Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
RT television wey Russia dey support criticise UK for broadcast ban
Wia dis foto come from, Getty Images
Russian goment supported television channel RT don criticise
British goment afta e disappear from all platforms for UK sake of EU sanctions.
Although UK no follow for EU, di bloc target satellite
companies for Luxembourg and France wey dey provide di RT feed give Sky,
Freesat and Freeview.
RT deputy editor-in-chief, Anna Belkina tell tori pipo
Reuters say “e don tey wey” di Russian
channel "stop to expect any legitimacy or reason for Britain attempts to
restrict media freedoms".
She add say: "Now e be like say e don forget Brexit and
e dey try to force influence over di rest of Europe too."
Hungary fit host peace tok, Prime Minister Orban tell BBC
Wia dis foto come from, Tim Mansel
Wetin we call dis foto, Viktor Orban visit one refugee centre for di Hungary-Ukrainian border eariler
Hungarian Prime Minister Viktor Orban tok again say im kontri dey willing to host peace tok between Russia and Ukraine.
For wetin e follow BBC tok for di Hungary-Ukraine border, Orban say di responsibility to end di war lie, above all, on di Russia side.
For di past,Orban don enjoy close relation wit President Putin, wit 11 meetings for di past 12 years, di most recent be one month ago for Moscow.
At di same time, im goment bin don get by force relations wit Ukraine, sake of one language law wey di government say dey discriminate against di large Hungarian minority for Ukraine.
Dis morning, as e visit one refugee reception centre for Beregsurany for di Hungary-Ukranian border, I ask am wetin be im message to President Zelenszky of Ukraine and President Putin of Russia.
"I no any message to anybody. I get message only to those refugees wey dey here," Orban bin reply.
"Hungary be good friend of Ukraine and Ukrainian pipo, if dem need any help here, dem fit can count on us. I no think say di leaders need any message and advice from my side. Dey be big guys and dey sabi pass me for wetin dem suppose do. Wetin di Hungarian wish be, no be advice, no be message. Just wish from my heart. Peace, please, peace."
Di Hungarian goment don offer Budapest as venue for future peace tok between Russia and Ukraine, as one alternative to one kind low-level tok wey don already happun for Belarus capital, Minsk.
"Di war can fit dey stopped only by negotiation, and peace tok and one ceasefire," Orban tok.
Batch of stranded Nigerians for Ukraine don begin board plane from Poland
Wia dis foto come from, Raphael Oni
Di first batch of stranded Nigerians from Poland don begin enta plane Air Peace Air bus A230 for Warsaw Chopin Airport as dem prepare to take off to Nigeria
Di chartered flight wey fit cari close to 180 pipo leave Nigeria around 2 am on Wednesday and land Poland for 9: am local time.
Dia evacuation dey happun hours afta Nigerian presido, Muhammadu Buhari
approve $8.5 million for di immediate evacuation of at least 5,000 Nigerians from Ukraine.
Zubairu Dada, minister of state for foreign affairs,say dem don contract Air Peace and Max Air airlines to provide three aircraft to facilitate di evacuation of Nigerians.
But Air Peaceoga, Allen Onyema say dem suffer small delay to go evacuate Nigerians sake of delay for proper documentation and flight clearance.
Wia dis foto come from, Raphael Oni
Another night for underground as Kyiv dey bombarded
Wia dis foto come from, Getty Images
Kyiv residents of all age, adults and children again go underground last night as di capital city continue to be target.
Some, as e dey for picture here, bin go down to di metro stations wey bin dey used as bomb shelters. As many as 15,000 pipo dey shelter for di stations, di city mayor don estimate.
Some bin manage to sleep while odas try to dey entertain young children.
Witnesses bin hear four major explosions overnight and capture am on video, although e no dey clear wetin di targets be or if casualties dey.
BBC correspondents don tok say di blasts fit dey heard from two storeys underground for dia bunker.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, Getty Images
Ukraine Russia War - See who dey support Moscow vs who support Kiev
First seven days of Russia war on Ukraine - Summary
Russian Foreign Minister say 'Third World War fit be nuclear'
How African kontris vote on UN resolution against Ukraine invasion
17 African kontris abstain from di vote at di UN General Assembly to condemn Russian invasion of Ukraine.
UN General Assembly vote in favour of one resolution wey condemn Russia invasion and ask make Russia immediately pull all dia forces comot from Ukraine.
Five kontries vote against condemning Russia invasion for di emergency.
UN General Assembly for New York.
Di UNHCR dey beg for nearly $2bn (£1.5bn) for relief operation as refugees hit one million.
Zelensky: Another virus don attack us
And dis na
more from Ukrainian President Zelensky latest video update.
Im refer
directly to Vladimir Putin, tell di Russian president to: "Go home. To
your home."
Im say Putin
should defend di Russian-speaking pipo - not around di whole world - "but
in your home".
"E get
quite a few of dem there too. About 150 million."
Dis appears
to be one reference to Moscow claim say dia action na in defence of
Russian-speaking pipo for parts of Ukraine.
Zelensky
also liken Russia invasion to one virus, say e don be two years since Ukraine
record im first Covid case: "E don reach one week now wey another virus
attack."
Get ready to pay for di wrong una do, Zelensky tell Russians
Wia dis foto come from, Getty Images
And another
line from di Ukrainian president:
Afta days of shelling for Ukraine cities,
Zelensky vow say dem go rebuild di kontri and im say Russia go learn about "reparations".
"Even
if you destroy all our Ukrainian cathedrals and churches, you no go destroy our
faith, our sincere belief in Ukraine and God, belief in pipo," im tok.
"We go
rebuild every single house, every single street, every single city."
"And we
dey tell Russia - learn di words 'reparations' and 'contributions'. You go pay
back fully to us for wetin you don do against our state, against our every
single Ukrainian."
Who dey Putin inner circle wey dey help am run di war?
Breaking, Russian Foreign Minister say 'Third World War fit be nuclear'
Wia dis foto come from, Getty Images
Russian Foreign Minister Sergei Lavrov dey give news conference in Moscow.
Lavrov say US President Joe Biden don tok say di only alternative to sanctions go be a third world war.
And e go on to say a third world war could only be "nuclear war".
Di Foreign Minister say e dey only inside di heads of Western politicians - and e no dey inside di heads of the Russian people.
"If real war is waged against us then those wey make such plans gatz think about and [and] in my opinion such plans dey being made," e tok.
We go bring una more updates from Lavrov's conference soon.
Lavrov compare US to Hitler for 'dominating Europe'
He repeat di Russian claim say Ukrainian goment be a neo-Nazi goment.
And e say gangs loot towns and cities, including for Mariupol.
BBC never see evidence to support dis claims dem.
Lavrov also tok say Ukrainians dey "now try to use civilians as human shields".
He again and again refer to Hollywood and say make pipo no "just look at dis Hollywood movie" wey di Western media "wia ultimate evil boku" dey make.
Di Russian foreign minister also say Nato dey try to bolster di West security at di cost of Russia.
He dey compare di US to Napoleon and Hitler, saying "back in di days, Napoleon and Hitler bin get a goal to dominate and control Europe - now Americans dey do so".
Ukraine-Russia war - Timeline of five major invasions around di world
Air Peace don deploy aircraft to evacuate stranded Nigerians for Ukraine
Air Peace confam
dem don deploy dia aircraft to evacuate Nigerians wey dey stranded for Europe
as a result of di invasion of Ukraine by Russia.
Dis na di
first batch of Nigerians dem go evacuate since di war start eight days ago.
Di aircraft
depart Nigeria at 2:20am today, Thursday, March 3, 2022, for Warsaw, Poland.
Ukraine-Russia War - Wetin be di nuclear risks?
Breaking, Russia and Belarus don dey banned from 2022 Paralympics
Di International Paralympic Committee [IPC] say dem no go allow athletes from Russia
and Belarus for di 2022 Winter Paralympics for Beijing.
Pipo bin criticise di
International Paralympics Committee after dem first allow di athletes to compete as neutrals.
One statement on Thursday tok
say diem no fit defend di “situation for di athlete villages”
IPC president Andrew Parsons
say di athletes wey dey affected na victims of dia govment actions.
Di Winter Paralympics go
begin on Saturday, and di opening ceremony go take place on Friday.
"We be very firm
believers say sport and politics no suppose mix," Parsons tok.
"However, di war don
come to dis Games and behind di scenes many govment dey get influence ontop our
cherished event.
"E dey important to ensure safety and security of athlete, and di situation in di athlete
villages dey escalate and e dey untenable.”
Russia suppose get 71
competitors and Belarus suppose get 12 – plus guides for di two kontris for di
competition for Beijing.
Parsons tok say "overwhelming number of members" don tok to di IPC and say dem no go
compete in di game if dem allow Russia and Belarus compete.
Im tok say dia decision to
stop di athletes go “preserve di integrity” of di games and di safety of all
participants.
Wetin be di latest for Ukraine?
If you just dey joining us, dis na update of wetin
we sabi on day eight of Russia invasion of Ukraine:
For Kyiv, witnesses don capture four
major explosions in di past few hours on video, but e no dey clear wetin be di targets
and if casualties dey
•BBC correspondents say dem fit hear di
blasts from two storeys underground for dia bunker
One US defence official say one massive
convoy of Russian military vehicles close to Kyiv don "hook" sake of fuel
and food shortages
Russian forces don seize control of di
key southern port city of Kherson, according to local officials. Dis na di first
major Ukrainian city wey dem go take since di invasion start
Dem don also bombard di kontri second
largest city, Kharkhiv wit shells.
For di southern port city of Mariupol, fear
be say hundreds of pipo don die afta hours of sustained shelling, di city
deputy mayor says. Ukraine military claim di city remain in Ukrainian hand
Ukrainian President Volodymyr Zelensky
release one late-night video, dey praise di courage of citizens wey dey defend dia
kontri
More than one million pipo don run from Ukraine
since di start of di invasion, di UN tok, and di number dey rise rapidly
The International Criminal Court for The
Hague don launch one investigation into possible war crimes for Ukraine
For di first time, Russia admit say dem
dey take heavy military casualties during im attack on Ukraine, wit 498 troops
killed and 1,597 injure
Catch up on di latest
Day
eight of di Russian invasion begin for Ukrainian capital Kyiv.
Dis na wetin you suppose sabi:
Dem don hear massive
explosions for Kyiv in di past hour, as video posted on social media show one
enormous fireball light up di night sky.
Di International Criminal
Court for The Hague don open one investigation into alleged war crimes by
Russia
Di United Nations say di
number of refugees wey dey run comot Ukraine don reach one million.
Ukraine President
Zelensky release one video, dey call on citizens to do everything dem fit do to
resist di Russian occupation.
US officials say one
40-mile (60km) Russian armoured convoy idon somehow "stuck" on im way
to Kyiv.
Witnesses say Russia
artillery bombardments don increase in di past 24 hours and fierce fighting still
dey go on.
Russian troops don
surround di strategic port cities of Mariupol and Kherson.
Kherson mayor say Russian
troops don enter di city, but say for now e go remain under di Ukrainian flag.
For di northern city of
Chernihiv, Ukrainian officials say two cruise missiles don hit one hospital.
For Kharkiv, Ukraine's
second largest city, Russian shell continue to fall, report say e don kill and
wunjure dozens of citizens.
Good morning!
Welcome to
our daily live coverage of news from around di world.
Join Daniel Semeniworima,
Olaronke Alo dis Thursday morning for timely update of Ukraine-Russian war LIVE as e dey
hot.
BBC reporters from Nigeria, West Africa and across di world go bring una up -to-date wit wetin dey happun around you.
Good night!
Dis na wia we go end today BBC Pidgin Live Page.
To catch up wit all di tori wey you fit don miss today, make you scroll down di page.
We go return on Thursday 7am wit all di latest tori on Russia-Ukraine war as e dey happun plus oda ogbonge tori around di world..
Na Jelilat Olawale, Faith Oshoko, Kareemot Salami, Onyinye Chime and Annette Arotiba bring una all di tori.