Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Western ambassadors turn dia back waka comot from Russian foreign minister

    Western ambassadors turn dia back waka comot

    Russia foreign minister, Sergei Lavrov, receive diplomatic boycott for di United Nations for Geneva.

    Lavrov, wey bin dey address both di UN human rights council and di UN conference on disarmament, receive walkout as greeting by Western ambassadors just as im begin to speak.

    Im bin dey look forward to striding di diplomatic stage again for Geneva - Europe closed airspace put full stop to dat.

    Instead, wen im speech through video link begin to play, Western ambassadors waka comot - Oga Lavrov spoke to dia backs as dem dey waka comot.

    Russia foreign minister den go, virtually, to di UN human rights council. Dia too di chamber dey empty.

    Di irony: much of Lavrov speech na actually about security – or Russia idea of am.

    E allege say Ukraine fit try to acquire nuclear weapons but no give evidence, come add say time for US missiles for Europe to go home don reach.

  2. How di sanctions dey affect Russians

  3. Pipo for Ukraine don exchange dia pen and keyboard for guns

    Many civilians for Ukraine don exchange di pen and keyboards for guns as dem ready to fight to death to protect dia kontri.

    Ukraine goment give thousands of weapons to civilians for di kontri capital Kyiv.

    Wetin we call dis Video, Exchange pen and keyboards for guns
  4. Five pipo dey reported dead for attack on Kyiv TV tower

    Five pipo dey reported dead for attack on Kyiv TV tower

    Ukraine authorities don reveal say five pipo die for one Russian attack ofr di main television tower for di capital, Kyiv.

    Di blast bin take some broadcast off air and also affect one memorial for victims of Nazi Holocaust wey bin dey nearby.

    BBC Monitoring understand say five more pipo dey injured for di missile strike.

    But di 380-metre (1,250ft) TV tower still dey standing.

  5. Nigeria Lawmakers vote against special seat for women for National Assembly

    Nigeria first lady Aisha Buhari

    Nigeria lawmakers don vote against one bill wey want special seats for women for National and State Houses of Assembly on Tuesday.

    Di bill face defeat for Senate wit 58 votes out of 91.

    For House of Representatives na 208 out of 290 lawmakers vote against am.

    Wife of Vice President, Dolapo Osinbajo bin dey present on di floor wen House of Representatives members vote.

    For interview afta di vote, Madam Osinbajo say di defeat of dis bill no go be end of women struggle for inclusion for Nigerian politics.

    Minister of Women Affairs, Pauline Tallen, say di vote na show of shame.

    Dolapo Osinbajo wife of Vice President Yemi Osinbajo
  6. Ukraine conflict: Disney, Warner, Sony don pause release of films for Russia

    Pixar new animated film Turning Red
    Wetin we call dis foto, Pixar new animated film Turning Red

    Warner Bros, Disney and Sony don pause di release of films for Russian cinemas afta di invasion of Ukraine.

    Di announcement mean say di release of major movies like di - The Batman, Turning Red and Morbius no dey go ahead as scheduled for di kontri.

    Dis dey come as goments around di world dey dish out sanctions against Moscow.

    In recent days, global corporations wey include car makers and energy giants don cut business ties wit Russia.

    Warner Bros blockbuster, Di Batman supposed dey released on Russia on Friday.

    One tok-tok pesin say "In light of di humanitarian crisis for Ukraine, Warner Media dey pause di release of dia feature film 'The Batman' for Russia,"

    Meanwhile, Disney don delay di Russian release of di Pixar animated film, Turning Red.

    Di entertainment giant add say dem go wor with non-governmental organisations to provide "urgent aid and oda humanitarian assistance to refugees".

  7. Nigerian lawmakers don okay autonomy for local goments

    NASS

    Di National Assembly don givefinancial and administrative autonomy(Independence) to all dilocal goments for dikontri.

    Di Lawmakers wey start to vote todayMarch 1, 2022 for joint session to amend 68 Constitution Amendment bills, vote electronically.

    Di House of Representatives and Senate vote in favour of di Local goment as di arm of government, dem also guarantee diademocratic existence and tenure.

    258 members vote for di House of Representatives vote 'YES' while 15 vote "NO"

    Senate vote 92 "YES and 2"NO"

    For di House of Representatives, dibill to create special accounts from wia dem go dey get moneyfor local governments directly and pay dem directlyfrom diFederation Account get 257 ‘YES’ votes and 9 ‘NO.’ votes.

    Local goment administrative autonomy get 88"YES" and 4 "No"

  8. Prince Charles condemn 'brutal aggression' against Ukraine

    Prince Charles
    Wetin we call dis foto, Prince Charles

    For di strongest comments so far from di Royal Family about Russia invasion, Prince Charles don sama warning as assault on democratic values.

    For one ceremony to mark Southend becoming a city, Prince Charles link di killing of MP Sir David Amess wit attacks on Ukraine.

    "Wetin we see for di terrible tragedy for Southend na attack on democracy, on open society, on freedom itself. We dey see dis same same values under attack today for Ukraine for di most unconscionable way," Prince Charles tok.

    "We dey in solidarity wit all those wey dey resist brutal aggression."

    Di Duke and Duchess of Cambridge bin previously tweet say dem "stand wit di president and pipo of Ukraine as dem bravely fight for dat future".

  9. Moredan 660,000 pipo don run comot Ukraine - UN

    Pipo wey dey run comot Ukraine

    We don get updated figure on di number of pipo wey don japa from fled Ukraine since Russia's invasion six days ago.

    Di UN refugee agency say more dan 660,000 people - mostly women and children – don japa so far.

    Shabia Mantoo, toktok pesin of di UN's refugee agency during one briefing for Switzerland tok say reports of pipo waiting for up to 60 hours to enter Poland dey, while queues for di Romanian border dey up to 20km (12 miles) long.

    Dis train station for di Polish border city of Przemyśl don become safe haven for thousands of people fleeing Ukraine thousands of pipo wey dey run comot Ukraine

  10. 'Dem treat us like animals', Ukraine border officials no allow Africans cross di border to safety.

    Wetin we call dis Video, 'Dem treat us like animals'

    Some African and Asians conplain say Ukraine border officials no allow dem cross di borders to safety.

    Dey complain say dem dey treat dem like animals. Some of di officials even turn dem to cleaners as dia ticket to cross border.

    According to international law, everybody get di right to cross international border during conflict.

    Dis one make wetin di Ukraine border officials dey do dey against di law.

  11. Russia warn say e go hit targets for Kyiv

    Di Russian defence ministry don issue warning to pipo wey dey stay for Kyiv say e dey prepare to hit targets for di Ukrainian capital.

    For inside statement wey dem issue on Tuesdy afternoon, Russian officials tok say dia forces dey prepare to launch ''high-precision' strikes'' against ''technological centres of di Ukrainian Security Service and di 72nd main PsyOps centre fo Kyiv''.

    ''We dey urge Ukrainian pipo who di nationalits dey use to carry out provocations against Russia, as well as Kyiv residents wey dey live near relay stations to leave dia home,'', di statement add join.

    Officials claim say dem dey carry out di strikes to ''prevent informate attacks against Russia''.

  12. Women wit disabilities join NLC and oda women groups to chook mouth for Constitution review mata

    Women wit disabilities join NLC and oda women groups to chook mouth for Constitution review mata

    Thousands of Nigerian workers and women groups gada for inside National Assembly to chook mouth for di 1999 Constitution Review.

    Di Nigeria Labour Congress dey ask for Local goment, Legislative and Judicial autonomy, while di women groups dey ask for Equality for politics and society.

    Women wit disabilities follow join di waka as wife of Nigeria Vice President say she dey proud of di women. Mrs Yemi Osinbajo assure di women say di Lawmakers go heat dia voice.

    Meanwhile President of di Nigeria Labour Congress say fuel price no go increase. "

    "Dem import bad fuel and dey fake fuel scarcity becos dem wan force use to accept increase in fuel price, but we go kontinu to resist increase of fuel price"

    Di Lawmakers go start to vote today to amend di Constitution.

    Women wit disabilities join NLC and oda women groups to chook mouth for Constitution review mata
    Women wit disabilities join NLC and oda women groups to chook mouth for Constitution review mata
    Women wit disabilities join NLC and oda women groups to chook mouth for Constitution review mata
    Women wit disabilities join NLC and oda women groups to chook mouth for Constitution review mata
  13. AU condemn reports of racism for Ukraine border

    Thousands of Africans dey for di Ukraine borders to run comot di conflict
    Wetin we call dis foto, Thousands of Africans dey for di Ukraine borders to run comot di conflict

    Di African Union say e dey disturbed by reports say Africans for Ukraine dey refused di right to cross di border to safety.

    Di body advice all kontris to respect international law and offer assistance to everyone wey dey run comot from di war irrespective of their race.

    "Reports say Africans dey singled out for unacceptable dissimilar treatment go be shockingly racist and go dey against international law," AU tok for inside statement e issue late Monday.

    Di union hail member countries and dia embassies for kontris wey be neigbhour wit Ukraine wey dey support those wey run from di war.

    Africans wey dey live for Ukraine don complain of racism for di Ukraine-Poland border.

  14. Buhari ask Senate to amend di new Electoral Act 2022 wey im just sign

    President Buyhari

    President Muhammadu Buhari don ask Senate to amend di new Electoral Act 2022 wey im just sign.

    For letter wey e address to di Senate President Ahmed Lawan for plenary, e ask dem to consider to delete completely Section 84 (12).

    Di section tok say make political appointees resign before party primaries.

    President Buhari say e go disenfrancise political appointees.

  15. If you just dey join us now

    Ukraine-Russia war LIVE updates: Latest on Ukraine-Russia provocations

    Good morning. na another bloody night e be as Russia continues im full-on assault on Ukraine.

    Dis na wetin you need sabi to bring you up to speed:

    • At least 70 soldiers die for one Russian artillery strike, Ukrainian officials confam am. Emergency workers dey check through rubble dey try to find survivors
    • Di regional centre of Kherson don dey surrounded by Russian troops, according to reports, wit soldiers and military equipment reportedly "on all sides"
    • Di Russian army steadily dey continue im advance on Kyiv, wit satellite images dey show an armoured convoy wey dey about 40 miles (65km) long
    • Dozens of civilians die earlier on Monday for Russian missile strikes on Ukraine second-largest city, Kharkiv
    • Ukraine goment say plans deyo sell war bonds to pay for im armed forces

    40 mile-long Russian convoy dey head to Kyiv New satellite pictures released by one American technology firm show say one long Russian military convoy dey head towards di Ukrainian capital, Kyiv.

    E now stretch for more than sixty kilometres, according to di American technology.

    Di company, Maxar Technologies, say di convoy include armoured vehicles, tanks and artillery.

    E fit be like less than thirty kilometres from di centre of Kyiv.

    British intelligence has announced that the convoy has made little progress in the past twenty four hours because of logistical issues.

    Ukraine-Russia war LIVE updates: Latest on Ukraine-Russia provocations
  16. Senator wey Zamfara govnor appoint as deputy don resign

    Muhammad Nasiha

    Di senator wey dey represent Zamfara Central Senatorial District, Muhammad Nasiha sdon resign.

    Dis dey happun becos Govnor of Zamfara State Bello Matawalle appoint am to be im deputy.

    Nasiha dey replace Mahadi Ali wey House of Assembly pursue comot last week.

    Senate President Ahmed Lawan naim read di resignation letter for plenary today wey announce to di lawmaker say e don resign.

  17. Ukraine say Russian troops strike southern city of Kherson

    Ukraine-Russia war LIVE updates: Latest on Ukraine-Russia provocations
    Wetin we call dis foto, Members of one Ukrainian civil defence unit on Kyiv northern front

    Ukraine officials say Russian troops don begin launch strike on Kherson.

    Kherson na one city wey dey for di south of di Eastern European kontri.

    BBC reporter wey dey on ground say dem hear powerful explosions near di Kherson airport dis morning.

    Earlier missile don hit di centre of Ukraine second-biggest city Kharkiv.

    Ukraine president don describe di bombardment of Kharkiv, wey don kill dozens of civilians, as a war crime.

    Nine pipo, including three children, na im dem kill on Monday afta suspected Russian cluster bombs bin target residential buildings inside Ukraine second city.

    Inside comments wey e make before di latest strike in central Kharkiv, Volodymyr Zelensky say dem get eyewitness accounts of civilians being deliberately targeted.

    "Russian forces brutally fire on Kharkiv from jet artillery."

    Di International Criminal Court's chief prosecutor, Karim Khan, don opened one investigation into Russia's invasion.

    Khan say he believe say e get "reasonable basis" to believe war crimes or crimes against humanity don dey committed in Ukraine.

  18. Missile hit centre of Ukraine second-biggest city Kharkiv

    Ukraine-Russia war LIVE updates: Latest on Ukraine-Russia provocations

    Missile don hit di centre of Ukraine second-biggest city Kharkiv.

    Ukraine president don describe di bombardment of Kharkiv, wey don kill dozens of civilians, as a war crime.

    Nine pipo, including three children, na im dem kill on Monday afta suspected Russian cluster bombs bin target residential buildings inside Ukraine second city.

    Inside comments wey e make before di latest strike in central Kharkiv, Volodymyr Zelensky say dem get eyewitness accounts of civilians being deliberately targeted.

    "Russian forces brutally fire on Kharkiv from jet artillery."

    Zelensky tok during a late night address to the Ukrainian people.

    "Dis na clearly a war crime. Peaceful city. Peaceful residential areas. No military facilities. Dozens of eyewitness records prove say dis no be a single false volley.

    "But di deliberate destruction of pipo. Di Russians bin know wia dem bin dey shooting."

    Di International Criminal Court's chief prosecutor, Karim Khan, don open one investigation into Russia's invasion.

    Khan say he believe say e get "reasonable basis" to believe war crimes or crimes against humanity don dey committed in Ukraine.

  19. Buhari dey go London for medical check-up, Some Nigeria tori...

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    President Muhammadu Buhari

    President Muhammadu Buhari dey go London for medical check up.

    Di 79 year old Nigerian leader medical examination go last for a maximum of two weeks, according to di president office.

    Buhari media assistant, Femi Adesina say di president go depart Abuja Tuesday, 1st March.

    Im go first travel to Kenya to participate for di Commemoration of di 50th Anniversary of di United Nations Environmental Programme.

    UNEP@50 dey happun between 3rd - 4th March, 2022.

    Pipo wey dey follow di president travel include ministers, security advisers plus some oda goment ogas.

    Dis no be di first time wey im dey travel for medical checkup for di UK.

    Di exact sickness or health challenge wey di Katsina born former army general dey always travel to UK to treat, no dey known publicly.

    Both di goment of Nigeria, di president office and Buhari family keep di mata private.