Magnitude 7.7 earthquake kpai at least 47 pipo for Indonesia

Wetin we call dis Video, Watch: Buildings partially collapse for Indonesia afta 7.7 earthquake
    • Author, Farida Susanty
    • Role, BBC Indonesia,
    • Author, Helen Sullivan
  • Published
  • Read am in 4 mins

At least 47 pipo don die afta one magnitude 7.7 earthquake strike Indonesia early Saturday morning, di nation disaster mitigation agency tok.

Di official death toll dey rise as search and rescue operation dey go on.

Di National Disaster Management Agency (BNPB) tok say plenty pipo get various degrees of injury.

Di earthquake destroy hundreds of buildings for di regions, plus dozens of aftershocks wey follow.

Di quake bin strike di island of Flores shortly bifor 05:00 local time on Saturday (22:00 GMT on Friday). E get depth of 15km, Indonesia meteorology and geophysics agency tok.

If di earthquake no deep, e go cause more serious damage for di earth surface.

Dem feel strong aftershocks for di same eastern area, wey include one wey get magnitude of 6.1.

Later on Saturday, dem feel magnitude 6.4 earthquake for North Sumatra, wey dey located for western Indonesia, at a depth of 163km.

Video wey dem record for Maumere port show as big-big pieces of concrete comot from di terminal building and fall on top passengers wey dey wait make dem board di inter-island ferry. Some pipo even fall enta sea wen di gangway wey connect di ship collapse.

Emanuel Melkiades Laka Lena, wey be govnor of East Nusa Tenggara Province, tell tori pipo for one news conference say di victims die as dem dey sleep, afta rubbles from buildings wey collapse fall on top dem.

One motorcyclist dey ride past one crack on di road afta di earthquake for East Nusa Tenggara Province, Indonesia.

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock

Arnold Welianto, wey dey live for Talibura, one village near di coastline for Sikka, East Nusa Tenggara, tok say na one "veri strong shaking" bin wake am up.

"I fear wake up and immediately I rush go my pikin room."

E tell BBC say many pipo don already run go di hills.

"Some oda residents dey stand along di roadside bicos di sea also don calm," e explain.

"Di water remain low for quite some time, so evribodi panic and run - I bin go around di community health centre, and di pipo for dia too don comot."

Authorities bin announce one tsunami warning but dem lift am around three hours afta di initial jolt, wen dem no detect any sign say di sea level go rise.

Afta authorities bin issue di tsunami warning, plenty pipo bin evaluate or relocate on dia own. BNPB say about 2,000 pipo move.

One house collapse and na only di roof dey visible.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, More dan 150 houses totally damage, plus some oda public facilities

Manggarai province dey among di most affected areas, di disaster agency add.

Dem say dem record 24 fatalities for dia, 17 for East Manggarai province, three for Sikka province, and at least one for each of di Ngada, Ende and West Manggarai provinces.

At least two odas dey seriously injured and 11 get minor injuries.

Welianto say many residents of Talibura bin choose to remain outside as di aftershocks mean say dem dey fear to go back dia house.

Yulian Juita Ekalia, one university lecturer from Ruteng, one city to di west of di epicentre, tok say she bin drag her stove outside and dey cook for dia for fear of further tremors.

"I no eva experience earthquake wey big like dis bifor," she tell news agency AFP. "E be like say we dey on trampoline - e dey really scary."

One map show di location of di Indonesian earthquake
Wetin we call dis foto, Di earthquake strike around 600 miles (1,000km) away from Bali

E go take time to assess di full extent of di destruction for di region, wey dey remote and get plenty mountain.

Preliminary reports show say more dan 150 houses dey severely damaged, as well as dozens of educational institutions, plus some healthcare facilities, places of worship, offices, and several oda public facilities.

BNPB say govment dey send support to di affected areas.

Dem also advise pipo to remain calm, and to stay away from coastal areas and structures wey show signs of damage.

Indonesia dey prone to earthquakes and volcanic activity, e lie along di meeting point of three major tectonic plates.

Get in touch

Have you been affected? If it is safe to do so share your experiences