Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
See Fotos as Ghanaian students arrive from Ukraine
Wia dis foto come from, bbc
Di first batch of Ghanaian students wey govment evacuate from di war in Ukraine don land Accra.
Ghana goment dey evacuate dia citizen wey dey stranded for di east European kontri following di Russian invasion.
Na 17 students out of 400 students wey don comot Ukraine en route border kontris arrive for Kotoka international airport on Tuesday morning.
See fotos as Ghana student arrive motherland.
'75% of Russia forces don dey inside Ukraine'
Russia don move from having 40% of im forces inside Ukraine
to around 75%, one military academic tok am.
Dr Jack Watling na research fellow for land warfare and
military sciences for di Royal United Services Institute.
Im tell di BBC Radio 4 Today programme say one large body of
Russian troops dey advance south from Belarus and don start to dey set conditions
to be able to conduct assault into Kyiv.
Wen dem ask am about di suggestion say Russia don use grad
missiles on residential areas for Kharkiv, im describe dis weapons as multiple
launch rocket systems wey fire large numbers of unguided missiles into one
area.
E tok say evidence no dey say some of dis fit don contain cluster
munitions.
"Na di fact say dem dey unguided and you dey put huge
amounts of high explosive into densely populated civilian area," im tok.
Di Ukrainian army no longer dey function for military
formations, but now dem dey defend positions and e dey become more and more
part of di territorial defence and di volunteer force wey e dey follow operate,
im tok.
Russia-Ukraine war - Ghanaian students dey arrive today
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, African students wey dey try to leave Ukraine to get to safety, say dem don face difficulties and discrimination for di borders.
Di first
batch of 24 students dey expected to land for Ghana today at 7:30 am GMT.
Over 400
students don comot Ukraine en route to Poland, Hungary, Romania, Slovakia, and
Czech.
We bin
reports say dem suppose land on Monday, but e no happun.
Dem dey
expected to land di Kotoka international airport for Acrra.
Minister of Foreign Affairs, Shirley Ayorkor Botchway say Ghana don already
request di five European kontris wey dey share border wit Ukraine to help
facilitate di easy passage of Ghanaian nationals.
Una good morning
We begin today
live coverage of all di news wey dey haapun around di world.
Ukraine-Russia war 2022 see further explosions inside Kyiv and oda cities.
Troops provocations dey happun as invasion enta day six on Tuesday 1 March.
Daniel
Semeniworima and Olaronke Alo go start today live coverage wit you.
You go read tori from our reporters dem from
across Nigeria and West Africa plus BBC all ova di world.
Nigeria begin evacuate citizens from Ukraine back to di kontri
Time don reach make we close gate
Dis na all wey we get for una for BBC Live Page today Monday, 28 February, 2022.
Abeg Scroll down to see all di beta informate we bring come una domot today.
We go return 7a.m onTuesday wit more tori on Russia and Ukraine war and oda informate around di world.
Na Jelilat Olawale, Faith Oshoko, Kareemot Salami and Annette Arotiba bring una all di tori.
Good night.
Fifa and Uefa suspend Russia plus oda tins wey happun for day five of Ukraine-Russia invasion
FG go begin Evacuation of Nigerians from Ukraine on Wednesday
Wia dis foto come from, NASS
Di Nigeria House of
Representatives say dem go give Nigeria Foreign Ministry all di support e need
to evacuate Nigerians back from Ukraine on Wednesday.
Di Speaker of di
House, Rep. Femi Gbajabiamila, give di assurance as e meet wit di Nigerian
Foreign minister, Geoffery Oyeama to yarn on di plight of of Nigerian wey dey
in dey in di middle of di Russian/Ukraine gbas-gbos.
Oga Gbajabiamila say di
evacuation suppose start dis Monday but dem gatz shift am to Wednesday to allow
di ministry, the House and di Nigerian foreign missions for
Ukraine, Poland and Russia to complete di formalities to move Nigerians
to safe borders wit neighbouring kontris.
Gbajabiamila, draw ear give
di minister say di way di kontri di respond to emergency no quick at all.
E explain give say e dey good
for di kontri to get response mechanism like earoplanes and oda equipment dem
including funds and dat di legislature go do legislation to include dis kain
emergencies in di future.
Nigeria foreign minister fo
im response say Nigeria get about 5,600 Nigerian students for Ukraine and dat
di delay to evacuate dem no becos di goment no ready and dat up to 80 percent
to 90 percent of kontris no believe say Russia go strike.
E explain further say im bin
dey in touch wit di ambassador and dem re assure am say notin go happun as need
no dey for evacuation plus di Ukranian goment no want most of di students to
leave since e go affect dem to go back.
E say dem don put
everitin togeda and from dia dem go put dem inside bus and
transport dem to di various airport to di kontri.
E say dem go use
Poland, Romania, Slovakia, Hungary and even Russia as exit point dem go
use to evacuate Nigerians.
"Wia we dey
now na to find out di exact number of Nigerians and agree on di
location wey we go use to evacuate dem” Onyeama explain.
Nigerian students protest sake of unending Varsity strike
Wia dis foto come from, Getty Images
Afta two weeks wey di Academic Staf Union of Universities go on anoda one month strike, Nigerian students under di National Association of Nigerian students stage protest.
Di students cari placards wit different different write-ups to show dia grievances.
From Unity Fountain Abuja dem waka go National Assembly, den back to di Ministry of Education wia dem call for di removal of Minister of Education Adamu Adamu.
President of di National Association of Nigerian Students Sunday Asefon, for di National Assembly gate tok say" I give di Senate President and Speaker of di Senate four days to settle di mata between ASUU and Federal goment, if not we go comeback hia and wen we come back, we no go go back again until una open our schools" e tok.
For di Ministry of Education, Mr Sunday Asefon and di protesting students begin chant" Adamu Adamu must go".
For one small meeting wey di Minister hold wit di NANS Executive tori be say di Minister waka comot from di meeting afta di Union President ask am say " you no dey bothered as we dey on strike"
ASUU and goment don tay for dis strike mata we don pass one decade.
Di statement wey dem post on Monday say, "we dey alive say our brothers dey alive and well".
Di sailors "bin rebuke di attack of Russian invaders twice" but bin no fit to continue to protect di island, according to di statement.
Di navy tok say afta Russia armed forces bin destroy infrastructure, dem bin no fit reach di sailors as connection with di island bin dey completely cut off.
On Friday, Ukraine bin dey plan to honour di 13 soldiers dem say die as dem dey defend di Islands from Russia.
More than 250 Nigerians don comot Ukraine - Goment
Wia dis foto come from, AFP
Nigerian Embassy don receive 130 Nigerians to Bucharest, Romania, 74 Nigerians for Budapest, Hungary and 52 Nigerians for Warsaw Poland for dia work to comot Ngerians from Ukraine.
Dis na according to di Federal Ministry of Foreign Affairs.
For statement wey dem bin release, Nigeria tok say dem dey expect 200 more citizens for di city of Budapest today, and dem dey also process 23 pipo enta Poland.
Di statement say dem still dey finalise plans to carry all dis Nigerians enta back di kontri.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Russia-Ukraine de-escalation toks don end
Russian and Ukrainian representatives don conclude toks wey dem hold for
Belarus wey dey aimed at bringing peace even as conflict still dey go on.
Both sides go return to dia capital cities for consultation ahead of a
second round of toks wey fit take place in di days, di Reuters news agency
cites Belarus' Belta news for di informate.
Expectations for a peaceful resolution no too dey high before Monday
meeting.
Ukraine say dem want ceasefire and Russian withdrawal, while di Kremlin say
dem no go announce diaposition.
Russia negotiators bin tok of striking one deal wey go dey in di
interests of both sides.
Black and Indian students allege discrimination as dem run from Ukraine
UN dey hold very important meeting ontop Russia-Ukraine mata
Wia dis foto come from, UN Photo/Leo Felipa
Wetin we call dis foto, UN president beg nations to give peace a chance
President of di UN General Assembly
Abdulla Shahid don ask all kontris to demonstrate moral courage and give peace
a chance as dem gada for di United Nations
General Assembly 11th emergency special session to discuss di Russia
– Ukraine crisis.
Di presido remind di special session say all
di 193 kontris for di world get say for di General Assembly unlike di Security Council
wey get five permanent, veto-wielding members and 10 non-permanent members wey
hold two-year terms.
E also remind di 193 members of di UN
say for 1946 di League of Nations bin scata because of dia failure to provide mechanism
for di enforcement of international collective security.
Shahid na di first speaker for dis ogbonge meeting, e say di UN dey
founded to take effective collective measures to prevent and remove threats to
peace.
Di secretary general, Anthony Guterres plus more than
100 members of di UN go follow chook mouth for di mata over di next few days.
Diplomats dey expect a
vote on a draft resolution – wey still dey on negotiation as at Wednesday.
Di UN Security Council call
for dis session afta dem no gree dem act wen Russia ban one US draft resolution
on Friday, wey kick against Russia invasion on Ukraine and demand di immediate
withdrawal of all of dia sojas from di kontri.
Di draft GA resolution dey
expected to pass because no nation get veto for dis chamber, but e no dey legally
binding like security council resolutions.
‘For night eh, na just bomb, bomb, na wetin we dey hear’
Wetin we call dis Video, ‘For night eh, na just bomb, bomb, na wetin we dey hear’
Dr Gladys
Ibrahim, tok to BBC Pidgin from train station for Kyiv Ukraine wia she, her
husband, young daughter and oda Nigerians bin dey try catch train to run comot
Ukraine afta Russia invade di kontri.
Di doctor
wey come from Rivers state and bin don dey live for di kontri for years bin
tink say dem go fit stay and bin don even call pipo to come take shelter and
dey distribute free food to Nigerians before di conflict begin serious.
DI UNHCR say
di number of pipo wey dey run comot Ukraine now don reach 368,000.
See vex sake of how dem treat Nigerians for Poland border
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Pipo dey try leave Ukraine sake of di conflict
As thousands
dey japa from crisis, Nigeria goment don condemn reports say im citizens, and pipo
from oda African countries, dey prevented to leave war-torn Ukraine.
We don hear from
Isaac, one Nigerian man wey dey live for Ukraine who bin dey try to enter
Poland. say border staff bin tell am say dem no dey " attend to
Africans".
Reports also
dey say Ukrainian security officials dey try stop Africans from how dem go catch
bus and train wey dey go to di border.
On Sunday
Nigeria Foreign Minister Geofrey Onyeama bin say e don tok wit im Ukrainian
counterpart Dmytro Kuleba and e don get assurance say im don give Ukrainian
border guards order to allow all foreigners wey dey leave Ukraine to pass
without restrictions.
Lassa Fever kill 59 pipo for di first six weeks of 2022 for Nigeria
Wia dis foto come from, SANJAY KANOJIA
Wetin we call dis foto, Rats na di major cause of Lassa Fever for Africa
Fifty nine pipo don die for Nigeria for di first six weeks of 2022 sake of Lassa fever , according to di kontri centre for disease control, NCDC.
Di agency tok say di dead pipo bin comot from di 358 pipo wey catch di viral haemorrhagic fever for dis period.
Fifa dey hold advanced toks over di full suspension of Russia until further notice, according to BBC Sport editor
Dan Roan.
Di global football governing body dey understood to be working closely wit im European
counterpart Uefa and announcement dey expected later today.
E go mean say Russia no go fit play for di women's
Euro 2022 in England for di summer and Poland
go get bye for di World Cup qualifier play-off next month - match wey Poland's FA don tok say dem go boycott.
Iceland don also tok say e go refuse to play against Russia in June, and di International
Olympic Committee don recommend dat athletes from Russia and Belarus be
banned from competitions.
Russia celebrate 30 years of diplomatic relations wit South Africa
Wia dis foto come from, MFA Russia/Twitter
Wetin we call dis foto, Russia-South Africa 30 Years of Diplomatic Relations
Russia
don highlight dia "strong bonds" wit South Africa, as di two nations
mark 30 years since di establishment of diplomatic ties.
Di Soviet Union wey dey defunct
now bin play central role to support South Africa governing African National
Congress (ANC), during dia long fight against di legalised system of racism for
di kontri.
For inside tweet, Russia foreign
ministry say: "Our interaction dey notable by di strong bonds of
friendship & cooperation wey dey established during di struggle against
apartheid, wey continue to develop today."
Russia
no make any reference to South Africa foreign affairs ministry wey issue one statement
last week as dem call on Russian troops to immediately withdraw from Ukraine.
South Africa na di only
African state wey be part of Brics – one group of emerging economies wey also
includes Brazil, Russia, India and China.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Wetin be di latest for Russia-Ukraine crisis?
If you just dey join us, or u dey try catch up on events,
here be di latest developments for di fifth day of di Russian invasion of
Ukraine:
Tok tok don begin for Belarus between negotiators for Kyiv
and Moscow but expectations no dey high
EU defence ministers dey set to meet for discussions on top
di gbege
Ukraine President Zelensky don call for Russian troops to
put down dia weapons and for immediate EU membership
Pipo dey hear blasts for Kyiv and Kharkiv dis morning, as
one residential building for di northern city of Chernihiv dey hit by missile
Russia double dia interest rate to 20% as dia currency drop
and expert dey warn of possible run on banks
Russia central bank don more dan double dia key interest
rate to 20% from 9.5%
Despite di financial hit di Kremlin say Russia go "ride
out" economic punishment
If you want more detail, you fit read how Ukraine remain on
alert and di latest here.