Wetin Zelensky and South Africa President Ramaphosa discuss for phone call?, Ukraine President don dey reach out to world leaders for support
- Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin
Ukraine President Volodymyr Zelensky do phone call wit di President of South African Cyril Ramaphosa on Tuesday evening.
For one tweet, Mr Zelensky say den tok about di resistance of im kontri to di invasion by Russian troops.
Dem also discuss about relations between di two kontris and co-operation wit international organisations.
Di Ukrainian president don dey reach out out to global leaders and regional blocs to beg for world support.
Mr Ramaphosa office neva give any statement about di phone call.
South Africa dey among 17 African nations wey no vote for United Nations resolution wey dey demand an end to di Russian offensive for Ukraine.

Wia dis foto come from, Zelensky






