Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Prime Ministers of Poland, Czech and Slovenia dey go Ukraine

    Michal Dworczyk, head of Polish prime minister office tok about di visit for Warsaw
    Wetin we call dis foto, Michal Dworczyk, head of Polish prime minister office tok about di visit for Warsaw

    Prime ministers of Poland, Czech and Slovenia dey travel by train go Kyiv for tok-tok wit Ukraine president and prime minister.

    Dem dey travel as representatives of di European Union and go present details of dia actual support package for Ukraine, Michal Dworczyk, di head of di Polish prime minister office tok.

    Dem arrange di visit during di recent EU summit for Versailles, Dworczyk add.

    Di three leaders, wey di head of Poland governing party, Jaroslaw Kaczynski dey follow on di trip, go present broad package of EU support for Ukraine, e tok.

  2. EU ready to slam more sanctions on top Russia

    Di EU don unveiled dia fourth package of sanctions against Kremlin. Dis time di target na luxury goods exports as well as investments for Russia energy sector.

    More oligarchs and pipo wey dey spread so-called "disinformation" go join for di list of individuals wey di EU asset freeze go affect. Sources don tell di BBC say di list go include Chelsea football club owner Roman Abramovich, wey UK goment don already sanction.

    Di ban go also affect exportation of luxury goods, such as expensive cars and jewellery, to Russia. Also, restrictions on di import of Russian steel products and on new investments for Russian energy sector.

    While di EU don go further and faster on sanctions dan many expect, diplomats don tell di BBC of increasingly obvious quarrel between Poland and Baltic states - wey want stronger measures - versus a more cautious approach wey kontris like Germany and Italy like.

  3. Ukraine-Russia war dey make Kenyans pay more for fuel

    From Tuesday Kenyans go begin pay more for fuel as di Russian invasion of Ukraine continue to affect di price of crude oil and refined products.

    Di East African kontri petroleum regulator say di price of petrol and diesel will increase by five Kenyan shillings ($0.044: £0.034)

    Di fuel prices regulator say di price of kerosene, wey many poor Kenyan households dey take cook, “neva change”.

    Kenya petroleum subsidy programme don make fuel prices neva change for four months in a row.

    Afta Russia invade Ukraine, Brent crude oil hit 14-year high. Di price of essential commodities dey expected to go up for di East African kontri.

    Fuel prices for Kenya neva change for four months now
    Wetin we call dis foto, Fuel prices for Kenya neva change for four months now
  4. Russian missile hit more residential building for Kyiv dis morning

    Ukraine authorities don release more foto of a separate nine-storey residential tower for Svyatoshinsky district of Kyiv on fire afta shelling.

    Dem put out di fire at 05:36 local time (03:36 GMT).

    Authorities neva tok if pipo die for di .

    Foto of di nine-storey residential wey missile hit
    Foto of di nine-storey residential wey missile hit
  5. Goment reach agreement wit airlines over scarcity of aviation fuel

    Aviation fuel: Nigeria airlines warn of more flights cancelation or delays

    Nigeria goment don assure say aviation jet A1 fuel go sell at N500 within di next three days.

    Dis na to prevent airlines from shutting down.

    Mele Kyari, Group Managing Director of di Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) give di assurance afta meeting marketers, regulators and operators for di aviation industry.

    E say operators go get license to import aviation fuel.

    Na di Deputy Speaker of the House of Representatives, Ahmed Wase preside over di meeting as dem continue di investigation over di scarcity and high cost of aviation fuel wey lead to di increase in price of airline ticket.

  6. Nigeria Police deny tori say officers plan to go strike

    Nigeria police officer wey dey address EndSars protesters for 2020

    Di Nigerian police Force don deny tori say dia officers dey plan to go strike over non-implementation of di new salary package goment approve for police.

    Olumuyiwa Adejobi, force tok-tok pesin make di denial for statement e release.

    E say police officers know say strike na mutiny for di police force.

    “Di Nigeria Police Force wishe to say di publication dey fake and na mischievous attempt by corrupt individuals to bring di Force to disrepute, misinform di general public and heat up di polity.

    “Di Federal goment dey fully committed to di implementation of di new salary package.

    Tori bin come out say police wan go strike on March 26, 2022.

  7. War fit end by early May - Ukrainian advisor

    One Ukrainian goment advisor say e expect di war to end by early May latest, wen Russia run out of money to attack dia neighbour.

    "I tink no later dan for May, early May, we go peace agreement," Oleksiy Arestovich tok, advisor to di Ukrainian president chief of staff, late on Monday.

    E outline two possible outcomes for di months ahead.

    "Na either we strike peace deal very quickly, within one week or two, wit troop withdrawal and everi tin or attempt to jam dem togeda.

    Di Pentagon don earlier claim say Russia dey try recruit Syrians to fight for Ukraine - though we neva verify dis one.

    Arestovich no dey personally involved for talks between Ukraine and Russia

  8. Welcome to Tuesday live-text of big-big tori dem

    Good morning!

    Welcome to Tuesday live-text report of all di main tori dem you suppose know around di world.

    Our today proverb na from Ezeka Elvis wey say.

    "Today overfeeding no go stop tomorrow hunger"

  9. Goodnight!

    Na here we go end today Live Page.

    So far, we bring you report say one of di wives of di suspended DCP Abba Kyari faint for court as dem try hear her husband bail application.

    Cameroon ban smoking of shisha pipes as dey say e get health risk for young pipo.

    Pregnant woman and her baby die afta Ukraine hospital attack.

    You fit scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.

    Na Jelilat, Helen, Ronke, and Tunde bring una all di tori for today.

  10. Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv

    One person don die and six more don dey injured after missile fragments fall ontop road for Kurenivka area of Kyiv today.

    Di mayor of di capital Vitaliy Klitschko tok say di debris na from a missile wey don dey by Ukrainian air defences.

    Di BBC bin dey di scene where di fragments hit, and we capture some fotos.

    Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv
    Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv
    Wetin we call dis foto, One trolley bus dey completely destroyed, but luckily no passenger bin dey inside
    Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv
    Wetin we call dis foto, Dem shatter di windows of di nearby buildings. Di balconies and commercial property on di ground floor also dey damaged.
    Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv
    Wetin we call dis foto, Mayor of Kyiv Vitaliy Klitschko, on di right, bin visit di scene earlier today.
    Fotos: See how missile fragments hit neighbourhood for Kyiv
    Wetin we call dis foto, Pipo bin dey clear debris from buildings wey dey damaged.
  11. Russia show off navy boats wey dem capture

    Russian state TV don show wetin e tok say be Ukrainian navy boats being disarmed for di port of Berdyansk wey don dey captured

    Di fast patrol boats Akkerman and Vyshhorod dey abandoned along wit a tug called Korets, di defence ministry channel Zvezda bin report.

    Russian forces capture Berdyansk two weeks ago, on di Sea of Azov. E lie between Crimea and Ukrainian city of Mariupol wey dey besieged.

    One reporter wey dey tour one of di vessels show ammunition and "personal belongings" allegedly leave behind by Ukrainian crew members as dey run comot di Russian assault.

    One journalist dey hold im mic while one soja dey beside am
  12. Di women wey dey volunteer on Ukraine front line as Russia's invasion continue

    Countless Ukrainian families don dey separated as women and children evacuate and leave men behind for di war zone. But many women don choose to remain on di front line. Di BBC speak to five women about di reason why dem dey stay.

    Kira Rudik - 'e dey scary, but I dey vex'

    Di women wey dey volunteer on Ukraine front line as di war between dem and Russia continue
    Wetin we call dis foto, Kira Rudik say she never touch gun before until di war start.

    "I never touch gun until di war start,” member of parliament Kira Rudik tok. “E no just dey necessary.

    She tok say wen di invasion bin start and di possibility to get a gun happunn, she dey shocked say she decide to carry am.

    Marharyta Rivachenko - 'I no get anywhere to run to’

    Di women wey dey volunteer on Ukraine front line as di war between dem and Russia continue
    Wetin we call dis foto, Marharyta Rivachenko say her life depend on dis war

    Regular women also join politicians to volunteer for di war effort.

    Marharyta don learn how to sleep wit di sound of air sirens for shelters sake of say her city don dey bombarded by Russian forces.

    "When di war start, my family bin dey Kharkiv and I bin dey alone for Kyiv. I no get anywhere to run," di PR manager tell di BBC.

    Yustyna Dusan - 'My priority na to survive'

    Olena Biletskyi - 'I want make my daughter dey born inside free Ukraine'

    Di women wey dey volunteer on Ukraine front line as di war between dem and Russia continue
    Wetin we call dis foto, Olena Biletskyi get six months pregnancy

    "For di first few days, fear and anxiety bin hold me well,” Olena tok. “But now fear no dey again, na just di desire to defeat di enemy.

    Olena tok say she dream to have her third daughter for inside free and independent Ukraine.

    Yaryna Arieva - 'I no dey scared for myself'

    Di women wey dey volunteer on Ukraine front line as di war between dem and Russia continue
    Wetin we call dis foto, Yaryna Arieva say she no dey scared for herself

    Yaryna bin move to di territorial defence base with her husband, but she never dey experienced enough to go on combat missions yet.

    Yaryna tok say before di war, she bin get a lot of fears.

    "But right now, di only fear wey I get na to lose my husband - I no dey scared for myself.”

  13. Former Boko Haram members to rejoin communities afta dem graduate de-radicalisation programme

    Onew Boko Haram fighter dey hold dia flag plus odas wey surround am wit dia guns

    Di authorities for Nigeria say 559 ex-Boko Haram members don graduate de-radicalisation programme and dey expected to re-enter di society soon.

    Di graduation ceremony wey hold ova di weekend at a de-radicalisation centre for di north-eastern state of Gombe.

    For di event, di graduands pledg dia allegiance to di Nigerian authorities dey once fight against.

    Di military-run initiative dey introduced for 2015 by di Nigerian goment and become operational for 2016 as part of im counter-terrorism strategies.

    Members of Boko Haram wey voluntarily lay down dia arms and surrender to di authorities collect special training wey nclude vocational skills, religious reorientation and psychological support to de-radicalise dem before being reintegrated into di society.

    Di total number of those wey don complete di programme now be 1,629.

    Sense of mistrust still dey di society towards former Boko Haram members given di level of violence wey di group don comit.

    Di Boko Haram insurgency wey begin for 2009 don cause di deaths of about 350,000 pipo wit millions of odas displaced for Nigeria and several oda kontris for di Lake Chad region.

  14. Wetin be di latest from Ukraine?

    Firefighters dey put out fire
    Wetin we call dis foto, Firefighters dey put out fire

    In case you just dey join us, see wetin dey happun on day 19th of Russia invasion of Ukraine:

    • Russian and Ukrainian representatives do tok-tok to try end di fighting, Ukraine negotiator say di tok go focus on establishing a ceasefire, di withdrawal of Russian troops and security guarantees for Ukraine
    • Tok-tok dey set to resume on Tuesday afta a "technical pause", Ukrainian presidential adviser Mykhaylo Podolyak tok
    • But fighting don continue with bombardment for Kyiv wey kill at least one pesin afta one block of flats dey hit
    • One pregnant woman wey dem bin take her foto ontop stretcher form di maternity hospital dem bomb for Mariupol don die togeda wit her baby according to reports.
    • Russian bombardment of some towns don dey so serious sotay dem dey bury civilians wey die for mass graves, including for Mariupol
    • China say claim by US officials say Russia ask Beijing to provide dem wit military assistance for Ukraine na "disinformation", while di Kremlin don also deny am - say dem get resources to meet dia goals independently
    • For UK, Levelling Up Secretary Michael Gove dey due to set out details of one cheme for pipo to host Ukrainian refugees for dia house
    • And riot police don begin dey pursue squatters from di London home of Russian billionaire Oleg Deripaska.
  15. Pictures of How Abba Kyari Wife faint for court today

    Small drama bin happun for Federal High court, Abuja as wife of di suspended Deputy Commissioner of police, Abba Kyari slump afta proceedings.

    she come court come see her husband
    Wetin we call dis foto, Abba Kyari First wife dey suffer from asthma
    She wear black cloth
    Wetin we call dis foto, Pipo help her into one office for di third floor of di Federal High court
    Dem get inhaler before dem fit resuscitate  her
    Wetin we call dis foto, Dem cari her from di 5th floor to di 3rd floor and she bin dey lifeless
  16. Dem don ban shisha smoking for Cameroon

    Shisha smoking don dey banned for Cameroon
    Wetin we call dis foto, Pipo get misconception say shisha dey less harmful dan cigarette.

    Cameroon don ban di smoking of shisha pipes as dem tok say e dey cause health risk to mostly young pipo who use am for bars and homes.

    About 46% of young Cameroonians dey smoke di substance according to di health ministry – wey be mixture of tobacco, molasses, glycerine and flavourings.

    Doctor tok say misconception dey about shisha as pipo think say e no dey harmful as cigarettes. Dem tok say di British Heart Foundation say one hour of smoking shisha fit be di same as smoking more dan 100 cigarettes.

    “Traditionally shisha tobacco contain cigarette tobacco, so like cigarette e contain nicotine, tar, carbon monoxide and heavy metals, such as arsenic and lead,” di foundation tok.

    For recent years, shisha don dey banned for Tanzania and Sudan – though di ban dia don dey reversed and introduced again several times since.

  17. Ghana court adjourn Oliver Barker Vormawor bail application

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    Oliver Barker Vormawor as he dey appear before court
    Wetin we call dis foto, Oliver Barker Vormawor as he dey enter court

    High Court for Ghana adjourn bail application case of #FixTheCountry campaigner, Oliver Barker Vormawor.

    Lawyers for Mr Barker Vormawor plead wit de Court say dem get de discretion to grant de bail despite de treason felony charge against dia client.

    Dis be after state prosecutors argue say Oliver Barker Vormawor be flight risk sake of he no get place of residence.

    But en legal team, led by Lawyer Akoto Ampaw debunk de claims as plus details of de residence of Mr Vormawor.

    He argue say de state also get de accused en travel passports so that again go make an difficult for him to leave de country.

    After hearing both arguments from prosecution and defense, Justice Daniel Mensah adjourn hearing to Wednesday, March 16, 2022 for en ruling.

  18. Abba Kyari first Wife faint for Abuja court

    Di first wife of di suspended Deputy Commissioner of Police, DCP, Abba Kyari, Ramatu on Monday, faint for Federal High Court, Abuja.

    She fall for ground as armed NDLEA officers dey try carri Kyari comot from di courtroom afta di trial judge, Emeka Nwite adjourn ruling on Kyari and four odas bail application to 28th of March, 2022.

    Kyari lawyer bin file application to release am on bail pending di determination of di case against am.

    Kyari wife bin wear black cloth and bin hold her husband hand as dem stand close to di elevator wey dey go di fifth floor of di Federal high court - suddenly she fall for ground.

    She later regian consciousness afta some minutes.

    Pipo for court dey try save Abba Kyari wife
    Wetin we call dis foto, Pipo for court dey try save Abba Kyari wife
  19. Pregnant woman and her baby die afta Ukraine hospital attack

  20. Ukraine-Russia begin anoda round of tok-tok

    One of Kyiv negotiators don share image of tok-tok between wey don start Ukraine and Russia for di fourth time.

    Di tok-tok between di two kontris dey hold through video conference call.

    Ukrainian official Mykhailo Podolyak says both sides have now laid out their positions.

    Earlier im bin tok say di discussion go focus on on establishing a ceasefire, di withdrawal of Russian troops, and security guarantees for Ukraine.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post