Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Nigerian Association of women journalists mark IWD 2022
To mark di international women’s day 2022, di Nigerian Association of women journalists Rivers State along wit National Youth Council of Nigeria and oda groups do protest waka go di Rivers State House of Assembly.
Di women say dem no happy wit di way National Assembly reject di five gender bills wey dey promote women rights and di active participation of women for politics.
Wetin we call dis foto, Speaker RSHA say di Assembly stand with women as dem don pass bills wey uphold di rights of women
Wetin we call dis foto, RSHA don pass many bills wey protect di rights of women
Wia Ukraine citizens dey run dey go?
United Nations latest report say ova two million pipo don run comot di fight for Ukraine.
See map of wia dem dey go.
Two Million Pipo don run comot Ukraine - UN
Wia dis foto come from, EPA
Di number of refugees wey don run comot di war for Ukraine don pass two million, according to wetin United Nations tell BBC.
Filippo Grandi, wey be di UN High Commissioner for Refugees, bin call di way pipo dey run comot Ukraine say na di fastest growing refugee crisis for Europe since World War Two.
So far Poland don reveal say e pass 1.2 million refugees wey don enta dia kontri.
Dem don hold funeral prayer for over 60 pipo wey gunmen kill for Kebbi
Funeral prayer don hold for about 68 pipo wey gunmen kill on Sunday for Zuru town wey dey Kebbi state for northwest Nigeria.
Chief for one of di villages wey di gunmen attack tell BBC say na 63 pipo die for im town.
Tok-tok pesin for Kebbi Police Command Nafiu Abubakar say di attack na as a result of military offensive against di gunmen so na easy target dem see although e no confam di casualty figure as dem neva finish work on di mata.
Voter registration for 2023 elections dey happun across wards for Nigeria
Wetin we call dis foto, Pesin wey dey register for di ongoing voter registration exercise
Di Independent National Electoral Commission INEC don start voter registration for wards across Nigeria to helep pipo to do di voter registration close to dem.
Wen pipo come for di registration, di INEC official go ask wetin dem come for and direct dem well on what to do.
For pipo wey never register before and wey dey come register for di first time, dem go give dem form to fill dia basic information, show dem di list of polling units wey dey closest to dem wey dem fit register under and den, dem go do biometric capture afta which dem go give dem print out wey dem go use come claim dia permanent voter cards wen e ready.
For those wey don loss dia voter cards, dem go apply for new voter card, fill form, den di INEC official go verify dia information for di system so dem fit issue new voter card.
Wetin we call dis foto, Pipo wey don loss dia voter cards, those wey wan transfer to anoda polling unit and pipo wey wan update di information for dia voters card fit do so
Wetin we call dis foto, INEC dey warn against multiple registration as di system go cancel am and such pipo fit face serious penalty
Those wey wan transfer to new polling units go also apply for di transfer and indicate di polling units wey dem wan transfer to and dem go crosscheck am for di system to be di transfer. INEC dey encourage pipo to transfer to new polling units wey dem don create.
Di ones wey wan update and/or make corrections for di information wey dey dia voters card go also apply for di corrections dem wan make and dem go verify and make di corrections for di system, den dey give dem print out wey dem go use come take di card wey get dia new or updated information later.
INEC dey cut serious warning make pipo no do double/multiple registration as di system go spot such and e go cancel di registration and such pesins fit face penalty.
INEC Resident Commissioner for Rivers State Obo Effanga tell BBC Pidgin say di ward voter registration across di kontri go dey on till di end of March and dem go start anoda phase of di registration wey go dey till end of June 2022 wen di voter registration exercise go end for dem to clean up di system and print di voter cards of di ones dem don register.
Wetin we call dis foto, Nigerians wey dey 18 years and above naim dey eligible to register to vote
Ukraine President Zelensky say "I no dey hide, I no dey fear'
Wetin we call dis Video, War in Ukraine: President Zelensky post video from im office for Kyiv
On Monday night, Ukraine President Volodymyr Zelensky post anoda of im daily video. But dis one, e post am from im presidential office for Kyiv - Dis wan different from im oda selfie videos daily videos e dey post from field.
For inside di video e say, e no dey hide and e no dey fear.
Zelensky tok exactly wia im dey and pipo dey see dis one as yab to Russian Vladmir Putin.
Dis na even as Kyiv still get ogbonge defence against Russia wey still dey attack cities inside di kontri.
Police for Nigeria arrest 3 OSPAC members wey allegedly shoot dead soja
Police for Rivers state Nigeria don arrest three members of one local vigilante group, Onelga Security Planning and Advisory committee, OSPAC for Obelle community, Emohua LGA, wey allegedly shoot and kill one Nigerian Soja, Darlington Worehu.
Acting police tok-tok pesin Grace Iringe-Koko confam di arrest to BBC Pidgin say dem don begin investigate.
Di soja wey dey serve for Niger State bin come home on permission from di army.
Uncle of di soja, Eze Israel Anele say Darlington Worehu bin dey go house at about 10:30pm dat Saturday night wen im see say some OSPAC boys hold some of im relatives.
Argument burst out wen Worehu ask di OSPAC members why dem detain im relatives wey make one of di OSPAC boys to allegedly shoot am to death while two oda relatives also sustain gunshot injuries.
Di uncle wey also be former Caretaker Chairman of di Obelle Community Development Committee say some sojas dey patrol di community in search of di pipo wey shoot Darligton and di family dey demand justice for di death of dia son.
Russia don threaten to stop dia gas supply into Europe
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Russia say dem fit shut down supply of di first Nord Stream if di West ban Russian oil
Russia don warn say dem go fit shut down dia main gas pipeline wey dey enta Germany if di West ban Russian oil.
Deputy Prime Minister Alexander Novak say di move go lead to "serious gbege" for global supply and e fit lead to di increase in oil prices by 100% to $300 a barrel.
Di US don dey ginger with dia allies to sama potential ban to take punish Russia for dia invasion of Ukraine. But Germany and Netherlands reject di plan on Monday.
EU dey get 30% of dia gas and 40% of dia oil from Russia and e no dey easy to just replace dat kain supply.
Oga Novak say Russia get every right to do dia own back afta Germany bin decide last month to block di certification of di second Nord Stream pipeline between di two kontris.
'Dem put gun to my head inside di bus, I bin dey helpless' - BRT driver
Wia dis foto come from, TVC
Di driver of di Lagos state Bus Rapid Transit, BRT wia dem allegedly kidnap and murder 22-year-old Bamise Ayanwole don give account of wetin happun dat night.
Im tok afta police confam im arrest by di Department of State Services, DSS on Monday, 7 March 2022.
Dis na afta police bin confam di death of 22-year-old Oluwabamise Ayanwole wey bin miss since 26, February 2022 afta she enta di Lagos goment BRT busfrom Ajah area to Oshodi area of di state.
Di driver for im own account of di tori don deny say e get hand for Bamise death.
For inside video wia one tori pesin dey ask am question for wia dem detain am, di driver of di BRT bus wey still dey in im dark and sky blue driver uniform wey dey crested wit Lagos state logo tok wetin happun dat night.
"Why I run sir? Wen those guys show me di weapon as I was saying sir, I no fit be myself anymore. I become afraid, so whatever di man on gun tell me to do na im I dey do." E tok.
Wetin be di latest wit di Russia-Ukraine war?
As we enter day 13 of di Russian invasion of Ukraine, see some of di major developments from di past 24 hours:
Ukraine say di Russian attacks dey prevent civilians to safely evacuate form dia cities wey dey under attack
Tens of thousands of pipo across Ukraine dey without power and, for di port city of Mariupol, dem dey run low on food and water
Third round of Russia-Ukraine peace toks end with little agreement. A fourth round go take place on Tuesday
US, France, Germany and di UK vow to continue to raise di costs on Russia for im "unjustified" invasion of Ukraine
Russia threaten to cut dia natural gas imports to Europe as retaliation for Western sanctions
For im latest video address, Ukrainian President Volodymyr Zelensky say e go stay for Kyiv "as long as it take to win dis war"
Coca-Cola and McDonalds sey among firms wey dey face a possible consumer boycott over dia failure to withdraw from Russia
Ukraine say dem don kill a top Russian army commander for battle near Kharkiv - BBC never confam di claim
Good morning!, Una wlecome
Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.
We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.
On of di biggest tori from Nigeria today na di death of 22-year-old Oluwabamise Ayanwole wey police confam dead afta dem allegedly kidnap her inside Lagos BRT bus.
And for di for di world, di hot tori na still di Russian invasion of Ukraine.
Today na day 13 since President Vladimir Putin send troops enta Ukraine.
We go bring una all di latest wey dey happun wit dis tori dem as we dey get dem including oda top gist from around di world.
“We bin hear loud explosions, den electricity and water off” – Student wey dey trapped for Sumy
Una bye bye
Na here we go end today Live Page on di latest news wey dey
happun between Ukraine and Russia and around una as dem happun.
Scroll down to read all di tori wey you bin miss.
Remember join us tomorrow for more latest tori.
Na Helen, Faith, Abdulmalik and Onyinye bring una all of today tori for di page.
Una good night!
Sunday Igboho 'released' to go hospital
Goment of Benin Republic don release Yoruba Nation Activist, Chief Sunday Adeyemo, alias Sunday Ighoho to allow am go hospital.
According to one of Igboho lawyer, Yomi Aliyu, wey confam news of in release to BBC,Professor Banji Akintoye and Prof Wole Soyinka make dis medical release possible.
EU go consider adding Ukraine, Georgia and Moldova as members
Wia dis foto come from, Getty Images
European
Commission go begin consider EU membership applications from Ukraine, Georgia
and Moldova.
EU ambassadors take di
decision to consider di applications, but e go need sign off by di
European Council - but dem describe di sign off as just formality.
Member
states' permanent representatives bin discuss di applications, wey dem receive
last week, for one meeting today, and agree to invite di Commission to present dia
opinion on each.
However e fit take some
time - opinion from di Commission fit take up to 18 months to prepare.
And if e successful, di process to join di EU dey
usually take years.
2 police officer among bullion tiffs for Ghana
Police for
Ghana don announce di arrest of some suspects wey get hand for di robbery
attack on billion vans for different part of di kontri.
Di police
affairs directorate for Ghana say two police officers dey among di suspects
were dem arrest.
“Preliminary
investigation establish di involvement of two policemen among a number of oda
suspects,” Alexander Obeng, Director of Public Affairs of di police tok for
statement e release on Monday.
Ghana suffer
series of armed robbery attack last year and early dis year wit bullion vans as
dia major targets.
Wia dis foto come from, Ghana Police Affairs
Canada go impose sanctions against 10 pipo
Canada
don announce new sanctions against 10 pipo "wey get hand" for di
"unjustified invasion" of Ukraine.
Canada Prime Minister
Justin Trudeau, say di 10 pipo include "former and current senior goment
officials, oligarchs and supporters of Russia leadership".
Di Prime Minister wey tok
dis one for joint press conference wey im do wit UK and Dutch prime ministers, add
say dis dem pick dis pipo from one list wey jailed Russia opposition leader
Alexei Navalny bin compile.
Wia dis foto come from, AFP
Wetin be no-fly zone?
As we don dey report for some time now, Ukraine President
Zelensky want make di West declare no-fly zone over Ukraine.
But Nato dey resist dis request. Why?
No-fly zone for war dey aim to stop any aircraft from entering
airspace wey dem don ban, usually to prevent attacks or surveillance.
But to enforce dis ban dem go need to do am by military means.
No-fly zone ova Ukraine go mean say military forces -
specifically Nato forces - go engage directly wit any Russia planes wey dem see
for dat sky and shoot dem if necessary.
Dat go automatically drag Western nations into military
combat wit Russia - dramatic escalation to di war.
Wetin we call dis Video, Wetin be no-fly zone?
Police tok how dem find deadi-bodi of missing girl inside Lagos BRT bus
Wia dis foto come from, OLUWABAMISE/BRT
Di 22 year old Nigerian lady, Ayanwole Oluwabamise, wey
miss afta she enter BRT for Nigeria commercial capital Lagos state, don die.
Lagos state police command confam di death of 'Bamise' for
statement on Monday.
Police bin begin investigate on di disappearance of Oluwabamise
wey miss since February for weekend.
According to di police, di incident allegedly happun on 26
February, 2022 wen Bamise enta di BRT – Lagos transportation scheme - bus from
Chevron bus stop, Lekki for Lagos, South West Nigeria.