Burkina Faso issue arrest warrant for oppositions, journalists and activists wey dey exile - report

Wia dis foto come from, Getty Images
Human Rights Watch (HRW) don accuse Burkina Faso military govment of pursuing journalists, activists and political opponents wey don run comot from di kontri.
Di rights group say di authorities don issue international arrest warrants and don request for di extradition of dozens of pipo wey dey live abroad.
Burkina Faso Prosecutor General, Désiré Sawadogo, announce on 13 November say one special court wey dey handle terrorism cases don open six cases against at least 45 pipo and organisations.
Who dey targeted?
According to di Human Rights Watch, pipo wey dem target include journalists - Ahmed Newton Barry, Issaka Lingani, Inoussa Ouédraogo, Adama Ouedraogo and Abdoulaye Barry.
Social media activist Naïm Touré and former foreign affairs minister Alpha Barry. International journalist Wassim Nasr, also dey among di pipo dem name.
Di junta govment accuse dem of different offences wey include, connection wit armed group wey dey fight violently and "financing terrorism".
Sawadogo say Burkina Faso don send international arrest warrants and extradition requests go Ivory Coast, France and United States.
E also say govment don ask US make dem work wit Meta to identify and prosecute pipo wey dey manage Facebook pages wey dem accuse of promoting terrorism.
Human Rights Watch say dis move na part of wider crackdown against pipo wey dey criticise military govment or report abuses wey govment forces dey commit.
"Authorities dey use counterterrorism laws target pipo wey dey criticise dem and restrict independent reporting about military abuses," di organisation talk.
E say di extradition requests fit put pipo wey run comot from di kontri at risk of arrest and possible maltreatment if dem return dem.
"Di extradition requests extend political repression beyond Burkina Faso borders, dey put critics wey seek protection abroad at risk of arrest, forced return and further abuse."
Concern about Burkina Faso death penalty

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Di group express concern too about Burkina Faso recent decision to bring back death penalty for offences wey include terrorism, treason and espionage.
Since military govment seize power for September 2022, dem don accuse am of restricting media, suspending trade unions and civil society groups, and dissolving political parties.
Reports also dey about forced disappearance of pipo and forced recruitment of government critics into armed forces.
Burkina Faso dey fight Islamist armed groups since 2017. Di conflict also involve abuses by govment forces and militias wey dey work wit dem.
HRW say all sides don commit serious violations, including possible war crimes and crimes against humanity, but accountability dey very low.
Di organisation don also raise concern about di country special terrorism court, because of long periods wey pipo dey detention witout trial and failure to guarantee fair hearing.
E dey urge foreign govment dem to carefully examine any extradition request wey Burkina Faso make, and make dem no return anybody wey fit face torture, arbitrary detention, unfair trial or execution.





















