Trump don threaten to bomb Oman if dem 'come dey disturb am' ova Iran issue

Close up foto of President Donald Trump as e dey tok for outside wit im hand for up. E wear "make America great again" cap

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Donald Trump don arrive for di Joint Base Andrews for Maryland on Sunday.
    • Author, Olivia Ireland
  • Published
  • Read am in 5 mins

President Donald Trump don threaten say e go bomb Oman - US ally - if dem "come dey disturb" im administration tok wit Iran, as Fox News report.

One reporter for di network tok say di US president tok dis wit bad words during one phone call for Monday, wia e also tok say di US get direct backchannel wit di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC).

The IRGC - na major military, economy and political force for Iran - dem later deny say dem dey follow US tok. But Iranian officials on Monday tok say dem dey close to finalising di deal wit Oman on how dem fit ship through di Strait of Hormuz.

Meanwhile, di 60-day Memorandum of Understanding (MoU) go end for Monday. Di memo na signed commitment from both US and Iran to continue to dey tok until dem reach di final agreement.

Oman wey dey claim say dem dey neutral for dis conflict, don suffer some attacks from Iran since di gbege start. However, dem dey try negotiate wit Iran to reopen di strait.

Since di US and Israel don attack Iran for February, Tehran don block di important waterway - wey about one-fifth of di world oil and liquefied natural gas dey pass. To reopen am don become major key point for discussion.

Washington don make dia own efforts to secure di reopening. Fox reporter Trey Yingst quote Trump say: "If Oman dey distract us, we go bomb di shit out of dem."

One IRGC tok-tok pesin deny Trump claim, say US dey involved in backchannel negotiation wit IRGC - wey be major military, political, and economic force for Iran.

One tok-tok pesin tell semi-official Iranian news agency Tasnim News: "No discussion dey take place between IRGC officials and di Americans, and dis lie by Trump na just fantasis caused by di delusions and nightmares e don suffer becos of di defeat and desperation of di war."

ALT TEXT: Di map show wia Strait of Hormuz dey for Gulf of Oman, one key route for global oil transport. Di strait dey between Iran and di peninsula of di United Arab Emirates and Oman. Di map also show kontris for di wider Middle East region like Saudi Arabia, Iraq, Jordan and Israel.

Trump make di threat to Oman afta Iran tok on Monday say di two sides don reach agreement for ships to fit travel through di strait.

Foreign ministry tok-tok pesin Esmaeil Baghaei tell tori pipo for Tehran say "we don reach understanding about di map of di transit route."

Inside di statement, Baghaei tok say both sides go finalise di details bifor dem go release joint statement. Oman don describe dis discussions as positive.

Earlier dis month, Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi tok say full reopening go depend on edn Iran receive compensation from di US, as violations of di MoU.

Reuters - tok say one Iranian official - don report say Tehran dey seek fees of between 5% and 7% of di price of cargoes from vessels wey dey pass through am.

Wetin we call dis Video, 'Justified' or 'no business being dia'? Tennessee munitions town wey dey loyal to Trump but dem dey divided on Iran

As Trump tok wen e dey phone wit Fox, e tok say im get direct backchannel wit di IRGC, but im no dey rush to end di war.

"Dem be good poker players, but dem dey die," Trump tok. "I no get any time schedule. I no dey rush."

Di president tok say di upcoming November midterm elections for US "no get anything to do wit wetin im dey think." E also argue say di US no get issue wit di weapons wey don dey finish since di war start, e argue say "wetin we don use na peanuts."

Di exact money wey dem use for ammunition and di remaining stockpill still no dey public. But data wey dem publicly comply for Washington DC-based Center for Strategic and International Studies (CSIS) show say di stockpiles don dey finish, and for di short-term, e go hard for dem to replace am.

Retired Marine Corps colonel and senior adviser for CSIS tell BBC say e dey usually take "one to five years" to make one missile.

"And nothing wey you fit do to speed di process."

Di MoU wey dem sign on18 June, na to bring both sides on permanent ceasefire but di temporary peace fall apart as both sides dey throw strike at each oda not long afta.

On 8 July, Trump declare say di ceasefire don "ova".

As di ceasefire don dey near make e expire on Monday, Trump still post for im Truth Social network say: "Di number one goal be say, and e go always be, dat Iran no fit get nuclear weapon, in any way, shape, or form."