmmaker wey bin dey work for di region for tori pipo, Time.

    Kyiv police chief Andriy Nebytov say Russian soldiers bin target am. Two other journalists suffer injury and dem carry dem go hospital.

    Na di first reported death of foreign journalist wey dey cover di war for Ukraine.

    One of di injured journalists, Juan Arredondo, tell one Italian reporter say im bin dey wit Renaud wen dia motor begin come under fire.

    "We bin dey across one of di first bridges for Irpin, we bin dey go film other refugees wey dey leave, and we enta inside one car", im tok for one Twitter video.

    "Somebody offer to take us to di other bridge and we cross checkpoint, and dem come begin dey shoot us. So di driver turn around, and dem kontinu to dey shoot us; we dey two. My friend na Brent Renaud, and dem shoot am come leave am behind... I see say dem shoot am for neck."

  13. Latest updates, fotos as Russia Ukraine war enta day four

  14. Welcome to we live coverage of di big tori dem from around di world

    Good morning!

    Welcome to our live coverage of di big tori dem from around di world.

    Eyes still dey Ukraine afta Russian invade dem.

    Di war don enta day 19 and di impact of Russia invasion of Ukraine don show as over 2.5 million pipo don run comot from di kontri according to United Nations.

    We go bring you tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.

    But first make we start di day wit proverb from Nwata Kalisia.

  15. Nigeria evacuate over 300 citizens as civilians run from cities wey Russia dey bomb

  16. Fotos wey summarise how second week of Russia invasion of Ukraine waka

  17. Wetin be sanctions? - See which ones dem sama Russia and how Putin respond

  18. 'I wan fight for Ukraine to get my revenge against Russia Putin'

  19. Una bye bye for now!

    We go end today Live Page here.

    So far, we bring you report say Lagos state court don remand Bus Rapid Transit (BRT) driver Andrew Nice for prison custody till April 11.

    Russian President Vladimir Putin don call for foreign volunteers to dey allowed to fight against Ukrainian forces.

    Ghana hold mass burial for some 13 victims wey die after mining truck explosion hit Appiatse community for Western Region.

    No forget to scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.

    Na Faith, Helen, Ronke, and Moseph bring una all di tori for today.

  20. Bamishe Ayanwole murder: Court remand BRT driver for prison

    Andrew na di BRT driver wey carry di late 22-year-old Bamise Ayanwole from Chevron

    Di magistrate court for Yaba, inside Lagos don remand Bus Rapid Transit (BRT) driver Andrew Nice for prison custody till April 11.

    Andrew na di BRT driver wey carry di late 22-year-old Bamise Ayanwole from Chevron, Lekki to Oshodi on Saturday, February 26 before dem declare her missing.

    Di 47-year-old driver na di major suspect for di killing of Bamise wey be fashion designer.

    Police say dem arrest di suspect on Monday afta dem find di bodi for Carter Bridge, Lagos Island.

    Lagos police command carri di driver go court on Friday to ask for more time to hold am and complete dia investigation as di normal time to hold pesin under di constitution done elapse.

    Magistrate O.A Salawu remand Andrew for police custody for 30 days. Na afta dat time dem go carri di suspect go back to court.

    Tori be say Bamise enta BRT bus on February 26, 2022 wen she dey go from Lekki to Oshodi area of Lagos to go see her elder brother Pelumi.

    She no reach her destination dat day wey make her family raise alarm.

    Police later find her deadi body for one along Carter Bridge for Lagos Island..