How di battle for Ukraine dey go?
Here na a quick summary of Russia attacks based on di latest analysis by di Institute of di Study of War. Di US-based thinktank dey use OSINT and news reports to craft a frontline assessment evri day.
Kyiv: While Russian forces launch scattered attacks on Irpin and Guta-Mezhyhirksa - areas just outside di capital - on Monday and Tuesday, dem neva take any broader action against di city in di past 24 hours
Mariupol: Russia continue to attack di southern city from di east and west
Kharkiv: Russian forces dey struggle wit shortage of ammunition for dia attempt to encircle dis north-eastern city
Kherson region: Russia falsely claim say dem dey in control of dis region on Tuesday, but dem neva make any advance to either Zaporizhya or Mykolaiv - di key cities
Odesa: Russia no dey ready yet to launch operation from di sea against di southern port city as dem neva establish troops on di ground here.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post












