You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Prince Harry and Meghan dey move back to UK six years afta dem comot
Di Duke and Duchess of Sussex dey plan to move back to UK, BBC understand.
Daily Telegraph and di Sun bin first report am say Prince Harry and Meghan dey plan to relocate from US later dis month to one private, non-royal residence outside of London.
Dem don enrol di couple children, Prince Archie, seven, and Princess Lilibet, five, for one British school wey dem go start for September.
Dem inform King Charles about di move on Sunday, 17 August. No current plans dey for ground for either Prince Harry or Meghan to resume dia roles as working Royals.
Di Sussexes and dia children bin visit King Charles for Highgrove for July dis year, but according to report dem no discuss anytin about relocation.
BBC understand say di King no dey aware of di move until last weekend but e welcome di opportunity to see more of di Sussex family for private and personal capacity.
However, no expected changes go dey to di official status of Prince Harry and Meghan, dem go remain as private individuals.
Dem also don inform Prince William and Princess Catherine of dia plans.
Di couple move from California dey come afta dem comot UK and royal duties for early 2020.
Family relations no too smooth since den. July visit to di King and Queen Camilla na key development for dia relationship.
Di Palace bin describe di meeting for di King private home for Gloucestershire as "private family occasion".
Na di first time di King go see im grandchildren in pesin in more dan four years.
Prince Harry and Meghan neva come UK togeda since 2022, wen dem attend di funeral of Queen Elizabeth II.
Security for di couple for long be point of tension, wen di Duke of Sussex bin visit for July, dem reject im request for police protection.
Last year, Prince Harry bin lose one legal challenge on top di levels of security im and im family bin dey entitled to wen dem dey for UK.
Di Duke bin go court to overturn one decision wey bin downgrade im security afta e stop to dey work as royal and move go US wit di Duchess.
Prince Harry bin tok bifor say worries about safety na im stop am from coming to di UK and to bring im wife and children.