Comedian Russell Brand sentenced to 10 years and six months in prison ova rape and sexual assault

Wia dis foto come from, Zeynep Demir/Anadolu via Getty Images
Court don sentence Russell Brand to 10-and-a-half years in prison for rape and sexual assault.
Russell Brand enta court on Monday to collect sentencing for di charges of rape and three counts of sexual assault wey dem find am guilty of.
Di judge tell Brand say e be "sexual predator", wey tell "series of lies" and display "staggering arrogance"
Di 51 year old actor and comedian bin dey found guilty for Southwark Crown Court on Thursday afta trial wey don start since October.
Di judge tok say one of di complainants go like read her victim impact statement in pesin but dem go block her face so dat na only im go see her.
But for di oda three victims na di prosecution go read am for dem.
Victim impact statements na very important tin for sentencing as na wetin court go keep in mind as one of di factors wey dem go take sentence di accused.
Oga Brand bin face seven charges, three of dem be rape, three of dem be sexual assault and one of di charges na for attempted indecent assault.
Dem find am not guilty for three counts.
Brand crimes bin happun between 2004 and 2009 and bin relate to four women. Dem all dey entitled to lifelong anonymity.
Breakdown of Russell Brand sentence
In total, Russell Brand don chop 10 years and six months prison sentence.
E chop sentence to nine years' imprisonment for di one count of rape, wey e go serve consecutively wit di following three sentences:
- Nine months for count three - sexually assaulting woman wey e grab her breasts for one bar for London in 2004
- Eighteen months for count five - sexually assaulting woman at di Choice FM studios for London for either 2004 or 2005, wen e grab her face and kiss her bifor touching her breasts and bottom
- Eight months from count seven - sexual assault while working on Channel 4 project for 2009, wen e lay im head into di groin area of woman working wit am witout her consent
Dis three sentences go all be served concurrently to one anoda - but consecutively to di rape sentence.
Dis mean di total sentence na 10 years and six months.
Russell Brand charges
Di court bin find Russell Brand guilty of four charges wey include:
- sexually assaulting one woman wey im bin grab her breasts for bar for London for 2004
- sexually assaulting one woman for Choice FM studios for London for either 2004 or 2005 wen e grab am for face come kiss am bifor e touch am for breast and bum-bum.
- raping woman for im house dat time for London for 2009 afta e meet am for comedy show for Hammersmith
- sexual assault charge while e dey work for Channel 4 project for 2009 wia e lie down for di groin area of one woman wey bin dey work for am without her permission.
But dem also find oga Brand not guilty for
- accuse say im bin rape one woman for hotel for Bournemouth for 1999 during di Labour Party conference
- accuse say im orally rape woman for toilet for bar for London. Dis na di same woman wey dem find am guilty say e grab her breast.
- accuse say e grab woman hand and pull am to enta toilet for 2001.
How dem investigate Russell Brand criminal case
Hundreds of pipo dem bin dey interviewed as part of di investigation, and officers tok say several witnesses come forward, some of dem wey don get sexual relationship wit Brand before.
As dem dey tok with BBC, officers wey work on di three-year Metropolitan Police investigation explain say to bring Brand to justice no easy at all.
Victim reports come from police forces from all ova di kontri, and di Met set up one special team of officers to lead di investigation, wey dem call Operation Actinolite.
Officers say since den, dem don collect ova 340 witness statements, wey include statements from Brand former employers, ex-colleagues and associates.
One officer bin get di work to read Brand books, watch im stand-up shows and DVDs, and listen to im podcasts to help build di case.
Anoda wahala wey come out for di team be say all di accuse no be new mata. Di earliest one bin happun 27 years ago.
Dat one mean say no CCTV footage and no forensic evidence dey to work wit.
Det Supt Andy Furphy from Met Police tok say dem gatz find oda ways to build dia case.
One former friend of Brand appear for court to give evidence for di prosecution, while di jury also hear statement from di parents of one of di women.
Di entertainer former personal assistant, wey work closely wit Brand, tell di jury about im "insane sexual appetite."
Who be Russel Brand?
Russell Brand start im career for radio, first for XFM and later BBC 6 Music, while he dey also tour with im stand-up comedy shows.
One of him early controversies happen for 2001 wen MTV sack am after he show up for work wit clothes wey make am resemble Osama Bin Laden one day afta 9/11.
Brand blow for di mid-2000s wen he become host of Big Brother's Big Mouth, di companion show to di popular reality programme Big Brother.
Even afta some controversies with di BBC, Brand career continue to grow. He enta acting and feature for films like St Trinian's, Forgetting Sarah Marshall, Rock of Ages and Arthur.
For 2009, he meet pop star Katy Perry during filming of Get Him to the Greek. Di two later marry for India in 2010 but divorce two years later.
Brand also become known for him political views.
E show for programmes like Question Time and Newsnight, wia e criticise politicians and encourage people not to vote because of distrust for di political system. E sha bo gree run for political office himself.
Recently, especially since di Covid-19 pandemic, Brand start to dey do online content creation.
E build a large audience on YouTube, Instagram, TikTok and Rumble, wia e dey regularly discuss politics, current affairs, wellness topics and conspiracy theories.
Some of im content attract wahala, including one Covid-related video wey YouTube remove for breaking misinformation rules, wey make am start im own daily show, Stay Free with Russell Brand, on Rumble.




















