Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Hoodlums kill two prison wardens for dynamite attack for Okigwe
Police for Imo State don confam say two Prison wardens don die after some hoodlums attack dem for Okigwe, Imo State, South East Nigeria.
Police tok tok pesin CSP Michael Abatam tell BBC Pidgin say di hoodlums ambush di unsuspecting Wardens with dynamite attack for di motor wey dem bin dey drive and e kill two of dem on di spot while one dey injured.
Abatam say security agencies don take over di area with patrols and investigation don begin to fish out di hoodlums wey dey involved.
US go send $1bn in weapons to Ukraine
Wia dis foto come from, Getty Images
Di White House don confam e go commit $1bn (£764m) to di direct transfer of weapons to Ukrainian forces.
Biden say di continued support dey about "making sure say Ukraine go never be a victory for Putin".
E note US security assistance to Ukraine over di past year - $650m in weapons and $350m in additional aid - amounts to "more dan we don ever provid before".
Di newly-announced support includes drones, 800 anti-aircraft systems and 9,000 anti-armour systems, as well as machine guns, shotguns, grenade launchers and 20 million rounds of ammunition.
Allies too don step up dia support to unprecedented levels, Biden add join.
"We're go continue to stay di course and do everything we fit to push for an end to dis tragic, unnecessary war," he tok.
ICJ don order Russia to stop di katakata, Di fight don nearly reach three weeks
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Di International Court of Justice(ICJ) Judges don order Russia to suspend military operations for Ukraine.
Dem say Russia must immediately stop military operations for Ukraine and make sure say military units or pipo wey dem dey support or control no take any steps again for di military operation.
Both parties must stop from any actions wey fit increase di katakata pr make am hard to settle.
Di Judges no gree order Russia to report back on progress, but International legal obligations to make Russia to do as dem tok.
Ukraine President Volodymr Zelensky claim say na " complete victory" and tok say if Russia ignore di order e go dey on e own.
National grid wey collapse don recover - Minister, Electricity go return to normal afta two days of blackout for some parts of di kontri
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Minister of Power, Abubakar Aliyu, say dem don restore di
the national grid wey collapse few days ago.
E tok on Wednesday during briefing afta di Federal
Executive Council (FEC) meeting say plenti resolutions don come out afta plenti emergency meetings wey di Ministry of Power hold wit all stakeholders, and dem
extensively discuss di issues and resolved all di problems.
Di
minister emphasise say Nigeria dey generates up to 8,000 Mega Watts of power
According
to Aliyu, di shortage of gas and maintenance of generators,plus di current fuel situation
combine to make di problem worse for di national grid.
E
assure say di Federal Executive Council don approve Five billion Naira to open
up and expand Lagos/Ogun, to reinforce power supply to dat region.
Dem don throw Russia out of Council of Europe
Dem don throw Russian Federation out of di Council of Europe.
Di council na Europe's oldest political body and aims to uphold human rights, democracy and di rule of law across di continent.
One statement from di council's committee of ministers say after an "extraordinary" meeting, Russia's membership don dey suspended.
Di procedure to end Russia's membership first start on 25 February - one day afta President Putin's forces enta Ukraine, and almost exactly 26 years since Russia first join.
Wia dis foto come from, Getty Images
Ukraine don start to dey tap light from di main European electricity grid
Ukraine now dey connect to di main European power grid, to fit fight di power outages wey Russia attacks dey cause.
Na Ukraine President Volodymyr tok dis one for one post on Twitter say power don dey flow back an forth between Ukraine and di EU.
Zelensky thank di senior EU officials wey make am happun.
EU Commission President Ursula Von der Leyen say di move go "keep light in and houses dem warm for dis dark times".
EU Commissioner for Energy Kadri Simson say, at least, "for dis area, Ukraien now dey part of Europe".
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Russia attacks don leave plenti pipo for Ukraine without light
Wetin don happun so far today for Russia-Ukraine war?
If una just dey join us, hia na some of di tins wey don happun today wey be di third week of Russian invasion of Ukraine.
Ukrainian President Volodymyr Zelensky don invoke 9/11 as e again call for a no-fly zone for im address to di US congree - wey receive standing ovation
US President Joe Biden dey expected to announce $800m (£612m) of military aid following Zelensky's address
Fighting still dey continue wit two pipo wunjure for Kyiv after two high-rise residential buildings dey were by shells Wednesday morning
For Kharkiv, Ukraine's second-largest city, two pipo done die after shells hit one apartment block, emergency services tok.
Ukrainian officials claim say dem kill a fourth Russian general since di invasion start, although dis never dey verified
Ukrainian negotiator Mykhailo Podoliak don tell local media say any peace deal must to protect di country's sovereignty and don reject di idea of "Austrian-style" neutrality
E dey come afta di Kremlin tok say Russia dey open to a peace deal wey see neutral Ukraine maintain im own army.
Wetin we sabi about basketballer Brittney Griner wey chop arrest for Russia
Wia dis foto come from, Getty Images
E go soon be one full month since dem arrest ogbonge Women's Basketball Player Brittney Griner for Russia on top say she bin get vape cartridges with hashish oil.
Brittney Griner don dey play for di WNBA for almost nine years and her fans call am say she be di greatest female basketballer of all times.
Tori be say she go Russia for di WNBA off season to play for di league dia for February, shortly before US teams bin start to dey pull dia players from di Russian Federation.
More than half of di WNBA players dey go play for Russia every off season as dem dey pay dem five times wetin dey collect for America.
Di numbers show say NBA players dey gbab pass 200 percent of di highest money players dey make for di WNBA.
So far, US congressman John Garamendi say, dem neva allow any pesin from di American Embassy for Ukraine to get consular access to am.
Police kill cult leader wey allegedly kill pipo for one burial in Anambra
Wia dis foto come from, Anambra Police command
Police for Anambra state say dem don arrest gang members of one cult group wey allegedly attack and kill pipo one burial ceremony for Ebenebe area of di state.
Commissioner of police for di state Echeng Echeng tok dis wen im dey real out some of di activities of im command on Wednesday.
E say di gang also allegedly dey responsible for attack and killing of two police men for December 2021, say dem collect two Ak47 riffles from di officers during di attack.
CP Echeng say im officers ambush di gang wen dem go attack one vigilante group and kill di gang leader Uchenna Nwobu alias Anali
Wia dis foto come from, Anambra Police command
Gunmen kill six police officers for tomato factory in Kebbi
Wia dis foto come from, Getty Images
Motorbike gunmen don kill six police officers wey dey guarde one tomato-processing factory for Kebbi, north-western Nigerian.
Dem also kill one civilian for di attack.
One police toktok pesin tell BBC say di attackers bin wan kidnap foreign nationals wey dey work for di factory - but dem evacuate dem safely.
Di region dey grapple wit armed motorbike gangs, known locally as bandits, wey dey frequently steal animals, kidnap for ransom and kill those who confront them
Dem be sophisticated networks of criminals wey dey operate across large swathes of territory.
E don lead communities to form local vigilante groups to try and defend villages and towns from attack.
Manchester United: Club dey investigate video of fans wey throw object on Diego Simeone
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Atletico Madrid coach Diego Simeone
Manchester
United say dem dey review CCTV footage to identify fans wey throw objects inside
pitch afta dia 1-0 loss to Atletico Madrid.
Some body
throw some objects on Atletico boss Diego Simone including bottles afta di final
whistle for OId Trafford.
Uefa dey
wait di reports from match observers before deciding whether to charge di club.
To throw
objects inside field of play dey against ground regulations and subject to three
year ban.
Ralf
Rangnick side comot from di Champions League afta a 2-1 defeat on aggregate to di
Spanish club.
Di result spoil
United hope of ending five-year trophy drought, meaning dem dey on dia longest
run without trophy since di period between FA Cup wins for 1977 and 1983.
High Court for Port Harcourt sentence three to death by hanging for kidnapping, murder
Article Information
Author, Karina Igonikon
Role, BBC Pidgin, Port Harcourt
Wetin we call dis foto, Di court discharge and acquit three odas including one wey die inside prison
One State High Court for Port Harcourt don sentence three out of five suspects to death by hanging for di kidnap and murder of former Director of Finance and Supply Rivers State Ministry of Health, Charles Nwogu and Chief Promise Wali.
Dis incident happen on di 11th and 21st June, 2012 for Rumuokwuta and Woji Community all in Obio/Akpor local goment area and di trial don last 10 years before dis judgement day.
Di three convicts : Andy Clement Ogbu, Goddrey Handson and Chima Morrison Nwokoma bin dey face nine count charge of conspiracy, kidnapping and murder.
Di court also discharge and acquit two odas Obinna Okereofo and Ogechi Innocent- Ihunwo of di same charges of conspiracy and murder.
Presiding Judge, Justice Adolphus Enebeli as e deliver di judgement say di prosecution really prove di case of conspiracy, kidnapping and murder charges wey dem bring against di three convicts.
Justice Enebeli come sentence dem in line with section 401and 402 of di State administration justice law as di convicts contravene section1 sub 1 of di State Anti-kidnapping law as well as section 319 of criminal code and di various laws stipulate death by hanging upon conviction.
Di convicts get right to appeal di judgement and sentencing of death by hanging up to di Supreme Court and Goment authorities wey be either di State Governor or di President need to sign dia death warrants before dem fit execute di death sentence.
Since di return to Civilian rule for 1999, no State Governor for Rivers State don sign death warrant for di execution of death sentences wey Courts don give and such convicts still dey serve prison terms for Correctional Centres.
Nazanin Zaghari-Ratcliffe on way home to UK
Wia dis foto come from, EPA
Wetin we call dis foto, Nazanin Zaghari-Ratcliffe
Nazanin
Zaghari-Ratcliffe, di British-Iranian woman wey bin dey detained for Iran
nearly six years ago, dey on her way back to di UK, her MP don tok.
Mrs
Zaghari-Ratcliffe dey for airport for Tehran, Tulip Siddiq tell BBC News.
She dey di
holding room wit fellow British-Iranian detainee Anoosheh Ashoori, she tok.
Mrs
Zaghari-Ratcliffe chop arrest for 2016 - accused of plotting to overthrow
Iran's government, which she denied.
Mr Ashoori chop
arrest for 2017 on top accuse of spying, wey e deny.
Meanwhile, Mrs
Zaghari-Ratcliffe don dey under house arrest since and dem give her her UK
passport back dis week.
See di volunteers wey dey save babies and elderly pipo for eastern Ukraine
Polish, Czech and Slovenian delegation return to Poland
Di Prime
ministers of Poland, Czech and Slovenia don go back to Poland afta dia visit to
Kyiv, one Polish goment tok-tok pesin reveal.
“Di Polish,
Slovenia and Czech delegations safely return,” Piotr Muller write on Twitter.
Di leaders, wey
di head of Poland governing Law and Justice party, Jaroslaw Kaczynski join for
di trip, travel go Kyiv by train in show of solidarity wit Ukraine.
Na dem be di
first set of leaders to visit di Ukrainian capital since war start.
Wia dis foto come from, EPA
UK grant visa 5,500 to Ukraine refugees
Earlier Liz
Truss say di first refugees under di UK Homes for Ukraine scheme go arrive next
week, but we don get update on how many visas dem don grant under di oda scheme.
Di scheme allow family members to join dia reletives wey base for UK.
Immigration
minister Kevin Foster tell Commons home affairs committee say 20,000 Ukrainians
don apply to come UK.
E say so far,
dem don grant 5,500 visas.
Outgoing Anambra govnor beg Lawmakers to Support Soludo
Wia dis foto come from, Charles Soludo
Wetin we call dis foto, Outgoing governor of Anambra state Willie Obiano and govnot-elect Charles Soludo
Di outgoing
governor of Anambra state Willie Obiano don tell di State House of Assembly to support
di governor-elect, Prof Charles Soludo as dem support am.
Obiano make di
appeal for valedictory session for di State Assembly dem organise to honour am.
Di administration
of di current govnor go expire tomorrow wen e go officially handover to di govnor-
on Thursday.
Soludo go
dey sworn in as di 6th executive governor of di state.
“I
appreciate di House for honouring me and for your kind words. E always hard to say goodbyes but I go remember una.
“I wan beg
una to give di incoming govnor di same legislative support and assistance una
give me” e tok.
Condoms, TB and HIV drugs, 'disappear' from State Agency warehouse for Kenya
Wia dis foto come from, Getty Images
Kenya Medical Supplies Authority (Kemsa) dey on di spotlight again, after hundreds of thousands of condoms, mosquito nets and tuberculosis drugs wey worth reach $100,000 disappear from dia warehouse.
Global
Fund, wey dey finance di fight against HIV/Aids, tuberculosis, and malaria na dem reveal dis one.
Di Fund also accuse Kemsa of overstating
di value of medicines by
millions of dollars, with some types of drugs as e don increase by100 times. E dey believed say pipo steal and resell di lost medicines on di black market
and to private chemists.
Bandits kill DPO, two officers and four vigilantes for Niger State
Article Information
Author, Dooshima Abu
Role, BBC Pidgin, Abuja
Wia dis foto come from, police
Wetin we call dis foto, Dis Na di DPO wey bandit kill fo Niger state
Armed bandits invade Nasko village for Niger state-North Central Nigeria and kill di DPO Umar Digari, two oda police personnel and four vigilante corps.
Police tok-tok pesin, DSP Wasiu Abiodun wey confam di incident say di DPO bin mobilise di police operatives and vigilante members to engage di bandits but during di gun battle, di DPO and di officers die.
Di Area Commander for Kotangora don draft reinforcement wit military personnel to di area to stop any breakdown of law and order.
In Fotos: Russia invasion of Ukraine
One woman
wey dey cry onboard train to Poland, di man wey dey ride bicycle pass one
bombed building, tank wey dey patrol street wey pipo no dey.
Here na some
of di most recent pictures of Ukraine.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Many, like dis woman wey don dey leave di western city of Lviv for Poland
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Volnovakha, for Donetsk region don suffer heavily from di shelling
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Parts of di historical quarter of Odesa dey filled wit anti-tank hedgehogs
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, First responders for building hit by a rocket attack for Kharkiv
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Many ruined building for Volnovakha