South Africa scata Nigeria 2027 Fifa Women's World Cup hope, Ghana get chance

Michelle Alozie dey cry as Ghana and South Africa to join 8 other teams for intercontinental playoffs

Wia dis foto come from, Bradley Kanaris/Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Di Super Falcons of Nigeria don fail to qualify for di 2027 Women's World Cup for Brazil afta South Africa sama dem 2-1 for dia Inter-confederation playoff on Thursday.

Goals from veteran striker Thembi Kgatlana and captain Refiloe Jane secure di three points for di Banyana Banyana, despite late consolation penalty goal from Christy Ucheibe.

South Africa goalkeeper Kaylin Swart bin win di player of di match award afta she bin make plenty ogbonge saves for di second half to deny Nigeria any chance of comeback.

Dis result mean say Nigeria dey miss di World Cup for di first time, wey dem also fail to defend dia Wafcon title.

Super Falcon players dey emotional afta di game - Michelle Alozie na one of di players wey cry for di pitch, but dia captain Rasheedat Ajibade tok say teams for di continent don become beta na so dem gatz raise dia game also.

"Di lesson na for us na say everibody don tighten up now; we gatz sabi say we no be unbeatable, everibody dey beatable."

She add say "we gatz prepare beta, and demand more from ourserf both individually and collectively going forward."

Both Nigeria and South Africa bin comot di 2026 Wafcon for di quarterfinals, wey dem also fail to secure automatic qualification for di World Cup.

For di Banyana Banyana, di 2-1 playoff win na ogbonge step to try and qualify for di World Cup afta dia Wafcon disappointment.

South Africa don join di Black Queens of Ghana to qualify for di Inter-continental playoff; Ghana bin win dia playoff game 2-1 against Ivory Coast.

Ghana sama Ivory Coast 2-1 for di oda playoff

Ghana won their game despite a pay row with the country's sports ministry

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S TEAMS/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di Black Queens of Ghana stage second half comeback to win against Ivory Coast

Di black Queens of Ghana enta dat qualification game wit plenty controversy ova dia pay and bonuses afta dem comot for di Wafcon.

Dem bin dey demand dia bonuses and allowances from d kontris Sports Ministry; some of di bonuses na for dia qualification game against Egypt for 2025.

But di Black Queens put di kasala aside to play di game against di female elephants of Ivory Coast.

Ivory Coast bin get penalty for di first minute of di game afta Princess Marfo bin hack down Bernadette Kakounan inside di penalty box.

Star striker Ines Konan step up wia she score di penalty to give di female elephants early advantage.

But for di second half, Ghana bin turn di game around wit 59th minute header from Princess Marfo to equalise, bifor di Black Queens win dia own penalty also.

Defender Josephine Bonsu score from di spot for di 72nd minute to win di game for di Black Queens and qualify dem for di Intercontinental playoff tournament.

Afta dia win, dem now go focus for dia bonuses and allowances wia di Sports Ministry suppose give dem.

Inside one statement bifor di game, di Queens tok say di Ghana govment bin dey owe dem outstanding Egypt 2025 bonus, Wafcon qualification bonus, Group stage bonus, outstanding per diem among odas.

But di sports ministry respond wey dem tok say dem no dey owe di team outstanding per diem.

Di ministry confam say wetin dem dey process now be di winning bonus for dia win against Cape Verde for di Wafcon.

According to Fifa, two kontris each from Africa, Concacaf and South America togeda wit one rep each from Oceania and Europe go jam for dis intercontinental playoffs.

So far seven kontris don qualify for dis intercontinental playoffs - Ghana, South Africa, Uzbekistan and Chines Taipei.

Di oda kontris na Ecuador, Venezuela and Papau Mew Guinea.

Three more kontris dey expected to qualify to join dis seven for di playoffs wia suppose happun for two phases.

Di first phase go happun for November and December 2026 wey di final phase dey set for February 2027.

Teams from di same confederation no go dey di same pathway for di Intercontinental playoffs.